Pages:
Author

Topic: From the experienced (Read 174 times)

hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
November 13, 2023, 07:39:32 PM
#22
Op you be Nigerian and I know say you know plenty things wey you fit use you laptop do but I noticed say you just want to find our mouths. And other users don tell you weti you go fit use am. And me na add I go add for you. In this cryptocurrency space, you can use your laptop to create websites to fetch money unlimitedly, creating of Facebook pages for people, blogger, local news editor and movie editor. So these are some the things you can use your laptop to do and get small small money every day.

And those ones wey we describe if you can do all at a time then you specialize in one area and focus on it so that everything go dey well for you.
full member
Activity: 294
Merit: 232
Let love lead
November 13, 2023, 04:23:52 PM
#21
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg
OP, make I first congratulate you say you no reason to enter fraud as you get laptop and you dey find money, cos it is a normal trend now for guys who just acquired laptops or Iphones to jump sharp enter scam to dey hold their side.
Secondly, person no dey just wake up begin make money, person dey get wetin em fit offer in exchange for the money wey im dey find. You get anything wey you wan use that laptop offer to another person make e take fit pay you?. Na these things you go consider before you begin reason of making money online with your computer. A lot of people have given you valuable advise on how you fit take learn one or two skills wey dey pay wella. I go add my own encouragement say I go yarn you sraight up say no be as them dey take talk am na so em beooo. For any skill wey you choose to learn, you go encounter challenges, people go reject your works until your hand strong for any work you wan do in exchange for money.
Now you got to learn first before you think about earning. Be committed, no reason your failures, but instead, learn from them and move on, keep your eye fixed on the target wey you don set for yourself and always have in mind ay person wey be baba for em work today get when em be smally for the  work and you sef go turn baba too and begin collect better money if you cool down learn well.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
November 12, 2023, 06:22:09 AM
#20
I believe that if you already have computer skills, getting a soft job that will pay you well shouldn't be a serious problem. The mistake most people make is to look for ways to just earn money online without acquiring the necessary skill that will help them find relevance in the online space. Just like the physical job require you to be skilled, the same is what is applicable in the online space and you also need to be skilled at something and them you can render service to someone in nee and then you get oaid for it.

There are lots of soft skill that if you put in the needle effort, it won't take too much time before getting a good paying platform to work with. Some of the soft skill include.
1 graphic design
2. CPA marketing: I have done this before and if you do it the right way, it pays well
3. Copy writing
4. You are already in this platform and if you dedicate the right time doing the right thing here, some penny can come in

But what you have to know is that you should dispel and remove any form of getting any financial benefit from whatever soft skill you choose to go into at the onset. Make it a necessity to get the skillset first and with time, money will start coming in.

In addition you fit use am do the following:
Affiliate marketing
Blogging
Dollar abitrage
Software development
Online consultancy
Content creation etc

There are many of them but you fit just look for the ones you dey good at. Because most of them no too much pay like that Sha except say you put your mind wella.
sr. member
Activity: 322
Merit: 250
November 11, 2023, 08:49:42 PM
#19
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg
Plenty things them dey to take laptop do but depend on the skill wey you don acquire. Before you take your laptop earn money, you must know how to use the laptop work because free money no dey anywhere. So the question be say, wetin you fit do with your laptop? If you dey good for graphic design, Web design, coding, design softwares such as Autocard and others. With any of these, you fit dey for your house dey work across the world as a freelance or full time employee. The opportunity many, na the skill to take work be the koko
full member
Activity: 518
Merit: 156
November 11, 2023, 07:05:33 PM
#18
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg
You fit use your lappi take learn how to trade in cryptocurrency, trading na something way u fit start with small money, then grow your account small small. YouTube videos them plenty for you to watch and learn, if you get any questions, you fit bring am come forum make people fit help you with answers. That wan go make you not to dey idle because you go dey stay online dey observe the market.
full member
Activity: 266
Merit: 113
November 10, 2023, 05:39:02 PM
#17
I believe that if you already have computer skills, getting a soft job that will pay you well shouldn't be a serious problem. The mistake most people make is to look for ways to just earn money online without acquiring the necessary skill that will help them find relevance in the online space. Just like the physical job require you to be skilled, the same is what is applicable in the online space and you also need to be skilled at something and them you can render service to someone in nee and then you get oaid for it.

There are lots of soft skill that if you put in the needle effort, it won't take too much time before getting a good paying platform to work with. Some of the soft skill include.
1 graphic design
2. CPA marketing: I have done this before and if you do it the right way, it pays well
3. Copy writing
4. You are already in this platform and if you dedicate the right time doing the right thing here, some penny can come in

But what you have to know is that you should dispel and remove any form of getting any financial benefit from whatever soft skill you choose to go into at the onset. Make it a necessity to get the skillset first and with time, money will start coming in.
sr. member
Activity: 630
Merit: 420
November 10, 2023, 02:30:14 PM
#16
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg
U don dey forum already now, hustle dey here too now, I see say u don dey move ur account go up small small, just try carry am go full member make u enter signature campaign with am, something go dey commot from there. If you get any skills again, you fit just create thread for service board make u dey advertise ur skills, if you really sabi am well, people go patronize you also, and also bounty campaigns dey, even as bounty no dey now, u fit dey rugged bounty, or if you go fit wait make bull run start, better bounties suppose dey by that time. Other online hustling dey but me I no dey into am, na d once wey I sabi na him I don tell u already.

If you need more informations about bounty campaigns, u fit enter my Dm make we talk better.
sr. member
Activity: 574
Merit: 308
November 10, 2023, 02:03:09 PM
#15
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg

No be by getting laptop bro but wetin you fit do with your laptop. I sabi plenty people wey get laptop but dem dey waste am to watch movies. Some of them no even sabi use common ms words for typing. To me, computer center sef no dey bring money again as compare to other things wey you go even stay your room run things with laptop. Everything don turn digital now and graphics design dey lead now out there. The problem here now be say no be everything you go fit understand if you want to connect with person online. You need take your time stroll your area find person wey sabi the work and ready to teach you.

Graphics design and video editing dey kill am low key and you no need money to open shop sef cux your room is enough for you and your laptop is good to go. My guy dey run am here and he no dey even sleep for night sometimes because of too much work. Na me know wetin the guy dey earn with that stuff. Na to just sabi am and work dey always dey especially if you dey spend time on online and connect with people to advertise wetin you sabi do. E dey among my plan to learn the work when I finish with my present program.
member
Activity: 334
Merit: 27
November 10, 2023, 06:16:33 AM
#14
One idea running through my head is learning how to design signature codes. Right on this forum, you can see that most of the ranked-up members are already in the signature campaign that is actually paying. If you rank up, you can get lucky enough to be selected in any campaign, and while you contribute positively to the forum, you will be rewarded for your post. Speaking of the signature code design, there are some good designers on this forum, and if you PM any of them, you can possibly hit a deal with them to learn how to make those signature codes, and if you are perfect, it will earn you some money in no time. Nothing good comes easily.
Abeg if you know anybody for this our local board wey Sabi this thing, abeg make you link me up or mention the person for here make I give am private message
member
Activity: 334
Merit: 27
November 10, 2023, 06:12:03 AM
#13
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg

You don try digital marketing before? Chai na one thing wey I don use make money for my self since wey I get more acquainted with the digital skills o. And wetin I dey focus majorly na Instagram and Facebook account management, Instagram and Facebook Ads, Google Ads, Landing pages and other few more jobs online.

I no go fit explain all these things in details but if you fit take your time learn these things and you come apply those skills properly.

For instance, since wey I start social media management, I don manage pages for plenty businesses such as some foundations and businesses. Plenty people dey out there wey dey look for someone wey get the knowledge to help am manage their pages since them no really get that time to dey update them pages. You fit just take charge of that, create a simple posting calendar and use the ideas you have in content creation to fashion your posts.

Secondly, since the advent of the social media, plenty businesses don dey turn their attention to hoe dem go fit grow their businesses as well as their customer base by making their products known with targeted audience which is achieved by marketing of those products through ads. If you sabi how yo set up ads account for client you come sabi set the targeted audience alone, you go fit make money your thing.

Just like the Instagram and Facebook Ads, Google Ads is also another platform where businesses promote their products or services by having their links published in the top of your search engine through keywords. So that by the time me and you search something related to that, it pops up the promote link.

I dey do landing pages for people wey get businesss wey dey look for a one stop shop webpage wey go link visitors to any other links wey dem want people know about them of their businesses. And many more.

With these aforementioned skills, if you go fit focus on them as them no hard, come get people wey need your services, boom, you for done harmer.
abeg u go give me your contact make I message you for Whatsapp or telegram
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
November 10, 2023, 05:07:14 AM
#12
My brother you really open my eye for this one oooo, no dulling, na to start how to start work be that oooo. I really appreciate this your advice, abeg I still dey wellocme more suggestions

You are welcome op, I dey very glad to see say you find my opinion useful.
Another mind blowing one na if you get the skill to create and design website with this skill you go chop beta money, e nor need you to dey very professional before you go start to dey develop website oo, and one of the reason wey I like am na be say e nor too hard to learn, provided say you get laptop with positive mind to learn am. If you be good writer I don even hear say weda amazon dey pay some writers if you upload book. And you fit even work for freelancer or upwork if you get some digital skill like graphic design, copy typing, conversion of documents, web design, cyber security etc. The skill of cyber security na highest that one na blast, but before you go fit learn am you go spend money.

Then for the very low paying jobs wey I know, you fit install jamb mock test application for your laptop so that during the jamb registration period the jamb applicant dem fit dey use am the do the mock exam but na 5k for a month dem dey normally dey pay, and all you need na to just use 1k take validate the application for you laptop then you are free to use am for ever. The mock exam na 2h and one student fit practice am for 3x a week, and inside one day you fit accommodate 4 students for one laptop, so you fit get 2set of students for one laptop for a month.
so 4+4=8
8x5000= 40,000

So you go dey get N40k per month.
sr. member
Activity: 490
Merit: 311
Play Bitcoin PVP Prediction Game
November 10, 2023, 04:34:51 AM
#11
There are some many skills to learn using your laptop but the but the biggest issues is persevere in the skill you are learning. Most beginners just want to earn from the skill they are learning without completing or going a bit far on their learning process, forgetting the fact that learners are earners, everyone who we inspire us was once beginner in the learning process before they got to position they are now and will continue learning to grow. Some of these skills include:
  • digital marketing
  • Web development
  • Writing (those offering writing services like Copywriting, script writing, stories, birthday wishes and others).
  • Graphics design, Animation and lots more
full member
Activity: 560
Merit: 161
November 10, 2023, 12:13:43 AM
#10
Aside crypto their are things one can use the computer for. Web designing is something very rucreative that good amount of money can be generated from. Programming is another good skill that can fetch one good amount of money money, so I think aside crypto their are many things that can be generated with money.  This days people make money on social media with different ideas.
hero member
Activity: 532
Merit: 508
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
November 09, 2023, 07:23:23 PM
#9
One idea running through my head is learning how to design signature codes. Right on this forum, you can see that most of the ranked-up members are already in the signature campaign that is actually paying. If you rank up, you can get lucky enough to be selected in any campaign, and while you contribute positively to the forum, you will be rewarded for your post. Speaking of the signature code design, there are some good designers on this forum, and if you PM any of them, you can possibly hit a deal with them to learn how to make those signature codes, and if you are perfect, it will earn you some money in no time. Nothing good comes easily.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
November 09, 2023, 06:39:19 PM
#8
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg
There are plentiful money making skills you can acquire using your laptop that you will be making serious cash from it without only depending on bitcoin. And I do tell people that if they have to learn a skill it should be one with high demand in the field. A skill that you will be sort for and not stay dormant after acquiring it.

Cybersecurity analyst/engineer,
Content creator,
Data analyst,
and a whole lot of others but these three are just what came to my head right now. You can do a research on more on the net.
full member
Activity: 392
Merit: 236
Bitcoin in Niger State💯
November 09, 2023, 05:25:40 PM
#7
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg

You don try digital marketing before? Chai na one thing wey I don use make money for my self since wey I get more acquainted with the digital skills o. And wetin I dey focus majorly na Instagram and Facebook account management, Instagram and Facebook Ads, Google Ads, Landing pages and other few more jobs online.

I no go fit explain all these things in details but if you fit take your time learn these things and you come apply those skills properly.

For instance, since wey I start social media management, I don manage pages for plenty businesses such as some foundations and businesses. Plenty people dey out there wey dey look for someone wey get the knowledge to help am manage their pages since them no really get that time to dey update them pages. You fit just take charge of that, create a simple posting calendar and use the ideas you have in content creation to fashion your posts.

Secondly, since the advent of the social media, plenty businesses don dey turn their attention to hoe dem go fit grow their businesses as well as their customer base by making their products known with targeted audience which is achieved by marketing of those products through ads. If you sabi how yo set up ads account for client you come sabi set the targeted audience alone, you go fit make money your thing.

Just like the Instagram and Facebook Ads, Google Ads is also another platform where businesses promote their products or services by having their links published in the top of your search engine through keywords. So that by the time me and you search something related to that, it pops up the promote link.

I dey do landing pages for people wey get businesss wey dey look for a one stop shop webpage wey go link visitors to any other links wey dem want people know about them of their businesses. And many more.

With these aforementioned skills, if you go fit focus on them as them no hard, come get people wey need your services, boom, you for done harmer.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
November 09, 2023, 04:52:01 PM
#6
Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg
As you self nah one of our personal Nigerian, even if say you no beg, men dem they way go guide you on how you go fit use you laptop take make living, for me, like watin other pipo talk nah one of the easiest way to dey get small small money, if you get or learn any of those skills like Grafics work or web designing you fit still carry your skill enter Upwork there self na were you go fit dey get small all things, sha for 9ja now $40 or $50 no be small money at least you fit still dey invest into Bitcoin if you dey get steady client way go need your service, even for 9ja now, those skills dey help well well, you fit even learn how to dey edit things like photos videos and all the rest of them.
member
Activity: 334
Merit: 27
November 09, 2023, 04:51:29 PM
#5
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg

Wattin I get to talk be say, person fit use em laptop take do graphic design, this na one of the jobs dem wey dey pay well for computing especially when you work online, if you observe the service board inside Market place for Economy you go observe say some new campaign wey come some time before dem start dem dey request for people wey go design logo for dem wey dem go use do the advertisements for this forum, some wey I don see dey even pay up to $300 to $200 if yoi win and if you convert that money respectively to our naira na about N300,000 to N200,000 using black market rates. So na beta money be that for make e no be like say I dey lie just check out this two post:
https://bitcointalksearch.org/topic/cfnpbanned-mixer-signature-design-contestreward-for-everyonewinner-gets-300-5468088
And
https://bitcointalksearch.org/topic/cfnpbanned-mixer-avatar-contest-reward-for-everyone-winner-gets-200-5468338

Computer center work them sef still dey pay well oo, OK op make I shock you, you fit just go pesh for school area doing their project period and you fit dey write project for student wey fit pay you about 15k, just imaging say you come carry about 3 to 4 project na 45 or 60k be that oo, there is no easy way of making money but if you enter the system gradually e go come dey simple for your eye. This na the few wey enter my head for now, maybe in subsequent time I go still add more.
My brother you really open my eye for this one oooo, no dulling, na to start how to start work be that oooo. I really appreciate this your advice, abeg I still dey wellocme more suggestions
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
November 09, 2023, 04:32:46 PM
#4
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg

Wattin I get to talk be say, person fit use em laptop take do graphic design, this na one of the jobs dem wey dey pay well for computing especially when you work online, if you observe the service board inside Market place for Economy you go observe say some new campaign wey come some time before dem start dem dey request for people wey go design logo for dem wey dem go use do the advertisements for this forum, some wey I don see dey even pay up to $300 to $200 if yoi win and if you convert that money respectively to our naira na about N300,000 to N200,000 using black market rates. So na beta money be that for make e no be like say I dey lie just check out this two post:
https://bitcointalksearch.org/topic/cfnpbanned-mixer-signature-design-contestreward-for-everyonewinner-gets-300-5468088
And
https://bitcointalksearch.org/topic/cfnpbanned-mixer-avatar-contest-reward-for-everyone-winner-gets-200-5468338

Computer center work them sef still dey pay well oo, OK op make I shock you, you fit just go pesh for school area doing their project period and you fit dey write project for student wey fit pay you about 15k, just imaging say you come carry about 3 to 4 project na 45 or 60k be that oo, there is no easy way of making money but if you enter the system gradually e go come dey simple for your eye. This na the few wey enter my head for now, maybe in subsequent time I go still add more.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
November 09, 2023, 04:19:49 PM
#3
Abeg my country people, for this crypto space or other aspects, wetin person fit do with ihm laptop wey fit dey bring money apart from computer centre work. As the country hard now, I know say e get people wey sti Sabi way wey fit show person way for the crypto space and some other area wey fit open person eye. No be laziness ooo but e easy to get the right info from person wey get the experience. Abeg make una talk ooo, na beg I dey beg
That one go depend on the skill wey you get, person fit tell you say A or B dey very productive, but maybe you no get the skill to do that thing, so which skill wey you get? And if you no get any, you have to go and learn one or two wey dey very productive. Naija people dey always talk say money dey "online", though na true talk oh, but e no mean say person go just dey pluck money online, you must get skill wey people dey look for online, and when they hire your service, them go pay you. Wetin you go do now na to search for those skills wey dey highly sought-after, then you go pick one or two learn am wella. But mind you say you gats dey very patient oh, because money no go begin come ASAP.
Pages:
Jump to: