Pages:
Author

Topic: Help Your Brodas/Sistas Stand Strong!!! - page 2. (Read 331 times)

member
Activity: 826
Merit: 30
July 19, 2023, 11:52:06 AM
#4
That is how the forum works,  so you can't try to use emotional blackmail to influence anyone's decision here and not because we are members of the same local board you do wrong something you won't expect a correction from other 9ja forum members.

Wetin happen na? Abeg make person gist me too cus e be like say I don miss. If person fuck up for outside we go try rescue am if possible and con change am for him here because hand no dey smell make dem cut am comot. For my side here if our person dey fight for outside we go join fight finish before we go con even ask wetin bring the fight but Forum dey different from outside world.

I go like advice make we all dey careful for larger community to avoid anything wey go bring issue like this sef. Our politicians Don give us bad image for outside already make we no justify am here biko.
hero member
Activity: 1260
Merit: 765
Top Crypto Casino
July 19, 2023, 11:25:20 AM
#3
I no know how this topic go take ginger us for this our community but all I dey try talk be say make we as Naija ninjas wey we be make we try any how e be to always look out for each other. E no go make sense if we see for anywhere for this forum wey them dey use mouth take white wash our brodas and sistas for this community we go con follow too go dey bad mouth dem join, e better no to even talk self. We suppose look out for each other, I know say for every disciple wey chineke get one bad egg dey inside, make nobody carry our matter go yarn for back yard oh. Why I reason una this matter nah because of wetin I see for this Forum, the battle wey dey go on for one thread like that, them dey use words wey no healthy at all, and I feel say we suppose avoid that kind for here.

Make we stand strong for Us, make nobody go do back bitting because you wan become OGA or MADAM for this Forum.
This is Bitcoin community so at that local board community is still part of the larger bitcointalk community so for that your suggestions say make fellow Nigeria no put mouth for waiting for others dey talk no go work,  just as the first comment suggested Naija local board members both newbie and old members should first of all work on themselves before making any comment that will bring public backlash to them,  because all members of bitcoin
talk have an equal right to make whatever contributions and on whatever thread they want,  is either you develop a thick skin to withstand criticism and being smart enough to take positive criticism to help you grow and also look away from negative criticisms.

That is how the forum works,  so you can't try to use emotional blackmail to influence anyone's decision here and not because we are members of the same local board you do wrong something you won't expect a correction from other 9ja forum members.

This is not the first time someone is saying something similar to this,  because I can still remember when one guy was reporting ChalseTM that he always counters him,  meanwhile, Charles was only pointing out his error,  so let that mentality be changed,  this is the cryptocurrency industry and location doesn't mean much because no one cares or have access to your privacy unless the one you allow.

hero member
Activity: 798
Merit: 702
July 19, 2023, 10:54:32 AM
#2
Make Newbies and other members first start 2 dy do d right thing first make eh remain for others to follow, no be wen newbies go enter the forum come wan start to spoil the reputation if the 9ja people, u no go expect ur follow 9ja piple 2 com dy defend the Pesin 4 that kind matter. Here way we dy I believe say we dy help 1 another even if the help no big like that 4 some piple eye, but at least I dy see am say we dy try for here.

Me personally d time way SatoPrincess been report my post wen I been dy come up 4 diz forum 4 Plagiarism, dat time I been dy feel say d user do me bad thing base on say in suppose protect me try call me to other, tinx like that, but as time dy go, I realize say watin she do self help me well well realize and learn 4rm my mistake, way be say den I been dy wan try to make any kind post collect small merit support myself, way mke me go search for internet about something as I see the information I rush carry my brain rephrase am like say nah me write am instead of me to give credit to where I been get the original work from. Now I don learn from am say something like they no good, and eh better say our own people either call us to other when dem see bad thing or if means no dy make dem be d 1 to call 4 attention, make other way dy the forum no come dy feel like say we 4 our local board we dy purposely dy harbour some kind Spam post or anything way relate to am.

I don also see for where dem call on 1 of our person, and some of our snr oga 4rm here come out come pled 4 d Pesin, case like that day, wen something way no right dy happen even who no from ur local fit support u, but for matter way d obvious say the person really don commit, ur locals go either pass behave like say dem no see am, or dem go join hand for the case Weller, no body go use bcuz of 1 newbie way no wan learn go spoil on own reputation.
member
Activity: 200
Merit: 27
July 19, 2023, 12:31:47 AM
#1

Jump to: