I realize say after di halving, many newbies de expect say Bitcoin price go begin to surge and we go enter bull run immediately, but di reality now be say price de dip di more everyday, and some of dem panic and de rush to sale dem Bitcoin, but di truth be say research don show say bull run no de start immediately after halving. Any investor wey de hudl Bitcoin no suppose to de focus on di short term pump and dump price speculations, because na long term project im suppose be.
E fit interest you say no be only newbies wey been dey reason like that, even some people wey don dey the industry for long come dey follow dey feel the same thing, simply because of the news and general speculation them hear say halving dey come with bull run but wetin them supposed do na to first do them own research because crypto market get rules and regulations.
Asides the market being naturally volatile, e get plenty factors wey dey contribute to the temporary movement if the crypto market, and again, we no go completely rely on past performances, come carry am put for present or future, say because e happen like this last year, e go also happen like that this year or next year, e go only lead to to making careless decision, because human being no fit predict wetin go happen for future, so we gats first realize say those speculations we dey hear and dey follow blindly na still human being predict am, and if we go follow am without doing our own research, e fit land us for big wahala.