Pages:
Author

Topic: Bye Bye to Wuruwuru Loan Apps - page 2. (Read 362 times)

hero member
Activity: 826
Merit: 552
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
April 05, 2023, 05:07:18 PM
#8
The way most of those loan apps operated was really out of control, based on what I have heard so far about them. A friend told me he got a call from one of their agents and was threatened with being arrested if he failed to repay his loan that day. But whats always the agreement between these loan apps and the borrower before they offer them the loan? They don't even request collateral before giving out loans, and when the borrower defaults on repayment, they begin to issue threats. LoL is funny, though.
hero member
Activity: 1260
Merit: 765
Top Crypto Casino
April 05, 2023, 03:47:50 PM
#7
I dey sure say this one go be better news for people wey dey take loan from apps and no wan pay, most especially people wey don take a current loan and yet their loan apps no con dey among the approved registered ones, as they go cease that as an opportunity not to pay anymore.
But if I may ask, where "Palmcredit, Fairmoney, Ease cash, 9Credit, Nairaloan and Easybuy" dem all day? Because if there is any loan app which I expected to see among the top 5 na "PalmCredit and Fairmoney" wey no dey free person rest with their many display ads on YouTube played whenever watching an online content.
My brother those loan apps where their names do not appear on the list fit still dey operate their business underground oh and this na why most time some of these laws or restrictions do dey work for 9ja, the problem na with governments agency because there is no proper monitoring or follow up on those policy implementations and this has given illegal business operator free hands to treat Nigerians the way there like.

*I have an encounter with those loan sharks sometime ago when one guy called me that my friend who I have not known his location nor seen him for up to 15 years is owing them, and from the way, the guy sounded on the phone I suspect the loan officer to be suspect yahoo boy because of the way he spoke over the phone.

*This made me to conclude that some of those funds that these loan apps are giving out as loans could be possible proceed of crime and as a matter of fact they're using Nigerians for money laundering and trying to mix the money within the system to avoid traces, the rise of tech and ITC have made development possible this also open the door for criminals to take advantage of thos great raising industry
hero member
Activity: 1190
Merit: 799
April 05, 2023, 01:49:45 PM
#6
I dey sure say this one go be better news for people wey dey take loan from apps and no wan pay, most especially people wey don take current loan and yet their loan apps no con dey among the approved registered ones, as they go cease that as an opportunity not to pay anymore.
But if I may ask, where "Palmcredit, Fairmoney, Ease cash, 9Credit, Nairaloan and Easybuy" dem all dey? Because if there is any loan app which I expected to see among the top 5 na "PalmCredit and Fairmoney" wey no dey free person rest with their many display ads on YouTube played whenever watching an online content.
sr. member
Activity: 392
Merit: 262
Lohamor Family
April 05, 2023, 12:21:14 PM
#5

My brother, the thing been don too much o, no be small
The matter still remains say, if you borrow money to use help your life, try dey pay back. At least, it helped at that time and the only way of reciprocating that love na to pay back. On top of that, try to dey avoid to borrow, to pay no sweet so, avoid to borrow.
Bro on point,some people just take am say na their right to borrow money but no be their right to pay back. As long as say you use the money run one or two matters,just get conscience pay back. Omo this loan people get their own dey their body,after them cast you finish wetin make them feel say people go come happy pay them back. Sometimes, no be the people fault, he fit be say the way things come run them,e come make am hard for them to pay back. Wetin tire me for this loan app people be say the money wey you collect,you never fit pay,them go still come dey add interest till 20000 go turn 40000. Only this interest fit discourage person to pay back.
full member
Activity: 798
Merit: 134
April 04, 2023, 03:43:04 PM
#4
This one na correct update be this o, I nor say e easy for those ones wey no fit meet up to register due to one thing or there other but this people wey register now don get licence to dey worry people in full time. Although them sabi worry people oo, na wetin make me no put interest where these app dem dey because dia interest dey read like water e no dey finish at all, na just once I even try that nonsense since from then I never near am again oo because e hard o.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
April 04, 2023, 03:12:13 PM
#3
I nor dey use all this loan app before their wahala nor be here….them ready to send your details give Aso Rock if you miss payment. But if you look the other side you go see say some of their customers nor dey try, them dey collect loan with the mind say them nor go pay back. I dey see memes wey dey trend about palmpay and defaulters. People get mind sha, you submit your documents give pepsin you won still run am street.
legendary
Activity: 1666
Merit: 1158
April 04, 2023, 01:28:34 PM
#2

My brother, the thing been don too much o, no be small harassment way these loan apps dey give person and Nigerians kwa no been get joy. Them go just borrow as them like with the intention say, them no go pay. Only wayin dey there mind be say, na contacts them go paste with calls, WhatsApp messages here and there then e don finish. Omo, the wahala no be small. Na so I dey see the full profile of one of my classmate all the way from when I dey secondary school.  E shock me no be small, person way I no been even remember en existence and in one move, I see all about  and what his been up to lately. E just dey bad but, na the only way them been get yo try recover there money be that.
Where the matter con cast be say, after you don cassette person like that, who go like pay the loan kwanu... you don cast the person packaging and that na something you no go fit undo.

The matter still remains say, if you borrow money to use help your life, try dey pay back. At least, it helped at that time and the only way of reciprocating that love na to pay back. On top of that, try to dey avoid to borrow, to pay no sweet so, avoid to borrow.
hero member
Activity: 1190
Merit: 901
Livecasino.io
April 04, 2023, 08:54:13 AM
#1
 If you borrow money or wan borrow money from loans apps rest assured say you go fit drink water drop cup and nobody to dey call your brother, uncle, aunty, friend or papa say you dey owe them. Why? The Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC) for we country don give d go ahead to 173 digital lending applications to take operate for we country, 119 of dem get full approval and 54 of them collect conditional approval. Na since last year wey the FCCPC  comot registration and d wey these loan app go operation because of how dem take dey harass Nigerians untop loan. We government make am compulsory say any loan company must register their business before dem operate. Na this March 27, 2023 wey just pass so na him be d deadline wey dem put for registration. As the deadline don pass now, the FCCPC come release the list of the apps wey dem approve. As e be now, dem go commot apps wey dem nor approve from Google play store. This one still follow wey make Google Play Store update their Developer Program Policy to talk say if you wan run loan business for Naija, you need to obey the regulatory rules for digital money lenders.
Still if you dey borrow make you use your head.

See some of the approved loan apps here:

  • SYCAMORE INTEGRATED SOLUTIONS LIMITED
  • TRADE DEPOT
  • TAJOW INVESTMENT
  • BLUE RIDGE MICROFINANCE BANK LIMITED
  • GROLATECH CREDIT LIMITED
  • BRANCH INTERNATIONAL FINANCIAL SERVICES LIMITED
  • P2VEST TECHNOLOGY LIMITED
  • CREDITWAVE FINANCE LIMITED
  • KEENEST TECH SERVICE LIMITED
  • FAIRMONEY MICRO FINANCE BANK
  • ALTRACRED FINANCE INVESTMENT LIMITED
  • CREVANCE CREDIT LIMITED
  • MENACRED COMPANY LIMITED
  • AFROWIDE DEVELOPMENT LTD
  • RED PLANET NIGERIA LIMITED
  • AFROFIRST MOBILE AND TECHNOLOGY COMPANY LIMITED
  • RANKCAPITAL LIMITED
  • IBS GOLDEN INVESTMENT COMPANY LIMITED
  • LENDVISERY SERVICES LIMITED
  • RENMONEY MICROFINANCE BANK LIMITED

See the full list here



1 https://fccpc.gov.ng/registration-status-for-digital-money-lenders-apps/
2 https://punchng.com/FG-approves-173-loan-apps-bars-illegal-online-banks/
Pages:
Jump to: