Pages:
Author

Topic: How I no get time of my girlfriend when I dey do Bitcointalk.org (Read 228 times)

hero member
Activity: 1120
Merit: 887
Livecasino.io
E be like say na only me and five (5) naija users for this community wey no get babe to distract me or remind me about this forum. Sha I totally understand the OP point of view. Sometimes sef the motivation nor dey dey but as my bro dey always talk, "life na planning" For example, I don notice say our 001 dey nine out of ten times dey dey online for early momo. I believe say that one na him own strategy be that. And another user still don advice me on this one. Sometimes e dey sweet to open the forum while some other times na hardwork. Anyways, we keep pushing.
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
Most times I no dey really let this writings be one big job for me because I dey always try to schedule myself for everything thing I suppose do and no matter wetin I dey do, I dey always try my best to get the highest time for my babe, I too love that babe  and beside I no one belief say na because of writing na e make you no go get time for your babe except say your eye son dey chuke for outside the no we go understand, as for me, no matter wetin I dey write , I dey always make sure say I answer my babe whenever she calls me.
member
Activity: 212
Merit: 12
My dear the thing no funny at all,but wet man go do na,we need to hustle and make it and when we make it girlfriend go because jara,but e dey pain ooh especially if The girl The die for you, and you come the do like say you they always ignore her,she go call you y, you no go answer because you no want make the call cut wetin you the do for net, but if na girl wey no you hustle she fit bear am ooh so far say the Bitcointalk wey I dey I no The do rubbish there say na hustle I dey I go consecrate first oooh and after I don make then I go beg am then..my dear hustle no be here oooh.
full member
Activity: 560
Merit: 100
Eloncoin.org - Mars, here we come!
I been think say na only me dey face this issue o, my babe don vex for me tire, she don kuku conclude say I be Yahoo boy without labtop, lols, omoh I don give all my time to Bitcointalk, I no get strength to look uche face, me self na new bie I still dey learn from this forum, so I want give my all attention to the forum, any distraction from any body, HOLY GHOST FIRE OOO...
newbie
Activity: 28
Merit: 15
Omo make i no lie this things wey you talk na true, i never de used to the forum well well but the small time wey i don do here i don see shege i just de read up and down, for how many days now i no even dey get time for any social media so tey people de complain say i no de reply their messages for whatsapp how i wan take explain the matter for them like this. My fear now sef be say make eye no come de pain person because the way i de press my phone dis days ehn na only God fit save person. I no really get any distraction sef cos i no even get girlfriend
full member
Activity: 840
Merit: 137
Bitcointalk can be very time consuming especially when you want to really know more about the forum. But the time spent here in the forum is worthwhile and appreciable compared to spending it on social media platforms that in the end you get nothing to gain from it.
About your girlfriend matter, beta create time for her oo and make her feel loved too. Make you no use busy life forget her or as an excuse not to create time for her, if not, you must be trading with non-lasting relationship.
One thing wey you no know about bitcointalk be say, bitcointalk no need distraction when you dey make post,anything wey make dem distract you,you go forget your line of post at that particular time, especially when you dey make post for bitcoin discussion board.That board really need concentration and attention to all the lines or sentences you make their,so at that particular time of making that post,you no go fit get time for your banny.If na night,you go just tellam make she sleep,because you go just dey silent dey concentrate throught out,untill you make the posts finish.
sr. member
Activity: 546
Merit: 342
I no go lie, me i don even get small issues with my woman sef, especially when i cum first get work for the forum. Omo i feel like i needed to do everything correct because i no wan hear say something happen to the post count for di week. So i cum reason am say instead of posting for daytime its better i gist after I don cum back from work then i fire down my btc forum activities for the evening time after the brain don relax wel wel.  The compound wey i dey stay na so so children way mak noise nai ful so wen i was post i dey even dey beg ma woman for some quiet time and maybe go elsewhere to relax my and do my work because if you no sit down reason wel before you go know you don post nonsense..
chairman no be small matter oo. Even we just deh start the forum sef don dey get small issues with our girlfriends because the Matter tire people "just imagine how somebody go dey talk to you sef but you know dey reply "? This word don turn to my bani favorite speech because my phone for now don turn my second girl. To write and reply an thread or post no easy oo u must focus and the place must dey quiet for you to contribute well for that topic, so i deh ur pain when you talk say u dey for compound wey noisy people plenty.
hero member
Activity: 966
Merit: 697
Bitcointalk can be very time consuming especially when you want to really know more about the forum. But the time spent here in the forum is worthwhile and appreciable compared to spending it on social media platforms that in the end you get nothing to gain from it.
About your girlfriend matter, beta create time for her oo and make her feel loved too. Make you no use busy life forget her or as an excuse not to create time for her, if not, you must be trading with non-lasting relationship.
hero member
Activity: 700
Merit: 541
Bitcoin Casino Est. 2013
[~snipped~]
and cum u self fit add ur own story on how u tak share ur time *SUSANO CARES *

I nor go fit talk put for the babe side because me self never get babe because man need to prepare himself before he put hand for babe matter. So I nor really know if babe matter go disturb my time on bitcointalk or not.
But the one when I wan chuck mouth put nah the aspect of school and Bitcointalk. For me I nor dey see chance take dey do bitcointalk as I first dey do am when I never enter school and my own Kon still get k-legs because nah still first year I dey so everything for university just dey new to me and I gat take most of my time take focus for school, and my university nor even get mercy for people at all imagine going to class 7 am come back 6pm sleep for like 2hours and then go night class again. Even to complete my weekly post for sig dey hard me like mad.
member
Activity: 71
Merit: 21
I no believe wetin Op talk jawe, how you go tell me say you no dy get time for your own banny because of Bitcointalk. Normally Bitcointalk dy addictive and time consuming but everything get it's own time. Time for Bitcointalk and your girl dy different you just need to create time for everything. If na time for Bitcointalk, put a lot of your energy in it because na wetin dy put money for your pocket and if na time for your woman give her full attention Biko. A lot of benefits dy here but no dy allow am spoil your relationship with your babe ooo.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
This our bitcointalk forum dey time consuming and addictive I no go lie give you. But as em d dey time consuming and addictive na so em d sweet for body d go. No how you go come across btt forum and remain the same intellectual and otherwise. Anyway the kind knowledge and exposure wey I don get for this forum, my school no teach me like that.



All of us for this forum are just caught up with love and addictions of the forum, which makes us not go a day without getting ourselves involved with forum posts. No be us to do ourselves so. Na the love of the forum and the
Knowledge wey we d get from the am, na em the make peso lose interest and no get time for some kind things like that.
sr. member
Activity: 658
Merit: 441
OP na very funny and serious mata you raise so. Bitcointalk could be very addictive. Concerning the woman mata, you no say woman dey like attention and if you no give am to them na wahala be that. Ah no say na hustling and learning na im carry us come here but make we no carry am for head come forget important things for our lives like bannies, wife, and family. Na to try strike a balance between them make issue no come up.
sr. member
Activity: 644
Merit: 335
Smile, boss this your topic carry Belle oo, na funny thing sha but the issue of making posts or replying post no fit carry anything join your relationship na, or you just no like her again because many people are in bitcoin activities and being in this forum for many years now and nothing happen to their relationship, so waiting I get to tell you be say make u try calm down they run things on a easy way make you no come lost your girlfriend.
sr. member
Activity: 924
Merit: 391
Underestimate- nothing
I no go lie, me i don even get small issues with my woman sef, especially when i cum first get work for the forum. Omo i feel like i needed to do everything correct because i no wan hear say something happen to the post count for di week. So i cum reason am say instead of posting for daytime its better i gist after I don cum back from work then i fire down my btc forum activities for the evening time after the brain don relax wel wel.  The compound wey i dey stay na so so children way mak noise nai ful so wen i was post i dey even dey beg ma woman for some quiet time and maybe go elsewhere to relax my and do my work because if you no sit down reason wel before you go know you don post nonsense..
I no fit stop they lauf I swear because me my babe done leave me because of bitcointalk oh but how man go do, as i see your own story i just they laf, the post na fun post, my babe self no one belive say person they get something from forum, as i come explain am she understand but were the problem come they na issue of say me i no they get her time the babe just vex conclude say she no do again. Grin Grin
hero member
Activity: 644
Merit: 520
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I no go lie, me i don even get small issues with my woman sef, especially when i cum first get work for the forum. Omo i feel like i needed to do everything correct because i no wan hear say something happen to the post count for di week. So i cum reason am say instead of posting for daytime its better i gist after I don cum back from work then i fire down my btc forum activities for the evening time after the brain don relax wel wel.  The compound wey i dey stay na so so children way mak noise nai ful so wen i was post i dey even dey beg ma woman for some quiet time and maybe go elsewhere to relax my and do my work because if you no sit down reason wel before you go know you don post nonsense..
sr. member
Activity: 602
Merit: 306
Story story 😁
Sometimes from morning till night my eye just dey my phone. dey press nd no be say I dey do yahoo self 😭
I fit dey house dey think of post to write or dey think on how to tak reply post not tinx hard pass that one self
for Bitcointalk.org
See mak I tell u something as a Bitcointalker time no dey to check time na fire for fire 🔥
nd for newbies ur eye go see pape u go collect 😁 so newbie mak ur eye shine ooo
and cum u self fit add ur own story on how u tak share ur time *SUSANO CARES *

Guy this matter long sha, but if we no hustle get this money waiting you and your girlfriend go take chop, if you no even find money na she by her sef go take open her mouth say you no get money see waiting your mate dey archive, i don loose almost two babe now just because my eyes always dey phone say i no dey get her time, but as e be man wey want to survive must hustle, if she truly loves you she go understand what you are doing.
legendary
Activity: 2408
Merit: 4282
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.

and cum u self fit add ur own story on how u tak share ur time *SUSANO CARES *

Nothing you talk here but your topic title sweet me. Sometimes I dey wonder how married man wey dey here dey carry survived talk more of man wey get Children wey dey worry everywhere. Me I like peace of mind, when I dey enter forum so i dey like do am when everywhere quiet so i fit dey understand the post I dey read and the topic or reply wey I wan drop. Sometimes self I need read am loud to myself make I see if wetin I dun write make sense. This part na dey vex my banny as I go dey disturb am with words wey she never hear before.

I dun finally find wey to dey do am when she no dey around or she dey sleep, no be easy something oh something sha she go dey dey around but since I dun explain the whole hustle for her she dun come understand. Somedays self na she go remind me of forum. Woman normally need attention and when you no give am she go go outside go find am. So in everything you dey do, if you truely love your banny still dey find way show am love and commot your eye for phone make e no spoil your eyesight.
jr. member
Activity: 40
Merit: 2
People wey dey support op for this post shey una know
the lyrics of T.I Blaze "sometimes food no dey give man joy but Canadian loud the feeling is different" As we all know say normally we no fit dey without food but sometimes we dey give exceptions based on some pressing needs. So saying u no get time for your banny when you dey online e get as e be oooh. Because sometimes na when you knack you go reason well.  Grin Grin
full member
Activity: 840
Merit: 137
Omoh,this OP topic ehn,,e sweet me die,the topic make sense die,because when we dey make post,nobody for the forum go te me say him dey get time to dey fit gist him girlfriend,because this making of post no be wetin you go just wake up type,na wetin you need calm down think of wetin you go write wey go make sense for the reader ear.Me sef,I no dey fit even make post for where noise dey,talk more of when my girlfriend dey around,I dey just keep quite and make my post to meet up my target for that day.I no dey get time to gist her when I dey on my post dey make.
hero member
Activity: 966
Merit: 701
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Bitcointalk can be time consuming and addictive. It’s the way social media works, we find ourselves addicted to our screens. I wouldn’t let it affect with my relationship with my partner. It’s a lame excuse to blame one’s online activity as reason to be less attentive to their partner. Some users have supported your narrative, and I wonder how your activity here affects your efficiency in your workplace.

You guys should reduce the emojis. The last person who went on spamming technical boards with these emoji posts got nuked.
Pages:
Jump to: