Pages:
Author

Topic: Bitcoins for naija need prayer support (Read 182 times)

hero member
Activity: 896
Merit: 645
June 20, 2023, 05:46:20 PM
#21
We too like prayer. Everything nai be fasting and prayer?
As in eh! As I see d thread title cef, I just weak.
Evn God cef go wonda why e giv us brain cef 2 use think becus, we no dey use am. If matta com out, d not tin 2 solvin it na 2 pray mak God com put bodi. Human being no jst wnt stress at all.

Omo, we need understand say no b so o. God no go do en own con stil come do watin we, we suppose nd ft do 4 ourselves.
D gud tin b say, bitcoin dey decentralized nd a relentless public na em dey keep d system active. Mak we no giv up nd keep pushing 4 d system 2 persist nd wen d time dey right, we go dey okay.

Mak we commot God inside dis crypto matta abeg!
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
June 20, 2023, 02:17:31 PM
#20
As new government enter now, we pray make bad belle people no give am wrong advice on bitcoins ooo, if not we go hit another rock for Bitcoin matter for naija. People wey no like bitcoins make them no rish the position of special advicer to the president. Make we just get ready and full of prayer oooo.
Nawaoo. Na so di matter don reach. I believe sae bitcoin matter for dis government go make sense well well. Yes  prayer will also follow but let im put someone that is technologically incline so dat things go dey work well at that side too. If im put someone that knows all this new technology, cryptocurrency and other digital marketing stuff then things go go well be dat.
But as e bi like this bitcoin e don come and im no dey go back again. So di wey we dey use now sef I even like am because I sure sae Nigeria go use bitcoin pay for something. Ordinary cashless policy was a thug of way.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
June 20, 2023, 04:51:46 AM
#19
OP, this is technology and it has to do with, awareness, acceptance and  adoption. It is not about going spiritual everytime but of knowledge and Understanding. If these people are properly educated and knowledgeable enough about bitcoin, they would not be commiting some blunders they do. Come to talk of it, most of them are old school not near anything modern innovation and technology as this was the case of the previous government and it affected the Crypto market industry in Nigeria but however, we believe this incumbent government has much bigger and better plans for Crypto/Blockchain in Nigeria and we hope that the president gets a good adviser with more exposure and broad knowledge and Understanding of the tech world so as to educate Mr President good ideas and advise to work with in respect to Crypto.
full member
Activity: 1176
Merit: 165
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
June 19, 2023, 05:17:54 PM
#18
As new government enter now, we pray make bad belle people no give am wrong advice on bitcoins ooo, if not we go hit another rock for Bitcoin matter for naija. People wey no like bitcoins make them no rish the position of special advicer to the president. Make we just get ready and full of prayer oooo.

Even if person way no like Bitcoin enter seat of space of personal adviser, I no see anything way them go wan do Bitcoin way go affect us pass watin dem don do before, now all of us don wise and we wan do they fine way for our self to even avoid anything way government wan do to stop us to no use the currency.

Watin me I believe say this our countri people they after nah money, them go only go after crypto when dem know say them no go make any single thing from am, if not as them don learn and wan try to they tax crypto exchange them, now hope go they.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
June 11, 2023, 12:43:31 AM
#17
As new government enter now, we pray make bad belle people no give am wrong advice on bitcoins ooo, if not we go hit another rock for Bitcoin matter for naija. People wey no like bitcoins make them no rish the position of special advicer to the president. Make we just get ready and full of prayer oooo.

No be the government wey dey against Bitcoin na CBN governor. That man na very bad man, him just dey introduced rubbish ideas but everything go work in our favor sha because I dey hear say Tinubu go find way make him commot am and another governor enter that seat wey no go dey anti Bitcoin by God grace. Tinubu like blockchain from wetin I dun see so some of the laws fit favor us small. During the election, the current CBN governor no been dey side Tinubu so make we dey wait see how things go be. Nobi everything be prayer, we need a working system. If na some countries now, we for just sign impeachment petition, him supposed step down ASAP..
Last last we presido Tinubu don sack the CBN governor G. Emiefuele comot for sit. Actually Emiefuele no try at all as a CBN government all him economic policies were just unproductive and rather mething suffering unto the citizens. Na him still give the former administration of buhari the E-naira idea way make them ban and restrict banks from making any transactions with anything crypto, for him mind mAh the E-naira go replace digital asset like bitcoin. The man been just the introduce and implement policies without any plans and contingency plan ahead to work with just in case things wan go south.

But anyhow shaa, as new government don com sit down and unseat the Emiefuele we believe say some those economic restrictions and ban on Crypto them go lift am and from wetin I dey feel, it's like this current administration under balablu fit favour crypto most particularly bitcoin for we country.
full member
Activity: 434
Merit: 152
June 09, 2023, 06:11:33 PM
#16
As for me I no dey show say federal government get any issue with crypto, is focused na to thief money and run, but this new president I see he will be better then the other one I prayer he should just help us approve Bitcoin in Nija  dey no get time for all this crypto stuffs even bad belle people go say bad things about Bitcoin if he wants to take any actions he most go through it first and see the benefits will earn, but why some of our leaders don't like Bitcoin we just need to be praying dey should not say anything about it
hero member
Activity: 812
Merit: 725
June 09, 2023, 05:33:04 PM
#15
But now sha everything dey tinubu hand, everybody wey dey ASO rock go be him loyalist so make we see how him go play the politics take commot that rubbish man wey dat the CBN governor seat. Make him too carry him eNaira and new naira noted dem commot for seat make better person wey get better future visions for the country enta take over. This CBN governor really kill us and sent us years back because Buhari no been get problem with Bitcoin or blockchain. I just dey imagine if everything been dey as e dey before the rubbish laws. We for dun go far for this blockchain things for the country.
I just they see one news say President Tinibu don already suspend Emefele for him office due some financial investigation.
Me I know say that man too get shit for him nyash because I no fully trust am, and him go get hand for all this dollar to naira price variations and as him no come like Bitcoin and blockchain mean say him know say him go cast if them trace all wetting him they do for there.

The way this Tinibu administration is going, there is a high hope say Bitcoin go soon they legal for Nija just that them go put task for us.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
June 09, 2023, 04:37:07 PM
#14
As new government enter now, we pray make bad belle people no give am wrong advice on bitcoins ooo, if not we go hit another rock for Bitcoin matter for naija. People wey no like bitcoins make them no rish the position of special advicer to the president. Make we just get ready and full of prayer oooo.

No be the government wey dey against Bitcoin na CBN governor. That man na very bad man, him just dey introduced rubbish ideas but everything go work in our favor sha because I dey hear say Tinubu go find way make him commot am and another governor enter that seat wey no go dey anti Bitcoin by God grace. Tinubu like blockchain from wetin I dun see so some of the laws fit favor us small. During the election, the current CBN governor no been dey side Tinubu so make we dey wait see how things go be. Nobi everything be prayer, we need a working system. If na some countries now, we for just sign impeachment petition, him supposed step down ASAP..

But now sha everything dey tinubu hand, everybody wey dey ASO rock go be him loyalist so make we see how him go play the politics take commot that rubbish man wey dat the CBN governor seat. Make him too carry him eNaira and new naira noted dem commot for seat make better person wey get better future visions for the country enta take over. This CBN governor really kill us and sent us years back because Buhari no been get problem with Bitcoin or blockchain. I just dey imagine if everything been dey as e dey before the rubbish laws. We for dun go far for this blockchain things for the country.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
June 09, 2023, 11:04:00 AM
#13
Snipped

Somethings need no prayer at all, do we actually needs prayer for the government to adopt bitcoin as a legal tender, we the leadership realized that what the people want is financial freedom but they don't want to allow it, aren't we the problems to the current status of what we are facing today, this may not apllies to Nigeria alone but every part of the world is concerned, it's all about our individual selfish ambitions and interests which requires no prayer because we know ourselves and those involved.
hero member
Activity: 644
Merit: 544
June 06, 2023, 01:19:50 PM
#12
As new government enter now, we pray make bad belle people no give am wrong advice on bitcoins ooo, if not we go hit another rock for Bitcoin matter for naija. People wey no like bitcoins make them no rish the position of special advicer to the president. Make we just get ready and full of prayer oooo.

As new government never talk anything against Bitcoin or plan to take any decision against it doing it campaign.I don't think it may have anything against am very soon,Even if bad belle people try talk against am  or advise new government make e no support Bitcoin in our country and I believe with government that have good intentions for better naija it will surely look into the matter seriously before it taking any decision against it, so our prayers should be may Almighty guide and direct our leaders to the right path for the better Nigeria.
hero member
Activity: 896
Merit: 653
June 06, 2023, 02:34:38 AM
#11
As new government enter now, we pray make bad belle people no give am wrong advice on bitcoins ooo, if not we go hit another rock for Bitcoin matter for naija. People wey no like bitcoins make them no rish the position of special advicer to the president. Make we just get ready and full of prayer oooo.
A decision taken about Bitcoin will review how much this new administration care about the youths of this nation and how enlighten they are about the current global trends, because if they will not officially allow banks to execute Bitcoin transactions & tax it, they should better just leave it the way it is now today, because one beautiful thing I love about Bitcoin is that whether this new government place either partial or permanent ban on it,  people will always find a way into buying and selling it through the help of p2p market.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
June 05, 2023, 06:34:12 PM
#10
As new government enter now, we pray make bad belle people no give am wrong advice on bitcoins ooo, if not we go hit another rock for Bitcoin matter for naija. People wey no like bitcoins make them no rish the position of special advicer to the president. Make we just get ready and full of prayer oooo.
If na about bitcoin, things suppose better small for this new administration, but I no pray make we get like this current CBN governor again, that man spoil things for us, things wey youth go dey see do dey make small small money, the man block almost everything, make we just dey hope make we get better CBN governor and make we get better people wey go dey give our president better advice. Na dis bitcoin most youths dey do now wey dem dey see food chop, make dey just free us make we dey rugged our thing dey go.

We too like prayer. Everything nai be fasting and prayer?
D one wey dey pain me pass be say na we like prayer pass and na we no dey follow Wetin God want, na oyinbo people wey no too sabi God self na dem they do things in d right way. If to say we dey really do things wey God want d way we dey religious’s in this country, then we for no dey condition wey we dey now.

The only thing wey I know be say no matter how government take strict with bitcoin reach, we go still dey rugged our thing and nothing go happen, but make we dey hope say better things go happen for dis administration.
full member
Activity: 364
Merit: 220
Eloncoin.org - Mars, here we come!
June 05, 2023, 05:53:18 PM
#9
Prayer de important for anything wey we de do for dis life, but sometimes after di prayer, tins go still de go wrong. So wetin I believe be say God, don give us wisdom, so e depend on everybodi to use im oun knowledge for good or bad. So whether naija government go unban bitcoin go depend on whether dem think say e go favor dem government and pocket or not.

But my observation so far  for dis discussion be say members no send if the government ban or unban bitcoin, because he no affect dem trading and profits. Also because of tax matter.
hero member
Activity: 812
Merit: 675
June 05, 2023, 01:46:15 PM
#8
As new government enter now, we pray make bad belle people no give am wrong advice on bitcoins ooo, if not we go hit another rock for Bitcoin matter for naija. People wey no like bitcoins make them no rish the position of special advicer to the president. Make we just get ready and full of prayer oooo.

