You no supposed think, one of the main rules of investment na say make we no use borrowed money take invest. Investment supposed be sometime wey be say if things no go as you been plan am you fit adjust your investment timeframe add more waiting time. If you been plan to hold to 6 months and after that 6 months things no come out as you plan, you fit add more waiting time but when you dey use money wey no be your own like wey you borrow, e go make fear catch you well well and you go dey rush to sell make you no lose everything and in that process, you dun sell at loss wey be another thing wey you no supposed do when you invest. Borrowed money go make you no get peace of mind and na so you go dey over monitor the market because fear dey catch you. E no matter how small your money dey, no borrow to invest or na you go still suffer am.
Very valid point, all this newbies dey think say the market na only one sided so as dem borrow everything go go as dem plan but the market dey always get another plans. Bitcoin na one of the worst assets to borrow money invest inside because the price volatility no be here and if you come get to pay back the money in the nearest future na big problem be dat because the market fit decline that period and put you at a very big disadvantage as you fit no go only lose but now you get to look for another means to arrange money take cover up which is unplanned expenses wey you for fit avoid, if you been just dey contended with what you have and invested with only your spare money.
Na the problem with newbies be that o. Dem no dey broad in their thinking when it comes to Bitcoin investment. As e be say dem never get the market experience Naim make dem dey always wan do hurry hurry to invest in Bitcoin forgetting say the market no be as dem envisage am to be. Dem no really get clues on Bitcoin market volatility not to talk of market experience.
Most of the newbies wey dey enter the invention plans Na based on say dem tell dem as e be dem never get the trading experience though and as a result of wetin dem don hear, dem want run test to see as e be but unfortunately, the way dem dey take enter the market no be so as e be that is why you dey hear people say dem buy high all of a sudden price drop den dey get stucked up at a particular spot for a long time without being able to sell because they would be at lose if they try sell at that price they bought initially.