IMO, people who believe that Bitcoin is a scam are the people that can easily be scammed if a scammer sees them. Some government advisers are not well-educated about Bitcoin and cryptocurrencies. That's why they tell the government in power that Bitcoin is a scam, because no one controls it and the government also fails to do their own research before making their own conclusions to restrict or ban any bank account that deals with crypto currency transactions.
Now my question is: how can we make these governments know that Bitcoin is not a scam?
Government no be small body for any where for the world, d government of any country dey at advantage of getting any information wey dem want over all the citizens because na dem get power for hand, so to dey talk say government advisers no dey educated about cryptocurrency na something wey me I no go agree with you because I know say all those men e no go cost dem anything to say dem wan go into research to know more about wetin crypto be, infact I feel say dem don even do d research reach were dem don discover say na somtin wey dem no go fit control, So na y dem just say na scam based on say na something wey dia power no go fit reach control.
If to say na something wey dem go fit control from d government, dem for don adopt am den start to dey control am so dat e go dey benefit dem directly but as dem see say dem no fit, e com be like say to dem na bad thing as dem no get power reach dat side,s o dem no go fit benefit from am well. All those advisers dem go don do research or even pay pipo wey go run d research for dem so dat them go fit understand wetin d crypto mata be, so no be lack of education or information dey cause am, na d fact say dem don even dey informed about am and see say dem no fit do anything dem just wan leave com tag am like say bad bad tin.