.All I'm trying to say is, the market cap of Bitcoin has been increasing by there are no advertising team out there who are being paid for advertising Bitcoin to the public.
When something is too good it can't be hidden and will need no direct advertisement to get to the masses. Bitcoin na a decentralized currency, this one mean say na we get Bitcoin and no body there's no CEO or marketing manager to dey strategize plans on how to make Bitcoin blow. Na we wey be the users still be the marketers indirectly. I hope you know say your testimony can convince someone to try something new more than any ads wey the company of that thing put out. As you tell your friend say na Bitcoin dey give you the cash dem wey you dey spend so E go convince am pass any ad wey Bitcoin for fit put out (assuming Bitcoin was a centralized currency to do that).
Bitcoin dey enjoy advertisement from companies wey dey use am as a payment option or dey associated with am in the same cryptocurrency industry. Some clubs for premier league and other leagues too get Bitcoin related service as their sponsor, some of them get Bitcoin official logo as their company face and some of their ads dey get Bitcoin inside. All this one na ads wey plenty people for their billions dey see so this one na advertisment for Bitcoin too. Casino dem dey advertise Bitcoin for sports events as dem go tell you you fit bet with am for this sites. When media talk negative about Bitcoin e dey give am publicity too.
Everything need an advertisements, Bitcoin already dey get advertised but no be Bitcoin dey do am directly, na him investors dey do am for am. For Bitcoin to become this popular na because say many people see ads about Bitcoin in different ways. Without advertisement nothing fit succeed but no be all advertisement dey come from the founder of the business.