Pages:
Author

Topic: IF NOT FOR GARRI: Drop your story - page 2. (Read 319 times)

member
Activity: 168
Merit: 75
March 06, 2024, 11:54:04 AM
#6
Hahahaha, omo garri don really save us o, e dey always deliver, aside God na garri dey always sustain us, we for no know how we for dey do am for this economy pressure wey full everywhere but garri anytime you put call, e dey always answer but they won make am make e no dey affordable again so na to buy farm, plant cassava because if you no get farm ehn, I no sure say we fit afford garri at times because of the way e dey cause now and garri dey sabi bellefull person and e dey hold belle too. Omo garri dey really try.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
January 22, 2024, 06:19:40 PM
#5
I no just understand why people go dey refer people dey come here and then no go guide them or tell them how things dey play for here, omor no be child's play we come here for. You gats they creative make good quality posts oo, no ba all these kind useless off topic wey gain nor even dey inside. This thing don dey too many for this board, e be like say person go place una post where e belong oo, because this matter don dey pass becareful. Anything wey una see for social Media e go must turn thread, no be so oo. With this kind post sef you no go fit see one merit sef. Abeg make una amend una ways before Dem mark una face oo.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
January 22, 2024, 04:44:51 PM
#4
We all know and have had an encounter with this life saver … Garri actually saw me through till I graduated , there was no day that I was down and garri wasn’t there to save me…: Omor if not for garri , man for don mud😂😂
As I see this your post laughter wan kill me. E be like who carry you come this forum no give you proper orientation. The person no tell you say here na place for matured minds not for children. Well anyhow em be, you don talk am and nothing we got change about am, but next time improve. because no matter how smart we are, we  no fit run faster than time. because time na the beginning, future and the end. So na just parable. With time you go cope up. No time is a waist, na matter of time you go stabliz .
sr. member
Activity: 420
Merit: 273
January 22, 2024, 03:32:45 PM
#3
We all know and have had an encounter with this life saver … Garri actually saw me through till I graduated , there was no day that I was down and garri wasn’t there to save me…: Omor if not for garri , man for don mud😂😂

Bro, you need to be more creative in your posts, if you wan make meaningful impact for dis forum, you for just relate drinking garri to Bitcoin matter, something like "I de ready to de drink garri and deny myself of some luxuries so I go fit save money to de buy Bitcoin de hodle till bull run", then you fit end am with how drinking garri no be new thing to you based on say na im sustain you through school, wen ground no level. Anyway I encourage you say make you no de in a haste to start topic, make you focus on learning and increasing your knowledge about Bitcoin, gradually you go begin to de make meaningful contributions and de start quality topic, all di best.
hero member
Activity: 490
Merit: 507
January 22, 2024, 10:31:45 AM
#2
Op what form of discussion are you trying to create now? Assuming I want to make a reply to your post what would be my response now. If you want to grow, this kind of post are not beneficial at all and they will get you nowhere so i advise you improve or rather start by learning before posting anything. Just a newbie with few posts and you have already dented your account with a neutral feedback so soon by using AI to post all because you neglect the learning process.

I didn't want to reply your post but for some reason, I think you should use the lock button beneath your thread. I don't know why you've decided to post this here. It's off topic I don't see any discussion on this post. Please we should avoid making these kinds of post here in our local board. They are unreasonable and off topic

This local board have become more active than it used to be but Newbies are getting it wrong here, they keep flooding the board with off topic posts that have no use or benefit for the members here. I think this board needs a moderator here to flush away posts like this
newbie
Activity: 26
Merit: 0
January 22, 2024, 09:51:28 AM
#1
We all know and have had an encounter with this life saver … Garri actually saw me through till I graduated , there was no day that I was down and garri wasn’t there to save me…: Omor if not for garri , man for don mud😂😂
Pages:
Jump to: