Author

Topic: History of najia local board (how e Tay start) (Read 10645 times)

?
Activity: -
Merit: -
December 28, 2024, 03:57:36 PM
#31
Compliment of the season to my big men in this forum, i know i joined this thread late but i putting in my best to active, talking about the history of naija local board, i really appreciate all the big oga them that  have fault for the unity of this great naija local borad and I'm very happy to be member of this forum, at least i have able to peruse on history and i gotten what i needed.
member
Activity: 290
Merit: 31
Yes oo, this kine thread na im beta pass. First of all na you, OP na im I go first thank, for doing this very long research and bringing this one to our knowledge. True true, naija no dey carry last. As I been dey read the thread, I see the stats record of our naija threads, as una where been dey that time take raise am from 82 to 348 within a short period because of una zeal. I for like learn a ring or two from una.

@Igehh, @Charle-Tim, @Mpamaegbu, @CryptopreneurBrainboss , I greet all of una. Una try no be small. You too do well for us, and we dey enjoy the benefits. Thank you, for your hard work. I too get joy for all of una. Including the ones were contribute that time weh we no see una names, the unsung heroes them, na una try pass for your little little efforts. We appreciate all of una, for your doings.

At least, no nobody fit talk say them no know how una take fight for us, as this thread go dey here as reminder to us weh dey, and to those weh dey come. Thank you.

Abeg very little question sha....The fight for other African countries don start ? Abii make we still dey enjoy out own dey go first ?   
jr. member
Activity: 51
Merit: 1
Naija get Men Oo, Woow, we Love Ourselves no be lie See as the Strength in Unity dey Pay-off for Us... Other Countries seriously wish they were like Us Oo.

God Bless All our Heroes Dem wey fight stand ground for Us and Hatchy too much for bringing this up for Us. Thank You.
full member
Activity: 182
Merit: 131
RATING:⭐⭐⭐⭐⭐
Omo, Since I join this forum, na today I just dey take time to read through this and I go confess say Hatchy really do justice to the thread, the tgread captivate me from the begining till the last word and I really enjoyed reading about how our senior men them for we Naija local board fight really hard to make sure them clear the yamayama perspective wey other people don get about us, I just dey imagine how hard and difficult that must've been, because inasmuch as Hatchy did justice to the thread, i know very well say e go get some notable things/efforts from we Boss them wey e go don forget or omit, or no even dey aware of.

True true no be small sacrifice Una don make for us to clear our reputation, come still press on to make them create this local board for us, e no end there, come still go as far as pressing more button to make them give sub boards for inside we local board, Una well done, I throway salute for all of Una.
Because I remember when I first joined this forum on July 13, 2022, we been never get any local board that time, wetin been dey that time na the Africans Hangout Thread, back then I never really know how far for the forum, I never really understand the dynamics of the forum back then.

But today, many of us here dey enjoy the benefits of this local board, thanks to all our senior men them wey put body to make sure the dreams of Naija gaining recognition on the forum come to pass, e just be like back then when some top men for we country also put body to make sure our country go gain her independence and dey free from the rulership of the oyibo people. We the Naija people appreciate Una efforts and sacrifices, and now e dey left for everyone is to maintain the good reputation Una don give we country for this community.

E go good make all of (especially the new people wey dey join the forum) try out best to adhere to the rules and to no do anything wey go jeopardize the good example wey our Senior men for here to keep. I go say make God bless Una, and make Una dey continue to dey do Una good works for this our local board, true true, Una be leaders and make God bless Una for us.
full member
Activity: 462
Merit: 136
EVO.io
OG wey no dey gree leave alcohol, nobody everytime wey wind blow wey foul nyash dey open oooo. The bastard wey carry you and Pokapoka mata come Meta that year still dey active for the forum? I remember how we shake everywhere.  Grin
Who dey breeet! I remember dat ur shout that year. Mehn! Engineer, nor be small matta dat period but we sha thank God how d whole thing later went. E don tey wey I even run into Pokapoka sef. Abi d dude don join football academy com leave cryptos?

On the alcohol part, na Rivers clique here still be champion. If I lie, ask...read more

Meh Pokapoka was never the same after the incident, before Dem arrange him matter finish person don already take him slot for the campaign but as the name wey hot that period him come dey run one mixer join so, felt too relaxed. Na so him steeze too come finish. He's not longer active here but you go always see am for campaign applications thread.

The forum life be like Ogboni, if you join, you no mingle with the right cartel even POS operator go get money pass you.

First of all I wanna thank CryptoprenuerBrainbos and Mpamaegbu for making this place possible regardless, I mean this board is happening. E get waiting our Moderator talk wey I don see so much sense inside, e get some people wey dey bring for this community and because they have been introduced they feel like they have arrived, they feel like they can do without the person that introduced them here. Time will come when they will run back for advise and help because they are yet to arrived. My advise to some people be say no take because say you be graduate and person wey introduce you here no be graduate come dey feel say you go well for this place pass am that one dey sha but note this place is not a school were you can at smart person, always ensure to follow someone that brought you here e get why.
member
Activity: 108
Merit: 39
You do really well @Hatchy for creating this thread because I've been wondering how manage wey naija take get their local board whereas e get some country wey I feel say dey strong pass naija globally never get their own local board (it sure feels good to be a Nigerian, the giant of Africa) if no be for the strong head of our senior men Dem wey fight this fight come win am last last, I throwaway salute to una because na una clear road for us to enjoy this forum like this so. Because of this victory I know say this oyibos Dem dey respect us on a low-key because e no dey easy naa and I'm hoping to see an updated thread about the history of our local board in the next ten years, Naija to the world.
sr. member
Activity: 560
Merit: 265
Hatchy, I thruway salute for diz very informative thread wey you create so.

From the time wey this world start historical writings has been a part of us. Because if person no write and document about our history we fit forget and lose our identity or take the advantage wey we dey enjoy for granted.

As i dey read this history, e just be like say I dey read about the founding fathers of Nigeria, wey fight for our freedom from the British empire.

And from then  wey CryptopreneurBrainboss create the Naija thread as you write for the history up till now, I don see the kind progress wey we don make for the forum. Three of which be say

  • We don manage change the orientation of dem oyibo say Naija people na scammers
  • We don also make dem see say for the forum na we, naija people be one of the hardest working and fastest group of all local boards.
  • We don also make dem see say our contribution to the forum dey very important and dem nor fit ignore am.  
member
Activity: 225
Merit: 64
Actually this thread Dom really sweet me for body to read. Sometimes I feel very proud when I see say we naija get where we fit feel free to discuss our own things the way we like and write for our own local language wey Dem call am ( pidgin ) really if no be this local board many for fit no go this far sef, with this our own naija board we fit dey drop the small small English wey we ourself fit understand wey be say we no really need to enter search engines everytime to know wetin something mean before we fit understand.

And the moral lesson when I learn from those heroes wey fight for the local board na say make we always remember our own make we think the future and use our opportunity to create something tangible wey others fit benefit from like this see as their name Dom write for world something kudos for their great intelligence to remember their brothers.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Enjoy 500% bonus + 70 FS
Snip
Op you really tried for the arrangement of everything here but I didn't see this thread https://bitcointalksearch.org/topic/proposal-for-naija-nigeria-lb-sub-boards-creation-5473185 which was di last request for the creation of di local Moderator and more merit sources. So it is good add am because dat e make sense and help to facilitate di bringing of the Moderator and the additional merit source. We really appreciate all di brave men and women in di local board. Your requests have been granted and everything now e dey work well/$moothly. God bless all of you guys Amen.
hero member
Activity: 1022
Merit: 625
Watch&Pray.
My sincere gratitude to Brainboss, Igebotz, mpamaegbu, Lordhermes and the rest that fought from day one until it become reality today, my sincere gratitude to Thelmos too for granting us our request. Well done.

You are indeed a very good reader for taking out time to observe and come up with the names you mentioned here because from your profile you're just one month old in the forum and you already have an idea of how the Nigerian Local Board came to existence and the names that started pushing for it. If really you are a beginner as said by your profile then I think you're going to do very well with research and come up with other useful information that will be beneficial to the forum and the Nigerian Local Board.
member
Activity: 77
Merit: 49
Omo, op really take time to arrange this thread, cudos to him, e no easy to post thread like this one, you really dig out how it all started and the information needed to make it easy for the newbies to understand the process how it all emerge to this point today.

My sincere gratitude to Brainboss, Igebotz, mpamaegbu, Lordhermes and the rest that fought from day one until it become reality today, my sincere gratitude to Thelmos too for granting us our request. Well done.
member
Activity: 182
Merit: 33
This is just so incredible and got me really speechless. Indeed, there is always a story before any glory. Look at us now coming from behind to enjoy the labour and effort our people had to go through just to secure a spot for us on the forum and here we are with not just a local board but one of the most active board we have on the forum.

Weldone, our great heroes!
You've all set the foundation and made the sacrifice that has paved way for us on the forum and we can't applaud you enough.

Now I understand why it bothers most of our senior men on the board when a member of our local board goes to the English board to create an irrelevant thread that speaks bad of our local board reputation.

Thanks boss @hatchy for doing this great work in compiling and structuring this piece in this manner. This should be a must read for all Nija newbies that are joining the forum and it will serve as a great encouragement to all of us to know that we have a voice and people in the global Bitcoin community.
@Marvelockg you just speak my mind,  the great men that fought for this local board, should be proud of themselves to see their dream been actualized,nothing sweet pass say you dey alive see say ur dream come to reality.

And if them maintain the unity among themselves,  greater things go reach this board, make disagreement cause issues among them, make them know say the hope of all newbies dey on them. I knw sat them no go disappoint.
sr. member
Activity: 392
Merit: 277
This is just so incredible and got me really speechless. Indeed, there is always a story before any glory. Look at us now coming from behind to enjoy the labour and effort our people had to go through just to secure a spot for us on the forum and here we are with not just a local board but one of the most active board we have on the forum.

Weldone, our great heroes!
You've all set the foundation and made the sacrifice that has paved way for us on the forum and we can't applaud you enough.

Now I understand why it bothers most of our senior men on the board when a member of our local board goes to the English board to create an irrelevant thread that speaks bad of our local board reputation.

Thanks boss @hatchy for doing this great work in compiling and structuring this piece in this manner. This should be a must read for all Nija newbies that are joining the forum and it will serve as a great encouragement to all of us to know that we have a voice and people in the global Bitcoin community.
sr. member
Activity: 392
Merit: 316
I really thank the op for the wonderful effort wey him put to for the thread and I also want to thank all of our freedom fighters who has made all of this a reality, when I joined the forum and found out that we have our own local board it boost my confidence and am so happy to be a member of this honorable house Nija local baord which has motivated me to write this note.
  
### No Place Like Home

For this life, no place fit be like home. No matter how you waka, your home go always be special.

Lastly, no place like home because of Di love for home dey genuine and strong.

So, no matter the boards you waka go, no forget say no place dey like home. Na there your heart dey  home go always be di best place for you.

Nija Local board na our home
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
~
The forum life be like Ogboni, if you join, you no mingle with the right cartel even POS operator go get money pass you.
Na true you yarn there!
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
OG wey no dey gree leave alcohol, nobody everytime wey wind blow wey foul nyash dey open oooo. The bastard wey carry you and Pokapoka mata come Meta that year still dey active for the forum? I remember how we shake everywhere.  Grin
Who dey breeet! I remember dat ur shout that year. Mehn! Engineer, nor be small matta dat period but we sha thank God how d whole thing later went. E don tey wey I even run into Pokapoka sef. Abi d dude don join football academy com leave cryptos?

On the alcohol part, na Rivers clique here still be champion. If I lie, ask...read more

Meh Pokapoka was never the same after the incident, before Dem arrange him matter finish person don already take him slot for the campaign but as the name wey hot that period him come dey run one mixer join so, felt too relaxed. Na so him steeze too come finish. He's not longer active here but you go always see am for campaign applications thread.

The forum life be like Ogboni, if you join, you no mingle with the right cartel even POS operator go get money pass you.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
OG wey no dey gree leave alcohol, nobody everytime wey wind blow wey foul nyash dey open oooo. The bastard wey carry you and Pokapoka mata come Meta that year still dey active for the forum? I remember how we shake everywhere.  Grin
Who dey breeet! I remember dat ur shout that year. Mehn! Engineer, nor be small matta dat period but we sha thank God how d whole thing later went. E don tey wey I even run into Pokapoka sef. Abi d dude don join football academy com leave cryptos?

On the alcohol part, na Rivers clique here still be champion. If I lie, ask...read more
member
Activity: 182
Merit: 33
Although the thread wasn't necessary as we're barely a year old but I appreciate the effort put into creating the thread. Maybe if this thread been dey come out in our 5 years or 10 years anniversary na when I got see more importance to the thread but anyhow sha kudos for reminding us where we started from. This fight no start as Nigeria fight but as Africa and threads like this (No African local board) na wetin open our eyes to the struggle. Mpamaegbu come bring the appeal for a Nigerian board, dat time I dey full member and many of the OGs here still dey very lower rank. I remember because na when I reach Snr member wey I create that hangout thread and then we had a place to brings heads together and got what we have today.

If anybody here has to take credit na Mpamaegbu as na him open our eyes we come dey come together as one family and today we dun big like this. We still dey grow sha and small small we go get a bigger board wey go dey compete with the other boards but to do that we need more quality posters and as we dey post make we no only dey run am say we want complete weekly quota but to add quality to the board so anytime wey we request for anything them no go waste time approve am for us.

We dun try for ourselves and we go continue they push forward, all those bigger boards una dey see so, e take dem time to build am to where e dey so make we no dey rush our own. Small small we go get everything. Theymos get how him dey do e things, just requesting won't give us what we want but strategic planning go give us am.
@brainboss you sef Don try, you deserve accolade too, mk God bless una wey fight for the local board to come to limelight. E no easy say out of all Africa countries na Naija first get local board,  e show say una wey be big shoes for the board they represent wella. Naija no go carry last, we go make una too happy for this local board, as you don talk am, we go try make we dey creative post and thread to push the local board forward,  our population go help us achieve everything una want. I say make I join mouth hail una too.
hero member
Activity: 1260
Merit: 765
Top Crypto Casino
We dun try for ourselves and we go continue they push forward, all those bigger boards una dey see so, e take dem time to build am to where e dey so make we no dey rush our own. Small small we go get everything. Theymos get how him dey do e things, just requesting won't give us what we want but strategic planning go give us am.
For sure we don try for ourselves for this localboard activities and pursuit as as you talk am slow and steady win the race and at this point we are going to remain consistent pursuit in building this community and as you said e make sense make we bring up such celebrations when we go do our anniversary, 5 years and 10 years anniversary too make sense at least by then alot of things go done change and we go done get clear compass as for we're we dey and how we go move forward from that point,although we have done extremely well in this short time,  but there is still more to be done that only time can say.

So we go wait and also keep putting everything in order to position our localmore in the limelight, and all thanks to other forum members for the love and support they have shown to the naija community on the bitcointalk forum infact some time I use to think that we are the most loved community around here,considering how we started and were we are presently.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
I had no idea there was so much history; the struggle seemed like yesterday, but it's been almost two years and there have already been some amazing events. I've been hunting for that translation for a long time because I saw someone produced the same translation last year. I believed I did more than one translation that year, but I don't remember anything anymore. I stopped since the nature of the thread at the time made it inconvenient for other people.

OP you ommited our local board rules.... History  Grin thanks.

Chai! I nearly typed disclaimer just now on top this thread sey you mis-tagged me instead of Brainboss for dat topic. I nor even remember startin dat topic again oh, at all. How time flies. You know dat thing dey sey about d internet not forgetting, ba? Dat's why e nor good to naked baff outside.

OG wey no dey gree leave alcohol, nobody everytime wey wind blow wey foul nyash dey open oooo. The bastard wey carry you and Pokapoka mata come Meta that year still dey active for the forum? I remember how we shake everywhere.  Grin
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
I don update our local board history with the new dates wey Dem give us Localboard moderator and the subboard creation date. so far we dey happy well well as our Localboard don dey do well sofar and come look presentable. Una do well, Igebotz and all our members wey dey make quality post for we local board and present us well outside main board.

legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Although the thread wasn't necessary as we're barely a year old but I appreciate the effort put into creating the thread. Maybe if this thread been dey come out in our 5 years or 10 years anniversary na when I got see more importance to the thread but anyhow sha kudos for reminding us where we started from. This fight no start as Nigeria fight but as Africa and threads like this (No African local board) na wetin open our eyes to the struggle. Mpamaegbu come bring the appeal for a Nigerian board, dat time I dey full member and many of the OGs here still dey very lower rank. I remember because na when I reach Snr member wey I create that hangout thread and then we had a place to brings heads together and got what we have today.

If anybody here has to take credit na Mpamaegbu as na him open our eyes we come dey come together as one family and today we dun big like this. We still dey grow sha and small small we go get a bigger board wey go dey compete with the other boards but to do that we need more quality posters and as we dey post make we no only dey run am say we want complete weekly quota but to add quality to the board so anytime wey we request for anything them no go waste time approve am for us.

We dun try for ourselves and we go continue they push forward, all those bigger boards una dey see so, e take dem time to build am to where e dey so make we no dey rush our own. Small small we go get everything. Theymos get how him dey do e things, just requesting won't give us what we want but strategic planning go give us am.
hero member
Activity: 798
Merit: 702
~snip~

Thank u say u try recognize some of us for here, we they stand when necessary, well make I just talk for my self, if I see were person hand clean for my own view I they try with Watin I understand to put people for that area way dem fit see say the person no really they as bad as dem think say eh dy, but for case way be say the person don use him own hand scatter everything nah just to leave the case mke the person suffer him faith.

Watin I they try talk be say even if onah get who they help defend onah outside, eh no mean say onah no go bring head down nothing good pass were person fit just they avoid trouble any way possible way u fit avoid am no fall law, becuz if u break the forum law even your own lawyer fit they against you cuz eh get as eh go follow the case him own head fit enter and that law license dem fit take am from am, for here we love ourself no matter the attack nah just to put things for the local board in other eh no pass so.
sr. member
Activity: 420
Merit: 253
I commend all those our senior men them wey stand strong for us to achieve this our local board Una try well well o because I just dey wonder how the newbies them for do had it been say we no come get our own local board as in be say Dem never get any much experience like that but as we come get this local board, e come be like say e relief almost every body wey from Nigeria wey dey this forum because we dey interact with each other well and imagine some threads wey some of our members here carry come local board to advice us and also to correct some of us wey dey go wrong direction like for example the thread wey @adbitco create Abeg make we mind wetin we go talk for english board to avoid problems and also the one wey our senior man wey be @Agbe create U don Plagiarist ursef and Follow Instructions to Avoid Deleting of Application. and so many others so if we no get local board how we for take dey give ourselves advice Dem like dis and our local board really help to unite some of us outside this forum so to all of una wey make this our local board be like this we dey celebrate all of una and I also commend una doggedness to dey protect una brothers for reputation board, people like @legendary Charles-tim and Nwada001 and some other people wey I never recognize, I dey see una hand for reputation board na una be our lawyers wey we get for our local board make una still continue d good work o, together all of us go change the bad name wey some of our youths wey go involve themselves for things wey no good come give every body bad name but wit time you and I will change that narrative. Una well-done o
sr. member
Activity: 504
Merit: 300
WOLFBET.COM - Exclusive VIP Rewards
This na good start my guy, as e be say me na new person for this forum, I just come as Jonny just come, so I ne really get the full detail about this forum qnd the history of this forum bur thnaks to you as yiu come tell me/us small way you Sabi.
You try to update us th
is mata because no he everybody way dey here na Sabi part of the history for this place.
A very big shout-out to the heros on our local board for the good works they did to make sure that this our board is in existence today, it wasn't an easy mission to accomplish.
sr. member
Activity: 504
Merit: 389
The great city of God 🔥
Respect to our Heros who don make out there Time to make sure say this we naija local board stand today e no easy. Piking wey dem carry for back no no say journey far. And also Piking wey dem born to a wealthy family no no how much be bag of cement, or no even know how e Papa carry build Empire wey him dey enjoy.

Shout out to all of our naija Ninjas wey don fight for wetting we dey enjoy today. All My oga them @crytopreneurbrainboss @charls-Tim @Agbe @Mpamaegbu @Igebotz @Upgrade00 and to you @ satoprincess your donation or charity to people also bring attractions of Goodluck to us. may God bless you also to @brainboss for the covid19 disbursement of food, also to @Agbe for the introduction of bitcoin to students with laptop for study. Ona really try. if this forum they put calendar of the past Heros like Nigeria past Heros, we for don paste am here sothat any newbie wey dey come here sopos no the people wey dey dey follow chat say no be just any how people.

I respect ona, and the memory of wetting ona don do go always dey in our heart's. If not for ona how we fit dey enjoy benefits wey we dey get here? Now people dey push enter the forum almost every day dey creat thread up and down not knowing say the privilege na people bring the idea. once again I thank you all for your efforts. Thanks to you @Hatchy, for compiling this for people to know the origin of everything, because e dey give honour to those wey participate in making something a success. Thanks to @mia Chloe for bringing up the latest art contest too, because na those things go dey make here lovely and lively and with our talent we dey showcase for here go make the international people for the forum to change there perspective about us. and them go see a better part of us no be the negative side. I see say those men dey visit 9ja local board more often than other board that is to say them dey highly impressed with wetting we dey do. And our negative tag don dey comot. Ona Weldon.
hero member
Activity: 2212
Merit: 805
🌀 Cosmic Casino
I got the notification about the mention in this thread. It's nostalgic and I like it. Kudos to you @Hatchy for a trip down to memory lane. The journey to getting this local board is a continuous one. Although only a few members started to journey, we now have a community backing the movement which is a big plus. A big thank you to members wey been go above and beyond to request and fight for the interest of the community. At this rate, we go soon get separate as per the request made in local board.

To all new members joining the community, you're welcome  Smiley
hero member
Activity: 448
Merit: 560
Mia's Creative
Wow!!! I am so pleased and surprised to have seen this thread. Although my little time on our Naija local board I didn't know so much about our board. However with the help of this thread I have been able to understand and know many new things about how Naija board really started.

I wan sti use dis medium take thank our bosses Dem 4 d effort way dem put to make sure say Naija board get head. I wan sti Thank Hatchy way e tay put dis thread together. Abeg ee shout out to Naija board we 2 much .Naija no de carry last true true.
sr. member
Activity: 700
Merit: 470
Hope Jeremiah 17vs7
So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note.
Chai! I nearly typed disclaimer just now on top this thread sey you mis-tagged me instead of Brainboss for dat topic. I nor even remember startin dat topic again oh, at all. How time flies. You know dat thing dey sey about d internet not forgetting, ba? Dat's why e nor good to naked baff outside.

Na true, dat time nor be small gbege we face because naija been get serious bad image everywhere and d senior men before us nor too get d strength of disproving d bad image wey owa leaders dem put us into. Anyway, we thank God for where we don reach today for the LB matter.

Nice wan, OP. I for pour you beta colele wata but sadly na only wan bottle dey my fridge now.

Shout out to all men in da house! Happy New Year to all of una.
Mpamaegbu and CryptopreneurBrainboss God bless both of you and everyone who supported you guys especially those who supported in the Africa Bitcointalk community hangout signature campaign, Omo even our great grandfather Jet Cash supported us. Thanks to Charles Tim and Igebotz who later joined the fight God bless you all and every of our local members. May Becky666 continue to rest in peace.

Seeing all these donations by CryptopreneurBrainboss, Satoprincess and Agbe would have suggested we continue that Christmas donations especially now when economy are this bad.
legendary
Activity: 2716
Merit: 1225
Once a man, twice a child!
So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note.
Chai! I nearly typed disclaimer just now on top this thread sey you mis-tagged me instead of Brainboss for dat topic. I nor even remember startin dat topic again oh, at all. How time flies. You know dat thing dey sey about d internet not forgetting, ba? Dat's why e nor good to naked baff outside.

Na true, dat time nor be small gbege we face because naija been get serious bad image everywhere and d senior men before us nor too get d strength of disproving d bad image wey owa leaders dem put us into. Anyway, we thank God for where we don reach today for the LB matter.

Nice wan, OP. I for pour you beta colele wata but sadly na only wan bottle dey my fridge now.

Shout out to all men in da house! Happy New Year to all of una.
sr. member
Activity: 336
Merit: 365
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID
My People, Una weldone o. If una see the joy wey I dey get like dis so, una no go believe as I be like person wey don chop overfeeding. Well as Una see the title, history of nija local board. I just dey reason am say as many new naija board members dey enter forum, Dem suppose still know small history of how our oga Dem take fight their way till we finally got our own local board last year. Yes last year so we are actually just 1 year old. Hurray nija board members although I wasn't here at that time, but I'm grateful to be a member of this wonderful forum. And so far nija board has shown many impressive statistics in d past few months and we are happy to be amongst d most active local boards of d forum. Thanks to many of our new members and oga Dem wey dey do all their best to make sure say the local board dey clean and much more interesting than when it was just a single thread. Well enough of the talking, follow me through this short history of naija board and be amazed, just as I dey when I dey compildis thread. Like dis now, we don show say really, we Nigerians no dey carry last.

In d early days of the forum, when Bitcointalk nova dey popular as e dey now for we country, our old oga Dem find Dem way to dis ogbonge forum. And having being an African, a Nigerian, all of dey do very well here for BitcoinTalk. Dem really represent us d Africans very well, con create better reputations for inside dis forum. So far, some early men Come see say e go make more sense, if Nigeria get Dem own local board.

So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note. Dis request was shocking and other men for naji wey see say d idea make sense come support d thread well. Dem hold ground with our oyibo men Dem. If you read through d thread you go see how many people Dem use mouth take finish our people Dem but Dem no gree. Sha Dem no grant d request dat time,but other many top oga con suggest say since na d first request, e go better make we first create something like a local language thread first. Dis idea na to calculate d amount of active members wey dey we country before Dem go fit reason to give us we Localboard.

With so many suggestions, on d 17 of march, 2019 oga CryptopreneurBrainboss come create de African bitcointalk community hangout thread. Dis name wey he give am, na to give way for other countries Dem wey dey Africa to tay take part for d discussion thread.

Images of old African community thread:

To bring awareness about d Africa Bitcointalk community hangout thread, @CryptopreneurBrainboss come reason am say e go make sense to start a signature campaign. Dis campaign na to take show other African people Dem wey no dey aware of d thread to no about am and join d discussion. Dis was how d Africa Bitcointalk community hangout signature campaign was created.D campaign dey for both paid and free volunteer signature dem. other members of d forum like and appreciate d idea wey brainboss boss bring and some con help create signatures and avatar even personnal text for dis campaign to take start.

Some of the early avatar : created by cabalism13

D signatures for d campaign: created by @ Heisenberg_Hunter

Quote
Member rank
▬▬▬▬▬      BITCOINS - AFRICA      ▬▬▬▬▬
There's a thread dedicated for Africans to hangout and discuss general issue and issue relating to blockchain development in Africa.
▬▬ Join Africa Bitcointalk signature campaign ▬▬

Full member

Senior members and above

░░░░░░░▄▄▄▄▄▄
░░░░▄██████████▄
░░░██████████████
░░██████▐▌██████
█████░░░░░░░▀█████
██████▄▄░░▄▄░░██████
████████░░▀▀▄██████
████████░░▄▄▄░░█████
██████▀▀░░▀▀▀░░█████
█████░░░░░░░░█████
░░██████▐▌██████
░░░██████████████
░░░░▀██████████▀
░░░░░░░▀▀▀▀▀▀
░░░
Jump to:
© 2020, Bitcointalksearch.org