Pages:
Author

Topic: Abeg make we mind wetin we go talk for english board to avoid problems (Read 350 times)

sr. member
Activity: 560
Merit: 418
From wetin I read, e fit be alt of person because e no sound like newbie from e tone.


Sometimes I dy wonda how come these Alt wey full here dy like do bad things more than things wey go make here grow.
Is like them know wetin fit spoil this our LB and them ready to do am without looking back. Me e no take me long to think am becos nah only person wey know d in and out of this Forum nai fit do this rubbish.  Nothing like I'm a newbie biko.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
The annoying thing about this user be say e no even open any thread for dis local board so at least e fit ask for pipo wey fo show am way if e no know wetin to tok! Chai, e really off me say e come indicate say BTT nah means of employment for youths for naija! What a falling of hands! We dey experience hardship for we contri but biko nah our own bad pass? I no just understand the motive of the user but nah people like this dey make me wish say person fit delete the post of another.
I don see that kind post before from oda members from different board. Although some of them dey talk how de forum don affect their life and how e don give dem a source of income based on say employment no too dey for their country. If naso the op take present that matter e for even try small, de nigga just write rubbish about him country and pipo. Even wen SC correct am, for him to lock up take correction, the nigga still dey brag say him dey earn 7 figures outside the forum, but same person don forget say him don post about quitting him job for Bitcointalk, as if Bitcointalk na job.

From wetin I read, e fit be alt of person because e no sound like newbie from e tone.
Very likely... me self don reason am.
newbie
Activity: 22
Merit: 4
Omo people dey ooo, I wonder why person go enter English board go dey make such a useless post. This user deserves a very hot slap. It's not proper to make such a derogatory post about we country. I don't know why some people behaves like goat. Them go tell una to go school una go say school na scam, now look at how the op is disgracing himself. My suggestion is that he should be go and delete the post. Someone who knows the op should pm him/her informing the person to delete the post immediately. Make we dey try get sense small. No be everything them go teach us for this life.

Wetin even make vex self na say him no gree take correction even as dem dey tell am him still dey argue join, this one na serious stupidity in a higher place. One wey understand here be say people no know how to create post to attract wetin dem want otherwise how him go just come here dey yan anyhow him like because him see say here na free place wey everybody fit come do as dem like for forum.
In fact, no be only slap him need na to just look for way limit am go even better pass why him no start from we local board to get orientation how him fit run role over here.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
The op no try for the post way in go make for English board on how this forum don help create employment for Naija youths. Na the person who carried him to this forum I blame because the person no guide am say this forum na where to gain knowledge about Bitcoin, to adopt the strategy in accumulating Bitcoin, and not where to earn money. The guy made it clear saying na Yahoo hustle our Naija youths be dey do before they discovered this forum and na this type of people they make why Nigerians no go freely register for here without paying a token for the account to be ready to use.

Bros no be this OP wey open that thread oh, nah another wrong man wey this current OP talk about.
And I no sure say person wey introduce Bitcointalk to that guy wey fall our hand , I no sure say the person just tell am about this Forum and leave am like that, him fit guide this guy but we all go agree say even as the guy tell am about this Forum, this guy go still do wetin dey em mind.
This thing nah personal decision becos wetin him type the person wey tell am about Bitcointalk no go dy dia to address him movement or choice of words, so I say this guy don carry our face clean ground without respect .
full member
Activity: 294
Merit: 168
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
The op no try for the post way in go make for English board on how this forum don help create employment for Naija youths. Na the person who carried him to this forum I blame because the person no guide am say this forum na where to gain knowledge about Bitcoin, to adopt the strategy in accumulating Bitcoin, and not where to earn money. The guy made it clear saying na Yahoo hustle our Naija youths be dey do before they discovered this forum and na this type of people they make why Nigerians no go freely register for here without paying a token for the account to be ready to use.
hero member
Activity: 574
Merit: 627
It’s funny on the kind of drama we meet here day by day, funny how our people no really they use their own tongue count their own teeth funny how the person way make that post just they some where cross leg they drink beer why eh they read all our post they call am rubbish funny how that person way make that post fit be say nah him alt account be that, eh fit be say the person just chop small money for campaign way eh just join for the forum and eh come make am feel say eh don arrive, small peanut eh no fit hold him joy instead him carry him self come eng board come showcase him talent way eh for they make use of for radio station.

When this person create this thread that very day, I read am even when eh just get small reply, I use my hand compose msg send for the OP for dem, even humble my self beg am to mind the mind thing way eh post as eh no go help him account reach any where at all at all, instead eh go make am feel like say nah either merit eh they beg and same time eh they rub portopotor for our face, but my G read my msg snub am still they debate for the same thread way eh create way I believe say no be just only me go don send am dm, so make I ask onah now if this person way they prove stubborn come later get issue for the forum one day we require our help him go expect people way been they talk to am way him they snub to come to him aid? Odikwapossible nah.

As I check the account never too day active since that day reach the last time I check am today, maybe eh don fulfill the mission for the day now eh don go back to him main account they chase him peanuts way they give am the Abi 6 figures way eh they brag about.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
Omor who be this one na, you just come board dey come talk anyhow, na WA for una oo, to be very serious wattin that guy fo back there no make sense at all, those wey dey bring people into this forum abeg make una try teach Dem about things wey supposed to dey anonymous and thing wey Dem go talk, you know wattin men dey do outside this forum wey just come dey talk like say na for this forum you wan take live life. All these newbies make una mind wattin una dey talk oo,  this na one of the reason why Dem dey hide update, but e go come be like say person wicked.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
Normally we no too supposed put eyes for op because we as we dey here like this e fit be say na only him or her find him way here and this na number one thing wey fit make am cap anyhow him like because I no sure say weda him know if we get local board because most of our people dey first put eye for this section before dem tuama go english board go showcase their talents but e no means say na to come open we ukwu for ijwe madu to see wetin dey inside.

So anyhow make we try go close to that person know how him or she dey do so that we self fit give am small OT wey him go carry run parole for fhis www.. although I don see how him take talk with authority for that thread meaning say him no even wan change or show sign of guiltiness say him don F for here, but anyhow make we commot body onto say here na no man's land meaning say: anything wey anybody do e dey for her head since dem no wan identify with the people wey dey here anytin wey happened him go collect I believe say e get some people wey get 3D eyes wey dey monitor people and if dem him turn em go answer query or dem knock him head him go sleep and never wake-up again.
sr. member
Activity: 462
Merit: 304
Op, I don go through the thread wey that user drop and I don see the feed backs wey em get even as you talk about am now I don see the response of our people to the post but i feel say we need to do more for our people.Even as I dey blame that user I feel say na person wey dey among us show am road for dis corner as the person for at least allow am gwt small akonuche before em create account for ram so f up dey also go to person wey help am enter rhis we corner.

Normal normal anybody way they bring person here suppose lecture am on things way they right and wrong but they thing there again be say, you don bring am in and no be all post way eh wan make eh fit carry show you first before eh go go make the post and you no go stay around am all the time to see Watin eh they post unless say you go gat get access to him account way you fit they run through the post view small small then you fit they delete some rubbish if you see any.

But on a normal how person even if them no tell am say Watin in wan do they wrong the person they chop food put for him nose ? Them no need even tell am about this things before eh go no say nah better slap to the face of their people be that Abi nah everything them they teach for school? Most of the things way most of us know today nah because we they use our own head they make some calculations if we they wait for people to always point somewhere for us all the time nah mistake go be our second name.

I no mean to insult the guy in question but as I go through the comment and how the guy carry they rap mouth about him achievement for their they self defend him self, eh obvious say the guy no ready take correction and their type fit even tell who bring them come here say them they feel say them be God make dem allow am do Watin in wan do, nah just part of life we no fit control everybody and some people behavior they make me feel like say no be every body deserve to get some kind information because them go misuse the information way you give them.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
Chai, nah only God knows why we no see the face of this person.
This one nah 1st class disgrace abeg. That user never post for this local board before and I believe say na one of us nai get that account, and na one of those ass licking people wey get for this local board, them ready to do anything make all those high ranked members wey dy outside to carry them along. Now see as this one don rubbish us, abi nah only we dy hustle for this Forum? Which kind unbeliever be this one nah...? This one pain me I no lie. Why him no say Bitcointalk dy create job opportunities for naija nah?
I no blame this left over wey do this thing, I blame some of us wey ready to sell out our own just to get that recognition. Some newbies no be newbie for this place.
hero member
Activity: 798
Merit: 547
Leo is resting.
Op, I don go through the thread wey that user drop and I don see the feed backs wey em get even as you talk about am now I don see the response of our people to the post but i feel say we need to do more for our people.Even as I dey blame that user I feel say na person wey dey among us show am road for dis corner as the person for at least allow am gwt small akonuche before em create account for ram so f up dey also go to person wey help am enter rhis we corner.

If you get students abeg try give dem good orientation, make dem dey seed you their write up first before dem post am e go help you notich things dem wey no make sense and you fit correct them and encourage them before sending it back to them, i hope say we no go see wetin i talk like insult but i feel say the person wey make that post no get good orientation and na person wey bring am enter here i go blame the person no do good work at all.
hero member
Activity: 784
Merit: 589
 The annoying thing about this user be say e no even open any thread for dis local board so at least e fit ask for pipo wey fo show am way if e no know wetin to tok! Chai, e really off me say e come indicate say BTT nah means of employment for youths for naija! What a falling of hands! We dey experience hardship for we contri but biko nah our own bad pass? I no just understand the motive of the user but nah people like this dey make me wish say person fit delete the post of another.
 From wetin I read, e fit be alt of person because e no sound like newbie from e tone but no mean say e come bring him sef down all in the mane of recognition nah Roll Eyes..biko, let's be guided abeg because dis other boards dey chook eye for where we dey and make we no dey give them reason to look down on us, biko.
full member
Activity: 364
Merit: 154
Lol everybody got their on motive  of joining this forum even though normally Shey nah that level make u join you for nor carry am go English board nah, normally nah falling hand sha if you still dey learn local board dey as a Nigerian to tey learn well nor be say u go, go other board go dey fall our hand. Before you post something mostly creating your topic try dey take your time do am research first b4 you come dey talk wetting nor follow you get even me seff den learn that is the aim of this forum to educate you concerning cryptoworld
member
Activity: 334
Merit: 27
I no wan talk much but anyhow una fit comment here make we reason the matter.

d truth be say, I no really blame d guy, na person wey introduce am enter forum na e I go blame. I sha know say e no even still be dat one fault o becos from waitin d guy talk for there, e show say d person be dey try help e life but I swear na wrong person e go help. Since I join dis forum. I don see so many yeye people but most of Dem dey learn and na dey make Dem grow. But dis one wan con dey form jadon for forum. E even dey boast say if to say Dem know who e be, Dem for no dey follow am talk.
 If dis guy see me for real life e fit run o. We no dey brag shit for forum no mean say we no know who we be. No be forum dey feed me or most naija persons for here and e suppose dey think am but as person wey no smart, e just go dey spit rubbish commot from mouth. No body dey find e apology, becos of e come naija board na still disaster e go come create. Sha na to follow am back to back. D guy no smart at all.

Lol, this your comment funny and e still carry weight, no be lie Sha. I no go blame the guy, sapa wey dey dis country fit make person misuse opportunity, I swear. As be now things dey hard but make we just need to make the guy kno say make ihn make use of the opportunity wey dey this forum with ihm mouth closed. No be all cloth person dey sun for outside.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
I no wan talk much but anyhow una fit comment here make we reason the matter.
Em don d like sae d more we begin not to say much about the newbies wey d enter the forum, the more they begin to talk out of point wetin no go  follow for the forum due to nobody the direct them on wetin d suppose not to post for the forum.

At times the kind post wey I d see from newbies wey identify themselves as Nigerians for this forum, d make me the wonder who d invite them come for this forum whether dem the nurture them properly on wetin d supposed to the post or not for the forum because peso no fit just wake up to create post and begin to generalized am like sae btt d serve as blessing give unemployed Nigeria youths. Like sae 200(unverified number) wey we d for this forum na all the Nigeria youths be that or em wan talk sae Nigeria youths d 200 for population. Anyway, we no go blame am sha cos the forum d open for everyone to post as em like but that one no mean sae we no go correct and caution them when they go out of lane
full member
Activity: 224
Merit: 195
I dey off if I dey see this kind thread them, I dey highly disappointed for that person wey make that kind thread, like can't we Nigerians comport ourselves, e no dey waste them time to begin paint us wetin we no be.
At first how dat guy take enter this forum, I dey sure say na person  fit bring am here den the person no tell am the rules and regulations for here abi himself no dey spend time read in detail more about this forum.
This our local board don dey already build better reputation for this forum, something wey this our oga dem don suffer for us to make here dey this kind active na him one new just one come spoil everything. I hope strict actions will be taken against that account
sr. member
Activity: 420
Merit: 262
Very good and valid point Adbitco, I think say na only me de notice all this kind threads. To me ba, no be by force to create thread oo, person fit just de engage for people if you no actually get important information to share because these English boards are general boards so if you come from our Nija local board e go be like u de represent us for there; so make we de very careful with what we bring in the forum, no be everything them they post. I understand say merit hunting de, but if you package and arrange your thread well with meaningful information and links, you will get merits for your effort, so make we de very cautious.
hero member
Activity: 532
Merit: 508
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
The guy did not actually give a good impression for creating such a topic, and he has shown himself as someone who is only here to make money from signature participation. He basically cannot contribute to any serious and meaningful discussion because, judging by what he said already, he is only here to catch fun, and as far as I know, the community is not for fun but some serious, meaningful, and educational discussion. If he actually wants to have some fun, then he should visit the off-topic board and make some unserious topic that will not even gain any attention.

Some months ago, he created a topic where he was seeking an opinion on whether he should stop his job and focus on building his account and earning from the signature campaign.

The job he said he is earning seven digits per month is still the same job he wants to stop and focus on the forum in order to get paid.

With only 11 activities and one merit since I joined bitcointalk in January, 2023, I am currently faced with the dilemma on focusing on bitcointalk in other to learn/earn, but my current job is so exhausting that it takes virtually all my time.

Bitcointalk is the in-thing, but it requires time and efforts to grow and my Job do not give me enough time. My Job is more like 24hrs Job were I can be called to duty when I am resting/sleeping.

Do I quit my Job for Bitcointalk? (This is running through my mind)

My Job pays less that $300 a Month.

I am in a serious dilemma.

I need some motivating advice on what to do.



Some of the legendary and hero ranks on the forum are seeing more than $400 a month plus their personal businesses, which earn them more too, so what's PhilixCrpt talking about? It's just a newbie race that he is running, but whoever is his master should guide him very well because the forum is not a company where people get permanent employment.
full member
Activity: 224
Merit: 151
Omo people dey ooo, I wonder why person go enter English board go dey make such a useless post. This user deserves a very hot slap. It's not proper to make such a derogatory post about we country. I don't know why some people behaves like goat. Them go tell una to go school una go say school na scam, now look at how the op is disgracing himself. My suggestion is that he should be go and delete the post. Someone who knows the op should pm him/her informing the person to delete the post immediately. Make we dey try get sense small. No be everything them go teach us for this life.
member
Activity: 168
Merit: 50
Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
Even as we see this Nigeria finished Cus of the Economy na our government people dy misbehave every other thing set for Nigeria Good weather, no earth quake.good soil even no be poverty be our problem.but we must not bring it out other countries want to be like Nigeria,most people want to come to Nigeria but if they see this kind of post and other they will be discouraged.I understand bro let us really mind what we post.
Pages:
Jump to: