Overtime i see that whenever there is a dip in the price of bitcoin, other altcoins tends to follow suit by also dropping in their prices and whenever there is an increase in the price of bitcoin, other coin as well increase in their value. Does it mean that other altcoins cannot be dependent on their own?
Bitcoin na their master, why many peoples dey Invest into those altcoins na because dem believe the altcoins go fit blow like Bitcoin or atleast increase small as BTC been do so when Bitcoin wey be the oga come dey correct, others go begin fear and dem go dey take profits from the altcoins so dey no go lose and that one also dey contributions to why altcoins dey fall.
Also you need know say BTC pairs get most volume for the market as most altcoins are been traded against Bitcoin so as Bitcoin dey fall for price other altcoins go dey fall as well and this na why dem say make we no dey invest for altcoins with the mindset say we went diversify as e no go work because all the crypto makes dey go same direction majoring of the time. Bitcoin controls the market, the faith of the entire market is on Bitcoin so when Bitcoin dey do well every other coins go do well and the case na the same when Bitcoin no dey do well.
Most altcoins na just copy of each other so dem no fit do well on their own, dey depend on the success of Bitcoin and the original project to survive. For your list so, BNB, SOL, ADA all dey do the same thing wey be smart contract parole and people just dey Invest inside them because dem expect dem to get the same success wey their oga ETH dun get so when BTC correct and e affect ETH, other smart contract go take a hit too and you fit talk the same thing about other altcoins like of Dogecoin market gets affect other memecoin also gets affected. Some altcoins though dey go the opposite when market dey crash but dem no plenty.