Pages:
Author

Topic: Do not save your keys on your phone. - page 2. (Read 225 times)

hero member
Activity: 546
Merit: 516
September 29, 2023, 10:21:29 AM
#4
Some people really get bad habit as e take concern security of their information. Some people dey even save their ATM pin for their phone, I don see one or two of them and na this type of people wey dey loose their money carelessly and them no fit know how e take happen. The worst part be say se of them know say na bad habit but if you asked them, they go just tell you say their head don full so them no wan forget am
Abeg make we continue dey  teach people basic things wey them supposes know about their security, make we no tire because plenty people no dey take security seriously.
sr. member
Activity: 700
Merit: 470
Hope Jeremiah 17vs7
September 29, 2023, 09:55:41 AM
#3
There is a easy way to get your Bvn, using your registration SIM just Dial *565*0#. This is among the reason we just use a simple lock because of anyone is able to get the SIM getting your Bvn is no stress. I know saving our Bitcoin key on phone or devices is not really save but sometimes it's the best for such person basic reason maybe that's where he/she gets more privacy and security because sometimes when one is protecting against online thefts, the offline thefts are much closer. Though the best way to protect your bitcoin Keys is offline but sometimes some people don't have that offline privacy    and so they opt for the online after all no protection measures is 100% save, it depends on the individual to make it so.
hero member
Activity: 560
Merit: 511
September 29, 2023, 08:35:43 AM
#2
Na phone be the best place to save BVN because in case you go bank and he get important matter wey you won run unknowingly to you say, you go need your BVN, he dey easy to access am from you phone, since person no go fit use your BVN alone use steal your funds. When we dey talk about private keys, me and you know say this one na him be the key to our funds and nobody go dey daft to keep am where third party go fit access am because you won throw way your bitcoin to people wey dey find am. As we all know say you no need your private key for any serious thing since na you be your own bank and nothing go warrant the urgent need of am or say something go occur wey person go say he dey necessary. Anywhere wey you dey and you need to use your private key, na for you to wait till you go house to take am from anywhere wey you write am keep for safety.
He good as you drop this message so that newbies go fit learn so that make them no make such mistake.
full member
Activity: 658
Merit: 172
September 29, 2023, 08:10:26 AM
#1
I observe something wey be like e dey common well with our people concerning how we dey take save things for our phone with reasoning how sensitive the information dey. One very ogbonge example na BVN number. If you ask many people to give you their BVN number, dem go bring out their phone begin dey find am for either their contact list wey dem save am, or for gallery where dem snap am, make dem fit give you the number. Although the thing dey handy, e nor too go well.

I cun dey reason say, If na so e be for BVN and some kind other numbers dem wey people dey save for phone, e mean say some kind people wey dey use bitcoins dey fit dey also save their keys for "Notes" or save screenshot of am for their phone gallery. It is not save at all ooo...MAke we nor follow dey go make that mistake oooo, Do not save your private keys on your phone either for Notes or for Gallery. Crimanals dey smart well well, you need to get sense too to follow dem up.
Pages:
Jump to: