This na one mistakes wey many newbies dey make when dem wan start trading, dem dey too quick to want to dey make profit and miss out of the opportunity of learning. Dat money wey you wan give person so, why you no use am learn how to trade yourself. Nothing better pass when you sabi trade instead of depending on another person to dey give you signals. At the end of the day, you go realize say you been dey make the wrong decision. Me self I go prefer you go to a legitimate trading service providers wey be say you go give them money like investment and dem trade and give you returns and use that time dey do other meaningful things wey go add to your life than to wait for signals wey you no understand how dem carry get am. If you want to trade yourself, spend money and learn it perfectly before you start thinking about profits.
Investing and trading different, both can be done simultaneously and you no go get any challenge. Investing no get much work as all you do after you dun see coin wey you wan like na to buy and hodl am. You no need to they monitor the market or do anything active but just wait until time dun reach wey be say you dun get get better profits and you sell or you wait until they time wey you give yourself to hodl dun reach and you sell. Trading na say you need dey active for the market and they buy and sell almost daily so doing the two no get problem. If you plan yourself well you can multitask on various profit generating activity and come out successful. People dey wey dey run am so e no dey impossible to achieve.