The problem government gives bitcoin every day by day is it same thing government give all this fiat exchangers, that means if bitcoin have not fall to the category of decentralization that means by now bitcoin won't have exist again, the decentralized bitcoin is today is what that keeps bitcoin and its what makes bitcoin to exist more and more from my understanding...do you know that the reason why some of the mixes is being ban in the forum is not that they committed much crime but government is against them because they are against bitcoin, so if bitcoin wasn't in decentralized form they would have rubbished bitcoin by now.
Although, you get point because the decentralization of Bitcoin dey make government dey fear to adopt am because dem go lose control of money supply and other monetary policies but that's not the only reason and e pass wetin you dey think here. Government dey right to some extent if you pay attention and read their own side of the story. Money laundering and other illegal monetary activities don dey rampant for cryptocurrency and e dey among reasons wey make government no wan approve am.
Talking about the mixers, which mixer dem banned wey no dey involved in money laundering? Criminals dey use this mixers to carryout dem activities on a low key and na wetin dey cause dem ban be that. You know crypto transactions dey hard to trace and imagine Nigerian government don approve am, corruption go increase no be small. Even when the government is not taking serious action on those who dey steal our money, at least we still know people who divert our money and the amount wey dem divert because it was traced to their account but if na bitcoin ahh otilo.
The instability of cryptocurrency go make the financial system dey shake and become instable and government dey try avoid am too. Na why dem no wan approve am. Abi you go happy to wake up one day and see your country reserve on -95? If na you dey on government, you go like am?
Government dey try to protect dem self and the country economy and make we no too blame dem because I believe with time everything go work in our favor. If proper regulation go dey cryptocurrency, government go rush approve am but the decentralization of Bitcoin go reduce sha.