I don’t really know but in as much as the government has not accepted the use of bitcoin and we still get to use it on a daily basis and most of us are earning a living from it makes me feel comfortable with it like that. I don’t know if there are other benefits that comes with it if government decides to accept its use in the nation. What I fear most after its acceptance is the regularisation which will follow up with tasks. Nigerians sometimes are not too friendly with collecting task. Especially now that it’s about bitcoin which they know the huge benefits on it, they can just put overzealous price in them and we don’t have choice than to pay.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
June 05, 2023, 08:45:42 AM
#7
If regulation comes, taxing will follow. But the CBN said they kicked out bitcoin and other cryptocurrencies. No regulation no tax, but Nigerians are really making P2P crypto transactions daily. I can see how the governments of one of the most populous countries are very wise. Or should we say no regulation brings freedom to Nigerians.
Yessoo me I dey use that option of p2p very well. Sometimes I dey sell give people I know and also buy from them as well. Prayer to crypto? Op you make me laf oo. Though nothing is impossible. But as it is the government e no get interest on crypto matters. There are some prayers you render that God will not answer too.
No be the new government go bring out the crypto related matter dem. Na the Minister of Technology. Dat is why make God put someone who knows Cryptocurrencies. So dat the implementation of cryptocurrency in di kwantri go dey faster than before. If the minister is good then everything go dey stew and marama
sr. member
Activity: 350
Merit: 255
June 05, 2023, 08:16:26 AM
#6
Nigeria government no even send crypto or put am for their agenda because them no see am as bad thing. Na only if one man dey for position wey he see say him fit use him power do something for e selfish reason na him e go take advantage. Remember say na CBN Governor na e use him power put ban for crypto no be federal government,na e make the crypto matter no serious for Naija. Any new president wey enter seat na how to first open office wet he go dey use thief money for himself na him e dey target. So how he won use crypto thief money. For me,I no think say Naija government get any issue with using crypto because so many boys wet dey street dey into crypto. Prayer na everything but we too need to help ourselves before the prayer go work. Imagine arm robber wet dey go rob and he kills in the process of robbing,when he won go rob,he come dey pray for successful robbery. The robber dey play,just dey play
hero member
Activity: 574
Merit: 627
June 04, 2023, 07:00:50 PM
#5
No be every something pray, any small tin pray, nah everything prayer dy solve? D way me self dy see things 4 diz we countri eh no really bad say diz government go get any interest via say dem wan do anything to Bitcoin or any crypto. Watin dem wan do way bad pass the one way dem been don already do, way dem just make things easy for us to they buga. Me self I no even they part of the people way dy say make diz government legalize Bitcoin make we use am for payment too, the way crypto stuff they 4 the countri dy me okay, make dem just allow us do our things nothing more, b4 dem go say make we begin dy pay task for something way dem no they contribute 4 d growth or how we they carry get am.

Anything way make government choke eye 4 crypto again, way dem way say we dy free to use am freely. The upper year budget onah go see something like "1 billion to be gotten from Bitcoin and other digital assets" the tax seizure and collection go way us, if eh no affect people like me and u, eh go affect firms way dy operate 4 d countri.
hero member
Activity: 532
Merit: 508
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
June 04, 2023, 06:02:14 PM
#4
I might be absolutely wrong, but I have tried to study the past government of Nigeria and how they have reacted to cryptocurrency, and I see that it's not really the first thing they looked at when a new president enters the presidential seat, so not in a rush, they will not even react to Bitcoin at the moment, and by the way, if someone gives bad advice to the president towards cryptocurrency, what do you think it will be? Despite whatever the regulation is, bitcoiners are still going to be doing their P2P.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
June 04, 2023, 03:46:55 AM
#3
If regulation comes, taxing will follow. But the CBN said they kicked out bitcoin and other cryptocurrencies. No regulation no tax, but Nigerians are really making P2P crypto transactions daily. I can see how the governments of one of the most populous countries are very wise. Or should we say no regulation brings freedom to Nigerians.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
June 03, 2023, 06:51:03 PM
#2
We too like prayer. Everything nai be fasting and prayer? The previous government been no dey bitcoin friendly but still that one no stop us from doing our thing if this government won still misbehave e no go still fit stop us Nigerians go always find a way. Tinubu been don talk during him campaign rally say e get plan for the youth and bitcoin and blockchain na one of the projects way he go look into. Him boy sanwo-olu dey show positive signs say this people don realize say them no go fit separate bitcoin from the people.
Pages:
Jump to: