Author

Topic: How we go protect our forum account. (Read 60 times)

hero member
Activity: 742
Merit: 529
casinosblockchain.io
I will be listing some ways which we can use to protect our forum account below.

-Wetin we suppose first do if we Dey create forum account, na to make sure say we make use of strong password, make we no use password wey be say people go easily fit guess am.
Strong password nah very important thing when creating any profile account online to prevent hacks. Just adding some numerals, alphabets and sign. But in doing so inno mean say make you go create password way be like  CBN vault password wey go come the dey you too technical to remember. Normally, password suppose be simple to remember and no be to the crack head each time you want enter am. And make we also learn to the write down our password keep for paper securely because some of us don use the always loggin feature for so long, come forget how our password look like sef should in case we lost our device.
full member
Activity: 266
Merit: 136
October 09, 2024, 06:38:35 PM
#4
No be lie some people dey make mistake use their username as their passwrod. Account like that go easily dey hacked. If we wan use password make we use password wey they entirely different from our username and make e include one or more capital letters and number for the password. At least make e be 8 characters at least, we fit make am longer. The reason for the 8 letters na be say password guessers go find am difficult to fit guess 8 characters correctly. Another reason na for our own benefits, so that we go fit remember am easily before we go forget out password.

To practice this is very simple, just follow some little steps and you're safe.

1. Don't share your login device with anyone.
2. Don't store you login password online or with any third party entity.
3. Activate 2FA security measure in other to shield over any related attempt for hack.
4. Never leave your sensitive information open to anyone, maintain your privacy.
5. You should not use password manager, be careful of malicious links, sites and any phishing attack means.
Let me add to this

6. Dont login your account on any external device which is not yours
7. Use the stay log in for several minutes to avoid always log in every time you want to use the platform.
sr. member
Activity: 658
Merit: 429
Hope Jeremiah 17vs7
October 09, 2024, 04:52:54 PM
#3
Stable090, you talk true and Doan9269 don summarize m but something dey wey whona miss, na be say if you create account nor just use any random account, bcos person fit go create that account or don do m already and then go get access to your BTT account.

5. You should not use password manager, be careful of malicious links, sites and any phishing attack means.
Password manager is not bad and it's highly important because you can't store all the different password you use on different platform online in your head and so it's highly needed for having good security practice online. Though we need to be careful of the ones we use since some have suffered hack before and therefore users  password likely will be compromised.
hero member
Activity: 812
Merit: 560
October 09, 2024, 03:56:18 PM
#2
To practice this is very simple, just follow some little steps and you're safe.

1. Don't share your login device with anyone.
2. Don't store you login password online or with any third party entity.
3. Activate 2FA security measure in other to shield over any related attempt for hack.
4. Never leave your sensitive information open to anyone, maintain your privacy.
5. You should not use password manager, be careful of malicious links, sites and any phishing attack means.
sr. member
Activity: 770
Merit: 445
October 09, 2024, 01:54:00 PM
#1
As a forum member, Dey get one thing wey we know suppose carry play which is our forum account security, people wey don Dey here before fit don sabi dis thing, but new members Dey wey just Dey join us, and dem fit no really get knowledge about this, and I Dey sure say dis post go Dey useful to both new members and old members of the forum. E no go make sense say we lose our account to hackers which at the end dem go use our account do illegal activities or scam people and spoiling our own image, so if we don join dis forum, I go recommend make we properly protect our account so that we no go lose am.

I will be listing some ways which we can use to protect our forum account below.

-Wetin we suppose first do if we Dey create forum account, na to make sure say we make use of strong password, make we no use password wey be say people go easily fit guess am.

-Make we make sure say we no leave our password for online, make we no keep am for any apps online, I know plenty people prefer make them store there password for on (Email), but e no really make sense, if anything happens to that place wey you keep your password, maybe if hackers hack am, then Dey don already get access to your password be that, and Dey go fit get access to your forum account.

-Immediately we create account on the forum here, Dey get one place wey go Dey show the E-mail wey we use create the account, e make sense if we hide the email, so that nobody go even sabi d email wey we use not to talk of say dem wan tamper with am. If person no sabi your Email e go hard for am to begin de guess password for the email wey him no know. We fit hide the email for settings (i think the default settings as you create new account de always hide our email).

-Make we make sure say we no Dey borrow people phone, or laptop to login our forum account, because if you finish Wetin you wan do, d person fit go Dey use your account for your back, and even if you logout your account, your username and password fit don save for the person phone automatically, so make we no Dey login for people phone anyhow, and make we no Dey give people our phone anyhow.

-If we Dey create forum account, make we make sure say we get separate email for am, make we no use email wey we Dey use to register for other sites, make we make sure say even the username and password Dey different, and make we make sure say we properly protect the email so that hackers no go fit hack am.

-Make we Dey always Dey careful with links wey we Dey click, and apps wey we Dey download, some of those links and apps na scammer’s get am, anything wey make you click some links hackers go get access to your phone, and Dey fit move any vital things wey Dey your phone, so don’t click links anyhow, and if we Dey download apps, make e be say na from original source we Dey get am.

-Make we try protect our forum account with google authenticator, if you wan login to your account you go need go generate code from google authenticator first which will expire after 30 seconds, so if anybody wan login to your account for your back, if dem no get access to your google authenticator, then Dey no go fit access am, so e make sense if we use am secure our forum account.

I Dey sure say dis thread go really help people on how dem go protect their forum account, and anybody wey get more things to add, then e go make sense make him drop am below, make all of us Dey learn, e no go make sense say we lose account wey we don suffer build.
Jump to: