My fellow naija people! Dem say follow who know road.. if you no follow who no road you go suffer till you go tire😄 sometime in life people dey always think say Dem dey make am, not knowing say Dem dey deceive themselves.
Doz same people way talk the word come later add am a word of advise, say when u they follow who know road, try they carry ur own personal transportation.. eh get why.
4 diz matter now the TP go be ur own personal akoluche (wisdom/knowledge) as u they follow who know road try they also apply ur own sense as no be everything way who sabi road go teach u, abi no be all him go remember teach u, who sabi road + who get sense they make journey easy.
Question: always ask question. Our people say person wey dey ask questions no dey mis road. So many people lack that character of asking question. If to say I no ask question I for no ft find this forum.
To ask question good, but no be for all occasion man really need ask question sometimes we just gat they one side they observe, bcuz u fit ask the wrong person question watin u go receive in return no go be watin u expect, last week I collect hot slap for rumuokoro for small question way I ask SARs man 😂😂😂