Pages:
Author

Topic: Fuel Scarcity Discussion: NNPC sells petrol for N148; private depots, N215+ - page 2. (Read 640 times)

legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Fuel the scarse, things they increase money, Transportation this time around na one big issue, where we bin dey pay 500naira before done turn 2k, with no remorse. Na wa o, abeg o na this year o, no only pray for good leader get ur pvc and vote oo, Inec no dey count prayers oo, na vote them they count,

Aswr the wey things dey go I no sure say any president wey come go see am easy oh. Na better problem him dey go inherit do abi una no see the debt wey Nigeria get for e head already and bubu still dey borrow borrow more as nothing concern that one. Him dun talk anything concerning this fuel scarcity so? See as everywhere quiet like say nothing dey happen meanwhile taxi dey use transportation price use kill person. Even bot drivers dun dey add money for normal fee wey the bot give and if you no like am you cancel comot for their car. E no easy my brothers.

You just hit the bull by the horn. President be minister of petroleum and him no fit solve the issue wey we get for fuel scarcity for the country. That means say people wey hold that position before too try their best too. Hopefully, if new administration come into power dis year, we hope say them go find lasting solution to this fuel scarcity during Yuletide period. The matter tire everybody for the country like this.

Buhari wey no understand wetin to be petroleum ministry be go carry work give himself so him fit dey chop from too pocket now see as things dun turn out. You no go allow people wey sabi the job do am. Just rubbish government na dis man the run and now dem wan put their godfather for the seat and after him enter na so so compensation dem go dey do to themselves with positions meanwhile dey no sabi one thing for that position. Taa God no go gree bad thing happen to us again. We dun too surfer.
member
Activity: 308
Merit: 26
Fuel the scarse, things they increase money, Transportation this time around na one big issue, where we bin dey pay 500naira before done turn 2k, with no remorse. Na wa o, abeg o na this year o, no only pray for good leader get ur pvc and vote oo, Inec no dey count prayers oo, na vote them they count, so make we come out in our large numbers and vote rightly, no follow the small money dem give you sell our country, if possible collect the money still vote your conscience, Nigeria is for you and I , not for them , not fit Der children, vite competency, vote a president not presidency, we Dan too suffer for Nigeria, and e no supposed be so
hero member
Activity: 812
Merit: 675
I never know why e be say na during Christmas and New year we de get too much fuel wahala for this country.
The mata self de tire me because person no fit just travel anyhow now cost of transportation don high because fuel don cost. Even fuel wey person go use for Generator now come be like say person wan buy fuel to travel because d money don triple the former moni wey we de buy am before.
The most annoying thing be say na our President be the minister of Petroleum Cry

You just hit the bull by the horn. President be minister of petroleum and him no fit solve the issue wey we get for fuel scarcity for the country. That means say people wey hold that position before too try their best too. Hopefully, if new administration come into power dis year, we hope say them go find lasting solution to this fuel scarcity during Yuletide period. The matter tire everybody for the country like this.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Abeg,make una  no vex o,I won know who dey always make the fuel scarce ? Whether na tanker drivers or na federal government or filling stations owners.

I no think say federal government dey follow for this one unless e reach strike time wey tanker drivers go strike. Mainly na always issue between Depot and filling station dem. E fit be say depot wan increase price for selling so now filling station owners wey wan cashout go come hoard their fuel so when depot increase their price dem fit come sell their old supply for a higher prices then get better gain (this na one of the reason fuel Scarcity dey come about).

Now no be say fuel no dey but who when sell at a cheap price now when they fit sell later at a higher price. The next one be say depot dun give update say fuel no dey so now filling station go come hoard the current fuel wey dem get so dem fit they sell at a higher price when fuel scarcity come as depot never get supply or depot dun get compass to sell to only specific filling station like NNPC. The whole thing dey dey depot their hand, na dem dey cause everything mainly then follow by tanker drivers then filling station owners.
hero member
Activity: 798
Merit: 547
Leo is resting.
For this fuel scarcity matter eeh, I go like talk am as e be based on say I dey into the game and I understand the reason why e be like this.
First of all, na our president wey be minister for petroleum be the reason behind fuel scarcity for naija and the reason wey make em do wetin em do na so that em people wey be politicians especially em party members APC to get beta money wey dem go take do election for this 2023.

Our Presidoo allocated the supply of fuel for one particular depot for naija wey be Masters Energy knowing too well say if all the depot wey dey naija work the supply of fuel go dey easy and all the fuel station go sell for normal price our oga do the magic so that master energy go only get fuel and plenty fuel station go lack fuel because line up go dey among tankers to see fuel even if dem increase the price of fuel.

Personally, I go let us know say I dom dey master energy for PH for 7 days now dey wait for the turn but I never fit load fuel even after I pay additional 100k wey (NUPENG) charge just for you to pack tanker inside depot still no way for me because of the plenty tanker wey dey wait make dem attend to dem also. The price of fuel na #237 per liter for the depot but na the bribe and delay wey station owners dey encounter as dem go depot to buy fuel na em make fuel cost inside naija for now. I go still update us for here if any other thing happen from tomorrow concerning fuel matter for our country naija.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418


I see this story this morning e just remind me of wetin I go through yesterday to buy fuel for my side. I finally see am buy but na N270 per liter for filling station and still e no full my fuel rubber wey I been dey use N4,500 dey full before and this na N7,000k fuel I buy so oh. Abeg wetin be the problem with fuel for Nigeria for December period and how the country go fit solve this issue. Fuel Scarcity na very strong discussion for this country and our politicians no dey talk anything about am self and how them go solve am if we give them power. The thing come belike say na part of our living. Abeg how much you buy fuel recently for your area and how the supply. The scarcity reach your side?.


E don reach again oh, new year to take select the person wey go give us original treatment as leader oh, but I wan ask, this nah so we go line up just to buy fuel or exchange our moni for bank or when we want vote?
Why things for this contri dy always hard like maleria wen e dy start? Fuel wey I sabi before nah #75 per liter now nah #370 per liter and Dem still expect us to endure, till when na?

This things we dy experience for this contri no fit make person carry em church mind go vote dis same piple wey handicap us like this oh... Why we no fit do things the easy way? Who we really offend? The slave trade as of yester-years na scar wey no fit comot from our body as e comot from other contri piple body?
Make God help comot this suffer from we contri, na we prayer oh.
hero member
Activity: 700
Merit: 523
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Abeg,make una  no vex o,I won know who dey always make the fuel scarce ? Whether na tanker drivers or na federal government or filling stations owners.

I just see say this country na we dey kill ourselves by ourselves. Christians during Xmas dey use the opportunity dey extort people to hammer for the season which is bad. For second world country this period na wen them dey make everything cheap,do some promos like buy one get one free,so that even the poorest person go fit take care of e needs for Christmas. Muslims during their sallah everything dey go smooth because them like themselves and no go use their celebration flog people with hardship. Una go see say from Tuesday scarcity no go dey again,study your country well,you go see say everybody na scammer codedly. We need proper orientation to change our mindset,no be leaders we get na scammers.
 Grin
hero member
Activity: 812
Merit: 675
Omo dis scarcity na for everywhere for this country oo. I been travel recently and all the three states wey I pass through na so so fuel queue you go dey see everywhere oo. For my state, some fueling stations dey sell for N195 per litre, na d lowest you fit get am be that because even the NNPC mega station there na still N195 per litre. While most of the fueling stations there are selling close to N300 and some more than that, those kind places no dey get queue sha.

Wetin dey bother me always na why is it always like this at the end of every year, a country blessed with abundant fuel and there’s no enough fuel to supply to its citizens and a sudden rapid increase in the price of fuel. Sometimes, I feel maybe this marketers are just keeping the fuel deliberately to make it scarce so that the price will increase and they’ll cover up for all their losses for the year. I hope a lasting solution is found to it soon.
hero member
Activity: 1148
Merit: 555
Na 295/litre I buy today o I don see say them dey find way to make the price balance for 300/litre. God how we take reach here, transport for my side don cost even sef price of everything don high. E Dey pain say this kind thing dey hapun for this kain time, we just Dey manage the flood problem way sup last month people way the thing affect never still see where to shook head put. Instead of government to dey find way to balance the country make countryman fit see where e money dey enter na campaign poster and rally them dey spend money put. Port harcourt to Warri road wey flood spoil na patch them dey patch like this. If we nor jas up nothing go change
hero member
Activity: 896
Merit: 645
As at yesterday some filling are selling fuel at N350 - N370 in Port Harcourt.
I jst buy few minutes ago nd na #350 dem put am. My broda, dis tin weae rch my bone. Like, watin de happn 4 dis we nation cef? Hw we govmnt dey tak identify nd profile d wahala way dey d nation 2 knw d one of highest concern mak dem 4 tackle dat one first first. Dis kind tin no suppose dey happen 4 dis we nation na. Nation way get natural resources na em dis kind hike nd poverty rate dy worry lik dis...!

Issues lik dis fuel mata way get chain reaction on evrytin way dey sup 4 d nation nd security mata 4 b were were go place mor concern. If dem ft tackle, issues wth light, security, road network and transportation wth respect to fuel price, d nation no 4 hard lik dis.
sr. member
Activity: 504
Merit: 323
E no make sense as fuel scarce for the country people they suffer too much if fuel scarce na so everything dey cost for the country that NNPC suppose to do something about these
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
I see this story this morning e just remind me of wetin I go through yesterday to buy fuel for my side. I finally see am buy but na N270 per liter for filling station and still e no full my fuel rubber wey I been dey use N4,500 dey full before and this na N7,000k fuel I buy so oh. Abeg wetin be the problem with fuel for Nigeria for December period and how the country go fit solve this issue. Fuel Scarcity na very strong discussion for this country and our politicians no dey talk anything about am self and how them go solve am if we give them power. The thing come belike say na part of our living. Abeg how much you buy fuel recently for your area and how the supply. The scarcity reach your side?.
D hunger wey dey for the land dey too much couple with fuel scarcity and hike in fuel price kum skyrocket the price of things for market. A friend in Abuja told me that fuel is been sold at N148, but I don't know how true is this. As at yesterday some filling are selling fuel at N350 - N370 in Port Harcourt.
legendary
Activity: 1414
Merit: 1108
I see this story this morning e just remind me of wetin I go through yesterday to buy fuel for my side. I finally see am buy but na N270 per liter for filling station and still e no full my fuel rubber wey I been dey use N4,500 dey full before and this na N7,000k fuel I buy so oh. Abeg wetin be the problem with fuel for Nigeria for December period and how the country go fit solve this issue. Fuel Scarcity na very strong discussion for this country and our politicians no dey talk anything about am self and how them go solve am if we give them power. The thing come belike say na part of our living. Abeg how much you buy fuel recently for your area and how the supply. The scarcity reach your side?.
No be playing o bro. When I dey see #215 per litre for the OP, I con dey wonder say no be the same country we dey abi the petrol station dey set prices base on zone. Your own high small shah, na #260 per litre I buy the last time and that na early this month. Normally I jst carry previous pice for mind enter the fuel station. Tell them to put x amount way suppose full my rubber normally. Omo, I look my rubber, e con be like say I still dey short of 10litres. Na then I carry eye look the fuel price per litre for the dispenser o, e shock me to see #260 per litre. I still ask if them dey whine me and na confirm.
Omo, dey need do something to put all our refineries in shape. How can a nation way get oil go dey go through this kind scarcity and soaring fuel price, e no soft na!
hero member
Activity: 812
Merit: 725
I never know why e be say na during Christmas and New year we de get too much fuel wahala for this country.
The mata self de tire me because person no fit just travel anyhow now cost of transportation don high because fuel don cost. Even fuel wey person go use for Generator now come be like say person wan buy fuel to travel because d money don triple the former moni wey we de buy am before.
The most annoying thing be say na our President be the minister of Petroleum Cry
sr. member
Activity: 504
Merit: 302
This petrol issue just be like say no be Nigeria we dey because how come nigeria wey be ground of oil, oil go scas for the country, seriously this issue suppose to be solve very fast because fuel wey we dey buy use before from 4k now don turn to 8k now even the transport money now don increase, like place wey you will go before with 1k don turn to 2k and still money no dey, seriously this matter is getting worse every day I just pray that the new people we dey plan to choose as our leaders we help us commot from this matter.
sr. member
Activity: 378
Merit: 259
My broda the matter choke dis fuel scarcity sef e just tire person per liter for my side sef na 2900 and the kind line wey you go do before e reach ur turn, even black market per liter na 400 and our leaders see this kind things con carry eyes as if nothing dey happen in the country.
But all this thing na because dem no care about the citizens dem always dey worry about their own problems, we too dey suffer for fuel matter.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Is it that Nigeria as a country could not build new functional refineries from the scratch, let alone not have the capacity to revitalize the old ones? This always baffles me, and I hope God will deliver us one day.

One problem Nigeria get as a country na we no sabi maintenance, the building no be problem but how maintenance go be and the major reason for this na because we no get continuous government. Every government wan create their own legacy wey go help them contest for the next election so instead of focusing on maintaining wat we already have, dem go abandon am go build their own wey we fit no even need.

Oya see our teaching hospitals them and other government buildings wey dey available, na so so unkempt wey all of them dey now if them build this refinery who go look after am. Personally I think the government should privatized the whole refining l industry make companies come in come make things easier and make dem pass law wey go prevent demselves or relatives to get involvement (but dem no go gree). The government is too corrupt to be incharge of the refinery instead dem fit they regulate am but make dem allow private industry take charge to see how the thing go play out.
hero member
Activity: 644
Merit: 592
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
It's a pity that a country blessed with crude oil could be facing the situation we found ourselves in Nigeria with regard to the fuel of all classes. Particularly, the petrol as @CryptopreneurBrainboss put the figure at N215+ per litre, but specifically in my neighbourhood, the private stations are selling it at N300 per litre. This is preposterous! It started like a play with a country that is being ruled by corrupt and selfish leaders. I don't know what happened to our refineries that no one is talking about it.

Is it that Nigeria as a country could not build new functional refineries from the scratch, let alone not have the capacity to revitalize the old ones? This always baffles me, and I hope God will deliver us one day.
hero member
Activity: 854
Merit: 1246
Vave.com - Crypto Casino
Fuel scarcity is purposely caused by di Nigerians bourgeoisie (capitalists) join with di politicians. Can imagine di conconbility day, Dangote  fuel refinery dat dey were saying dat will reduce fuel scarcity 4 di kwantri, nd wen finally Dangote finished di refinery na out kwantri im dey carry im fuel dey go sell. Dangote fuel e no dey sell in 9ja. But nai imported fuel nai we still dey buy. Nd all dis things wey dey happened like dis, the leaders no fit do anything to help di matter, bcos di bourgeoisie e dey more stronger Dan di kwantri leaders. Bcos na dis capitalists nai dey select who go become di leader in di kwantri
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
Anything wey concern fuel, crude oil etc for this Nigeria na serious business to strong Abuja politics wey dey milk on our national treasury.
Nigerian leaders no get better conscience. If you begin trace matter from subsidy removal issues, if go understand how far dem don play us for this country.
E get when I bin read say Government don give oil dealers 48hrs to fix the scarcity problem. How far?
Pages:
Jump to: