Pages:
Author

Topic: Depending on a single income now na suicide now - page 2. (Read 240 times)

full member
Activity: 280
Merit: 151
God is All
just imagine if you get like 3 to 4 tins wey dy give you money, no matter how things tough, e no go fit overwhelm you,
But where person wan take see like 3-4 things wey go dey give am money when e be say to even get one reliable one na problem. Work nor too dey this our country, and any small business wey person dey try use package to hold body, before person go fit drink water drop the cup, you go hear for news say price of things dun increase o, You wey get the business go cun dey reason how this your business wan take survive, before you go know, you dun shut am down. It is not easy being a business person in Nigeria make you fit get extra source of income, things get as e be.
My brother opening a business sef for this country be like something wey no dey possible again nai make I dey always look onto the world of technology for that extra earning job wey I dey look for. The world today is filled with lots of bright mind and many ideas full the internet so na just to know the right thing to do because you will be surprised on watin people dey do dey take collect their small change join their real job because the country matter don pass hoping on minimum wage or one source of income for feeding.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
The issue of depending on a single income for this current economy na suicide oo, because as we dy this country, the way price of everything dy add up everyday, I just dy imagine how people wey dy depend on a single income dy  use cope, talkless of those wey no even get job, because e no dy funny again at all, just imagine if you get like 3 to 4 tins wey dy give you money, no matter how things tough, e no go fit overwhelm you, because your financial ground dy strong, our newbies, make ona try to dy creative enough to double ona hustle oo, because right now e no easy for those with a single income.
This country no really funny again ooo, the way prices of things dey even go up no really funny at all, prices of things just dey increase on a daily basis, if you enter market today, price of things go don increase again if u enter the following day, na people wey dey even do government work I dey pity pass, prices of things dey increase daily, and salary dey stable, e no dey increase, and most of the people wey dey the government work no get multiple source of income, na only salary dem depend on and it’s not increasing.

Sometimes it’s not all about having plenty sources of income, you fit get plenty sources of income, make them no dey carry plenty money come, if you dey hustle for source of income, make u dey hustle for d once wey go dey carry better money come,  because with the way things be now, small money no fit do anything for dis country again. And make u no go establish like business wey u no go fit handle or monitor because u dey look for multiple sources of income, if na two u go fit handle well, then focus on only d two.
full member
Activity: 462
Merit: 145
just imagine if you get like 3 to 4 tins wey dy give you money, no matter how things tough, e no go fit overwhelm you,
But where person wan take see like 3-4 things wey go dey give am money when e be say to even get one reliable one na problem. Work nor too dey this our country, and any small business wey person dey try use package to hold body, before person go fit drink water drop the cup, you go hear for news say price of things dun increase o, You wey get the business go cun dey reason how this your business wan take survive, before you go know, you dun shut am down. It is not easy being a business person in Nigeria make you fit get extra source of income, things get as e be.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
My country people, ona good morning, wetin I wan talk now na for mostly to our newbies because I believe say most of ona wey be veterans for this forum know this tin, but because of say newbies dy sign up everyday, I just say make I update Dem.
On a normal note, you don't need to update anyone with a new topic, anyone's who's ready to make a difference will make use of the search engine icon so you don't need to create new one for any reminder, although you did a job weldon but if you want to make such things easier for new comers you only have to bump the thread by making comments.
Quote
The issue of depending on a single income for this current economy na suicide oo, because as we dy this country, the way price of everything dy add up everyday, I just dy imagine how people wey dy depend on a single income dy  use cope, talkless of those wey no even get job, because e no dy funny again at all, just imagine if you get like 3 to 4 tins wey dy give you money, no matter how things tough, e no go fit overwhelm you, because your financial ground dy strong, our newbies, make ona try to dy creative enough to double ona hustle oo, because right now e no easy for those with a single income.
Normally e no good to depend on only one source of income because you fit even run mad because of the frustration of this country, this country don reach to rewash am but naj only God get the power to do so by bringing us out from this hardship. The only way to sustain from this hardship nah only if the single job wey you dey do dey give you million naira a month, if you dey earn below such salary, Oga suffer to chok and nah only management get you, so nah true wey you done tell us. Only the topic done tell us wetin we need to do.
hero member
Activity: 616
Merit: 509
Top Crypto Casino
Price of things in the market are so expensive and still minimum wage still remains the same. This is not the time one needs to depend on this difficult economy challenge,  it is best to create more avenue of making money to meet up in this hard time. It is not easy because things are very much expensive thst even people with much income are even struggling to live comfortably this season.
With the current rate of things in this country e no dey advisable sef to even say make you get only one job because you go get am hot as when the pressure starts coming. Nigeria as of now na war zone and na only people wey get extra means of earning nai go fit manage their self for the country and e go come bad pass say you dey also feed family join because buying foodstuffs na like garri and rice na people three to four months salary now.
full member
Activity: 224
Merit: 195
I do not think this is only helpful to just newbies alone, everyone of us despite our ranks are obliged to having more source of income than just a single one. Adding to yours, my advice would be to get a pay job then aswell own a good  lucrative business. Since the price of goods are increasing and salaries are just stagnant this is where business helps the most, as we know a good business person don't sell lower than what the goods where bought, giving every assurance of profit making not withstanding any inflation in the country economy.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
If u look at your area very well op, u go no sey na people wen get only one source of income dey feel dis inflation past those who have plenty sources of income wey dey give dem money day and night and, if d economy even collapse more than dis it will not affect such people financially or materially.

I believe newbies will learn lesson from dis your topic wey u carry come here dis morning because, no senior members in dis local board forum go talk sey he or she  still depend on one income because some of dem don make plenty money from signature campaign dat will allow dem to create many businesses dat will b bringing more  money into their account like water.
full member
Activity: 364
Merit: 154
Mmmm, me self tire anytime person just sleep wake up first thing you go hear nau this certain goods or product duh add price ohh. In this short period of time tah things just dey change and this year just dey start Omo!!! If person nor get good sources of income e nor dey pretty oh. We bless God for cryptocurrency for we nation oh. Because this stuff have change and save alot of lives for this our country.

Because many way dey wey you go fit use this cryptocurrency stuff try earn . I've heard of someone that use airdrop money make am for life the guy as Matt two mansions with crypto money. See one thing about this crypto any concepts you focus on for this space dey run am with heart and dey consistent you go see how you go tey progress fast. And always try dey invest still nor make mistake wey many of us make say we be traders no need to invest. Omo you trade dey earn daily (though losses still dey ) also dey invest and make sure is always long-term investment because e go help reduce the risk and e dey mor ensuring to bring bigger returns ( profits)
full member
Activity: 560
Merit: 161
Price of things in the market are so expensive and still minimum wage still remains the same. This is not the time one needs to depend on this difficult economy challenge,  it is best to create more avenue of making money to meet up in this hard time. It is not easy because things are very much expensive thst even people with much income are even struggling to live comfortably this season.
full member
Activity: 196
Merit: 123

Jump to: