One thing you must know when taking a decision to invest in Bitcoin .It's highly speculative investment. That's why it's more advice able to invest the amount you are comfortable losing.as Bitcoin price go up and down this season by hundred of dollars.
When I first see the topic I been dey think say na buying strategy the op wan talk about buy to my greatest surprise na place to take buy the coin na the op com dey go talk about, op the thread for dey more interesting if to say you also add strategy to use to buy, as e be say no be every newbie naim sabi how to buy Bitcoin with strategy. Mostly na lump sum dem dey conversant with and this strategy no dey recommended for newbie as e fit go trigger emotional decision when the price don dey waka anyhow.
Op abeg take this correction, e no get anything like money wey person dey comfortable to loose, e no dey anywhere most especially when it come investment mata, I dey see plenty people for this forum sef wey dey make this same mistake. By right if you don do betta study about Bitcoin, you go know the possible merits wey dey for inside and by the time you fall in love with am you no go even mind to keep 70% of your total investment for inside, that is if you be long term holder. Even if na 10,000 wey you put as your investment, if the money loss for your investment way you do, e nor go pain you?(e go affect every body) because that money reach to take sub for one month. And beside that by the time you don dey dey very aggressive with you accumulation even if na DCA you dey do, small small drop of water turns to a mighty ocean, one day the money go Big reach millions sef.