Some piple area like my own self, we no trust the way light dey go OFF more than wen e suppose dey ON. The most annoying part nah the bill we dey receive every month, e reach to use pay pikin school fees oh. Make e no make piple reason something bad for NEPA oh, becos how you go use light for 3hrs per day (that's if dem pity us oh) then bring #30,000 plus bill or even more than dat self and expect us to jubilate like Arsenal wey win match, make we go dey pay that kind high bill eh, ha, na wa oh. And if them take the light we fit stay for darkness for like 3-5 days or even more e go give mosquito power to invade us like Russia wey invade Ukraine.
Me I weak abeg... How una see this issue wey strong pass karnel?
My brother this nepa matter tire anybody as i dey lie this na heat i dey so, for my side sef person go pay for nepa bill at the end of the day light go dey on and off by itself not even 24h ours light and dey will later begin dey tell stories that something hot, this our country nepa and government they are all f9.
F9 mean say hope dy for this current government but for now no be when we go dy wait make them use plenty talk talk full our ears, as e be so make we try no listen to them, nah to use our power which is the PVC to change this change them give us for 8yrs. Better person dy wey go help us clear our suffer.
As for that heat wey dy do you comrade, just go pour water for body,better days ahead.