You can use Mexc Exchange successfully to trade on their sports market without needing to pass their KYC, and you can also make some withdrawals without needing to pass KYC, but you need to pass KYC before you can visit or even make use of those features.
So I assume you've had an account with them for a very long time, but because you have not passed their KYC up to level 3 or tier 3, as they call it, that's why you have not noticed they have or NGN is allowed to be traded on in their.
I have Mexc account too and I can trade (sport trade) in the app although my account has not been verify yet but if I understand the Op post correctly and the subsequent comments, the concern is not just about trading NGN but it's about we can swap our coins to fiat effortlessly. I think na wetin Op dey refer to be that from the example of exchanges wey he mentioned, e dey clear. For Mexc, I no dey even see P2P option for the app but I no know whether na because my account never dey verify.
Hey there I just noticed that Bybit p2p is working and their verification is very swift without hassle. Kyc details needed is just bvn and is simple as ABC, you can check it out again kucoin also allows p2p trade as well with little or no stress just few people already listed some places you can trade p2p is just best for you to choose which is better than the other.
I dey consider Bybit as option but I no go recommend am give anybody based on the review I have seen from different people on social media. Many people dey complain say their accounts have been put on suspension after trading on Bybit exchange and people are now suspecting that dem get government spy for that exchange wey dey report people's account for trading crypto and their respective banks dey place embergo on the account. Our people say experience is the best way to verify information but I no wan experience that kind thing abeg. E better to avoid am before person go fall victim. Kucoin still remain the major exchange for now.
The good thing here be say e good as the governments dey target this centralized exchanges to not allow Naira trading because e go encourage entrepreneur in the country and Blockchain developers to work on having a standard decentralized Naira trading platform for the country. Without the attacks we no go get way forward for decentralized P2P for the country. Sha their biggest challenge go be how to prevent scamming on the exchange because that one na one thing wey we know say our yahoo boys go wan use shine.
We still have a long way to go on this issue. Some devilish individuals go definitely make use of the opportunity to scam people. Since OKX announced removing NGN from their platform, the amount of local vendors advert I dey see on my status don increase. I no get any prove but I dey sure say some na pure scammers.
Again, plenty challenges go dey with this local Marchant option. Some people dey live in a very remote area and e go take them some hour journey to locate one Marchant physically because they're not rampant yet. Trading through online with total strangers no dey safe at all for this our country. Secondly, even if we say na physical transaction we go dey do with this local Marchant, government no fit come after them to arrest them? Dem fit disguise go meet them like say na transaction dem come for and arrest them. Na small thing for this country. Finally, I no know how we achieve unification of exchange rate among the Marchants. Honestly, government dey push us to the wall but I know, they won't win this battle for sure.