Pages:
Author

Topic: Food price in your area - page 2. (Read 248 times)

full member
Activity: 798
Merit: 134
January 28, 2023, 12:50:42 PM
#11
My area being ph, e rough well well and things like this na no go area especially to enter bus to the next bus-stop due to increase in fuel price.

I have think of to relocate from my area to another area in ph where food stuff will be cheap and affordable., if you know any area please drop it here, only for ph.

Make we yan

I noticed something for Port Harcourt, you see anywhere wey light dey 24/7 the food items in that areas na die meanwhile e no supposed be like dat. Normally e supposed be say if light dey den foodstuffs supposed no cost that area. I go iwofe then I come buy bole. Jesus 1.5k no fit give me better something self. Only the fish self dun chop like 5h and no be say na one kind big something like dat. Worst na if you come go dem transamadi dem or GRA area. All those residential areas wey big companies dey, e belike dem no dey do for doe normal people dat side. So if food they cost like this then wetin foodstuffs go dey costs.

You see this PH eh, dey your dey oh, no go dey think say one area better pass the other unless you wan give up some privilege wey you been dey get for your current area. Like you fit go where food no cost but road no come dey or light no come dey. Insecurities self wahala come follow. PH Normally things cost die, I just dey imagine how our Igbo brothers dey do for their own end as I understand say things for that side cheap die.

Wait oo, why e be say landlords them dey carry light as an advantage to increase house rent like mad. Like this for my Area wey I dey stay house rent been no too dey expensive o but immediately them work road pass, the next 3 months them knock for our door say make we jaz out for compound meeting that from next rent payment it will be increased by 10% again upon that self the rooms dem no even large enough to accommodate at least 2 to 3 persons.
Ikwerre landlords no go kill person kia kia, if for say everywhere pure as we think like this me for even relocate go LGA where light sara anyhow for ONELGA.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
January 28, 2023, 10:35:09 AM
#10
D food price is everywhere my brother, the fault is from d bad leaders will have in our country, they will travel out of the country seen good tins and enjoy it there, but dey will never have the sense of establish it in our country. I believe, with time this hardship will be a tin of the past bcos one day the food price will return back to normal in all the 36 states in Nigeria. Please don't leave ur state now becos d high cost of food stuffs is all over the country.
hero member
Activity: 700
Merit: 523
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
January 28, 2023, 07:31:12 AM
#9
Naija don cast,inflation na d order of the day for everywhere, make we no deceive ourselves becos na one same president dey control the full country. Commodities price don increase three times the normal price last year till now,the worst be say the money dey depreciate every minutes. Somebody wey government dey pay 50k at last year wey dey manage am take care of him basic needs,now things don tripple their price and government no increase the person salary, No be juju be DAT ?.

For my side for BY, everyday wey I dey go buy something,na so I dey paro,because wetin I buy today,if I go buy am tomorrow, the price don increase, I go come dey wonder whether foodstuff dey e bull market, because I know say na only bitcoin get this kind movement. LOL.

OP, dey wey u dey o,on go dey feel say u won dey jump,jump,nothing come out for other areas so calm down manage your area price because you still get benefits we u dey benefit for your present place
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
January 27, 2023, 05:22:25 PM
#8
Well me I go talk true, this don really go up for my area oh, food price don increase incredibly and the thing just they go up every day. The country is really in a mess.

For example commodity you go fit get before for 300 naira now the thing don Dey go to over 500 or even more, all this thing the burst my head honestly and the economy dey get worse every day.
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
January 27, 2023, 05:19:47 PM
#7
My friend no try am say you wan leave your place go another place because of food matter, because na all over the country the thing be so, as I dey talk to you now ehn before for my side I dey enter bike to place wey no too far 50 naira but for now even 100 naira own u no go see, so my advice for be say appreciate what ever is going on in life and know that the problem is not only in your area, as he stands now na all over Nigeria things dey hard.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
January 27, 2023, 05:46:58 AM
#6
My area being ph, e rough well well and things like this na no go area especially to enter bus to the next bus-stop due to increase in fuel price.

I have think of to relocate from my area to another area in ph where food stuff will be cheap and affordable., if you know any area please drop it here, only for ph.

Make we yan

I noticed something for Port Harcourt, you see anywhere wey light dey 24/7 the food items in that areas na die meanwhile e no supposed be like dat. Normally e supposed be say if light dey den foodstuffs supposed no cost that area. I go iwofe then I come buy bole. Jesus 1.5k no fit give me better something self. Only the fish self dun chop like 5h and no be say na one kind big something like dat. Worst na if you come go dem transamadi dem or GRA area. All those residential areas wey big companies dey, e belike dem no dey do for doe normal people dat side. So if food they cost like this then wetin foodstuffs go dey costs.

You see this PH eh, dey your dey oh, no go dey think say one area better pass the other unless you wan give up some privilege wey you been dey get for your current area. Like you fit go where food no cost but road no come dey or light no come dey. Insecurities self wahala come follow. PH Normally things cost die, I just dey imagine how our Igbo brothers dey do for their own end as I understand say things for that side cheap die.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
January 26, 2023, 11:29:59 PM
#5
 This food prize na something wey I too no expect way go follow suffer man pikin like this at all at all, imagine when bakery piple go say the prize of flour don go high even market piple go follow say prize of ordinary pepper vegetable leaf maggi Onion self and other small small soup relatives don go high, tah who we offend?
 Everything don change finish and this system no fit help this contri at all, garri con follow dy cost pass normal and na something we dy take do sharp sharp food oh, add water with your things you drink take waka go hustle but now try am nah...oh nah wah oh, I just blame this fuel prize wey don climb up if not no body go charge person plenty moni for tp.
full member
Activity: 798
Merit: 134
January 26, 2023, 07:39:09 PM
#4
That your area wey you d stay for Ph, just d dia full time ooh. As Nigeria be so, no place wey people no the complain of how the market stuff take increase. Everything don triple for price. Price of foodstuff d hit everybody front and back. Talk now wey money no dey.

As the matter take bad so, na Oluwa go d make arms reach for us, until we pass this level of hardship and make way for the new government wey go stabilize the cost of living for this country cos the rich and poor the complain of the high cost of things. Everywhere don red

My brother this one shock me oo, even self I go buy something today na so one madam come out for motto begin argue something like play na so she say we na one, say make we leave am say them dey drive motto say na same money we dey spend. Country hard for every body, although as I been drop this post here I been dey wait to see feedback from my people here but e no come quick so I just reason few of my men them physically, so them say make i no relocate oo. Just as you yan here.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
January 26, 2023, 07:26:30 PM
#3
That your area wey you d stay for Ph, just d dia full time ooh. As Nigeria be so, no place wey people no the complain of how the market stuff take increase. Everything don triple for price. Price of foodstuff d hit everybody front and back. Talk now wey money no dey.

As the matter take bad so, na Oluwa go d make arms reach for us, until we pass this level of hardship and make way for the new government wey go stabilize the cost of living for this country cos the rich and poor the complain of the high cost of things. Everywhere don red
newbie
Activity: 25
Merit: 0
January 26, 2023, 06:00:11 PM
#2
This matter nah general and not only pH, my people for me e I am confused.

For the food stuff matter, no where you go see am cheaper ooh, for my side here in Delta State, not only rough, but it is hot here particularly my area.

But brethren, I will suggest that, the cost of all these things is do to the fuel scarsity and secondly changing of new naira notes.
full member
Activity: 798
Merit: 134
January 26, 2023, 08:42:36 AM
#1
Greetings my people, i say make i do small comparism about food price around our country and how do you cope with the sudden increase in food and in general of all aspect of life.
How do you manage it all, seeing that in our country to have a 3 square meal is very hard and rough. And for those with families how do you all find it.

Jump to: