I am ever grateful thank you all.
Specially welcomed my baby girl by name Davian.
Boss this your news sharp and hope you know say e no go easy especially these period wey things just dey cost anyhow but the hope be say a child na blessing to their family and I join my fate with the host of heaven to pray that your daughter will bring you and your family joy not just today but forever and you sha live to reap the fruit of your labor amen.
Abeg try make we we come follow you chop pounded yam as people wey dey drop better prayers 🤣
Congrats boss and this is just the beginning of greater things. Amen.
Hehe no issue my brother, I believe say very soon child dedication go reach and I go also invite the full house though people wey no meet up for the wedding come promise say during dedication them go show face.
Ahh, our princess where you been go na?
We don dey expect you since to come do omugwor for us na, lols.
No be small.. abeg no reason the name oo, you go see more sweet names of baby God finally give me SatoshiKing. Abeg make them never steal this name oo because I no quarrel with anybody oo,
I hope to see the full house during dedication.