1, coming from a rich family: Today we come dey see am like say hard work come be poor man doings rich man pikin go reason say my family hold wetin I wan go learn work for abi that one no be stress for me.
Coming from a rich family no be excuse for no hustling or learning a skill. Wetting they cause that thing na the rich people always dey pamper there children say them no want make them suffer afteral them don make enough money so wetting be the need of too much hutle. And indirectly making the child to be lazy, forgetting say if there children no Start from from scratch say even the wealth wey dem dey keep for them, dem go miss use am because them never make #50k on there own before, and Naim they make many companies fold after the death of the owner. Because of mismanagement but apart from that I don see many rich kid wey no depend on there parent wealth but still make am for Life.
2, poor background:Yes poor background too fit hinder person from hand work for our country now wen things cost pass as we dey see am how poor person wan take cope with registration buying of materials for work and others.
Poor background no fit hinder person from success or learning a skill. Infact the poverty family wey you come from naim go give you the motivation to learn a skill. Sometimes no be every skill wey person dey spend money to learn. Like now as a guy, your friend dey into tyling or painting or of house. you fit take am out as guy man wey you be buy am bear, tell am say guy help me! we be friends abeg I wan learn your skill Make I take help my family, him go consider you. But before that you must keep of some kind characters, like
1.
Pride : because some of us dey always like to show say we be friends and your friend no go fit send you message as a boss and you dey rub shoulder with person wey dey teach You work. So e better make you keep pride for house otherwise you no go fit meet up your target.
2.
Humble and humility: for you to be successful in learning a skill be humble sothat the person wey dey teach you work gk bring out him mind to teach you wetting e dey Hide for you otherwise you fit stay 5 years without learning anything.
3.
Dedication and smartness: smartness no be to shine eye, rather to bring your mind say you wan learn work and bring the very best in you. Many are called but few are chosen and if you no bring your mind you fit still no learn the work.
4.
Creativity: above all Creativity Naim be most thing wey dey hinder most of us. Stop to dey copy rather try to do your own thing in another dimension and see if e dey worthy of people to like am. When I been learn piping work no be the way my oga teach me wey I been dey do I try to be creative and people come dey like my work even pass my oga work, no be say na pride o but with that creative when you don serve your boss come start on your own, na work go dey find you.
But wen we look am for another angle how you see am wen be say person learn work for like 6-7 years you graduate but no get the money to open ur own to be on your own? .
Sometimes no be every work wey you learn wey you go save money to start work. And morover a learning place is not a saving place rather a place to gather skill find the job you learn and when money don dey come you start up your own business and start saving.