I say make I bring this one to our notice. Recently, Naija and other African countries don dey recognise as the world largest crypto farmers. So tay e affect many of our business men and women for society. With the way things dey go so no body for our country wan dull am again, about 70% of the youths don dey farm sites like tapswap, hamster combat, yes coin etc
Na tap tap tap full everywhere now and I just dey pity people because dem go just dey waste their time they tap nonsense as no be every airdrops wey you go dey tap go come you money like notcoin, wetin make notcoin blow na say people no been believe am and it was among the first airdrop to use the mechanism wey others they try duplicate like this so. Alot of marketing went into notcoin wey make top tier A exchange begin dey list am because of their community so make we no just dey think say na tapping go give us the money wey we dey hustle for.
Make we leave airdrop farming first and concentrate on investing as na their sure pass. I know say you go dey ask how people go take get the money to invest, na to double your hustle na. You fit still dey try tap your way to success oh maybe one day God go remember you and the coin wey you dey tap go blow but no put mind for there brother. Scams go dun full the tapping business already and soon majority of the project doing this tapping of a thing go just be a waste of your efforts.
No be lie you talk. The tap tap farming na complete waste of time. People's eyes go clear on am soon as tap tap go humble their efforts sae, they are all wasting their time on wetin no go pay them better money, instead na chickening money on the once wey go pay after so many long months of waiting for their launch on exchange.
I kukuma know sae, as this farming of coins d reign so, almost 90% of newbies don believe sae em go pay them. Lecturing them that it won't, will be hard for them to take on, cos dem don see how Notcoin first pay their community users.
As tapswap and Pixel don already disappoints many, the eagerness of continuing farming of coins among users don d reduce small small compare to before. Which is a clear evidence that, people don d realize sae, the farming of coin is a complete waste of time, it is better to take up an investment journey for bitcoin, wey dem d sure sae em go yield dem something by next year probably as we d anticipate bull run.