Pages:
Author

Topic: Is Yahoo(Street)the last hope of a common man? (Read 596 times)

sr. member
Activity: 490
Merit: 325
The way e dey for we country now,e be like most persons wey no get hope again for life don turn attention to fraud,known as street,and because the thing dey pay,majority of persons wey no been pick interest from the beginning don dey pick interest now.Oibo people don know us say anytin we wan do,we dey doam well.But the most amazing thing about the stuff be say most of those people wey been don almost dey give up on life,and dem later go embrace yahoo as the huzzle,God no shame dem,e come dey like say na dem dey live well pass.
Abeg make una help me put mouth for this matter.
Na d last hope of a common man be that?or e get any other thing wey dem fit do,we go make dem dey alright like the way Yahoo dey do?

You know one thing about Naija as a country? We make too much noise for no reason but I wouldn't blame us because when we experience things for the first time, we make sure the it trend while it last. Nigeria isn't even in the top scamming countries, India is the leading spot and they are have been doing this fraud thing for many decades and you wouldn't see them trend it but we make a lot of noise over these Yahoo of a thing.

Looking at the way fraud is going on, I think it's not just about the way the country is going, I just feel that the person that want to do fraud feel like doing it, let's not justify lack of government intervention and lack of job opportunities to justify why people dy do fraud. What is bad is bad and I don't think Nigeria is the worst county to live in, we have many countries that are worse than us and they don't pick interest in fraud.

Those who want to do fraud should continue but one day, they will meet up with their nemesis and security law enforcement will pick them and they will pay for all their crime.
member
Activity: 322
Merit: 70
Yahoo no be hope of a common man,pipo wey dey indulge in Yahoo(fraud) na pipo wey lazy to work out their own money.I just like di fact say most of our Nigerian youths dey into content creating that one sef na way we fit make money online no be to fraud people online be the last hope of a man.With the way Yahoo don rampant for our society nai make people dey talk say any online way of making money na Yahoo Yahoo and no be every online way of making many dey legit oh like we wey dey into crypto exchange e get many shitcoins wey don pump into the crypto market wey na scam(Ponzi scheme) so we gat wise up before we fall into the hands of fraudsters.
sr. member
Activity: 434
Merit: 254
DAKE.GG - CASINO AND SLOTS | UP TO 230% BONUS
How would yahoo as you call it be the last hope of the common man, sometimes I don't even understand why most of us create thread like this, are we trying to make it look like this is the work that's is available for Nigerian to do, I don't like it when we always bring thread like this here.
Anyone involve in yahoo should be seen as a fraudster but let's not always make it look like Nigerians dey package this stuff more than this away men, them do am major pass we, which people wey you feel say they hack more, make we look for better thread create no be this one abeg, Nigerians are hustlers not not scammers.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
I for talk say true true Nigerian youth wey dey do yahoo lazy as our former presido been talk, but even the yahoo self no easy to cash out, except for boys wey don plus up their yahoo. E dey really baffle me to see the kind of energy and effort boys dey put for this yahoo. Just imagine if them put the same amount of energy for another online hustle, for those wey no light offline hustle. The problem be say our youths nowadays dey see the kind of luxurious lifestyle wey other yahoo boys dey live and the thing dey hungry them too, and them don conclude say no other hustle go fit give them the kind money to live that kind of lifestyle so them see yahoo as their last hope of survival. Another thing na inadequate job for the country, even for graduates to get jobs na wahala. Now even old people self don Joon yahoo because of too much hardship for the country. Na only God fit just help us for this pandemic wey don infest this country like this.

Before I been dey think say na because  of to survive naim so e boys dey enter street but this few days naim my clear. E get one boy wey dey run street wey I come across the few days, as we dey discuss e come tell me say, work for office no go fit pay you $100k. Na from there naim I take realize say some of these boys, don get passion for wattin Dem dey do and them don see am as opportunity to take make easy and quick money, rather than looking for a way to survive. So even if them try to use their knowledge and skills take do legit online business, them go always tell you say e too hard because of the swift way wey their money take dey come from street.

So yes, street fit dey hard somehow but you no go fit compare to legit work online, though both of the requires dedication but legit still hard pass.
sr. member
Activity: 1288
Merit: 231
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
God forbid say na yahoo be the last hope of our youth, I no fit even imagine say naim go come be the only thing wey boys go out their head to make living and to feed their family. Tahhh, i reject that kind thing to happen, as e stands now, the wey things dey go, e come dey be like say the street life don dey hard because now, I don dey see some boys wey dey do street don start to resume their normal work, some of them don dey even go far as doing oguaja(helper for house building) or building casting. When I see the thing e shock me, na there I take no say truly street don really hard and before you go know their update go just finish.
I for talk say true true Nigerian youth wey dey do yahoo lazy as our former presido been talk, but even the yahoo self no easy to cash out, except for boys wey don plus up their yahoo. E dey really baffle me to see the kind of energy and effort boys dey put for this yahoo. Just imagine if them put the same amount of energy for another online hustle, for those wey no light offline hustle. The problem be say our youths nowadays dey see the kind of luxurious lifestyle wey other yahoo boys dey live and the thing dey hungry them too, and them don conclude say no other hustle go fit give them the kind money to live that kind of lifestyle so them see yahoo as their last hope of survival. Another thing na inadequate job for the country, even for graduates to get jobs na wahala. Now even old people self don Joon yahoo because of too much hardship for the country. Na only God fit just help us for this pandemic wey don infest this country like this.
member
Activity: 168
Merit: 77
Well, I no go talk say na yahoo be the last hope for our youth o, because Bitcointalk and other online stuffs dem dey wey person dey get money from, na just that so many people no won dey stress demselves dey write or dey post like us, dey just want fast fast money, na e mk dem come add am plus up, because as e be say na one person fit use jazz, carry get money without stress unlike us wey be say, we dey use our head dey type come post and to come even get merit join na war, unlike Yahoo wey be say once u get clients wey get money, dem don go lock am, de clients go dey pay dem on steady but we, na here we dey die, because we go dey suffer although na softwork from our comfort zone but e hard and dey stressful o, no wonder dem say, say nothing good comes out easy, na for this forum I see am and as we be better person like this, we no give up and we no dey involve ourselves for evil instead we hustle till our hustle pay too. So all this things dey make some people choose yahoo rather all this ones we dey do, so no be Yahoo be the last option for our street youth,  na just dem wey won cash out big.
full member
Activity: 350
Merit: 128
Yahoo  can never be this last hope for common man to become rich. Those who are into fraud are just lazy, impatience and greedy because its known fact that Yahoo is no longer paying as before but they are continue to find other ways to defraud others and most of them have left Yahoo for Ritual,Kidnapping and selling of body parts.
Only a few of those who did Yahoo invest their money wisely while alot spend their money on girls, lodging on hotels and clubbing.

Exactly, Yahoo can never be the last hope for a common man. It can be that internet internet fraudulent may have been existing for long even before it become public awareness but let's be realistic, when did yahoo e restarted in this our country? Because I Know that there had been existed rich and average perwonwiin this country even before yahoo came to our knowledge. Meanwhile there are still rich and capable individuals who still finds their lives meaningful and comfortably living without engaging on the yahoo so I don't see any way fraudulents would be seen as a last hope for a common man.
Many has also attested to engage on it and hoping that they'd make it prosperously as others but they fall back to their hustles and dump the yahoo game because it wasn't as easy as they thought. So basically if yahoo was the last hope for a common man in this country then everyone would had find it embracing.
As much as I know, the last hope for a common man is Investing on yourself by actually skills and then go out there in search of a job or better keep yourself relevant and you'll be utilized productively for the society where would earn you income.
Thereafter I would call upon any insightments of finding yahoo as an option to make a better life as the lazy bones or greedy people who're not contented with their legal petty earnings.
member
Activity: 215
Merit: 24

Time go tell, when person small dem call am 419 later dem call am yahoo, plus up now I know know if e don change name.  Today many of then 419 dey no were to be found....
Making money na differen thing altogether. Na watin make if you get 10m today no mean say you fit solve millions cash projects in few years... But if u learn how to make money I bet u e go for sure stay and increase
Quicker fix??
History dey repeat Sha most 419 b4 dey hear am today...
jr. member
Activity: 151
Merit: 4
Yahoo is not the only hope for a common man , because I have seen many guys who left home for yahoo behold they came back home empty,and still start hustle at home till they become what they are today , though yahoo is just a smart way of getting money very easy that's why many emback on it ,not even the poor both the children of the rich they all do it ,not even because of the economy situations ,it favour some people why other it doesn't is just destiny.
sr. member
Activity: 490
Merit: 346
Let love lead
Its the hope of the common man who refuses to think outside the box for survival in this country. Honestly there are several was to make a living in this country, but every growing up child these days doesn't think about working hard or smart anymore, they want to get an Iphone and start bombing asap. What really hurts me is seeing those who had a beautiful handwork abandon it for Yahoo, they're so brainwashed that they couldn't even combine it with their skills if at all they wanted to engage, rather abandoning a skill for an irrational occupation. Another thing I've noticed about this yahoo stuff is that there's no constant income, they live on chances, some might take up to 6 months to cash out and sometimes less or more.  The most devastating of it all is that most of them now venture into ritual activities, using fellow human beings for sacrifices to accelerate their chances of hitting the jackpot.

I think proper sensitization should be carried out to discourage full Dependence's and engagements in this scam activities as the future workforce and skilled personnel who would be the problem solvers of tomorrow are  rapidly depleting. It would be a mess that there would be serious lack of human resources to handle economic, agricultural and proper tech activities in the near future.

Furthermore, I really encourage these young ones everyday that nothing is authentic as learned skill, it might take a while to convert for you, but consistency in the good stuff always brings a breakthrough when you least expected it.  
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino

God no shame dem,e come dey like say na dem dey live well pass.


The simple thing wey dey there be say dem dey cash out with foreign currency na dat one make the thing be like say e dey pay dem well. You know say as the Naira dey fall, if maga pay dem small change and dem go cash am out, the money go make sense. But likewise no be only Yahoo guys dey cash na. For naija, if you get business wey you dey also receive in dollar you too go dey feel the parol wella pass people wey dey government wey inflation dey chop their salary.
jr. member
Activity: 31
Merit: 14
Yahoo can never be the last hope of every common man to become rich. Let us not be deceived on how the scam pays, unknowing to them, it makes them jobless and of no relevance to their society, in turn killing their future slowly. I feel a lot of sober for those who do not have any handwork to rely on, definitely the scams and everything will surely end one day, they wont live on scam till they get old and perhaps most of them will end up as convict due to their illegal activities. They think is the only way to make money but is not, there are still ways of making legal money, so many ways one can think about, from the Tech world to even owning business, it all demands determination and the right approach.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
The way e dey for we country now,e be like most persons wey no get hope again for life don turn attention to fraud,known as street,and because the thing dey pay,majority of persons wey no been pick interest from the beginning don dey pick interest now.Oibo people don know us say anytin we wan do,we dey doam well.But the most amazing thing about the stuff be say most of those people wey been don almost dey give up on life,and dem later go embrace yahoo as the huzzle,God no shame dem,e come dey like say na dem dey live well pass.
Abeg make una help me put mouth for this matter.
Na d last hope of a common man be that?or e get any other thing wey dem fit do,we go make dem dey alright like the way Yahoo dey do?

Brother, make we no dy deceive ourselves, yahoo no go fit be the last hope for the common man, people wey dy see yahoo that way na the real people way make our former presido buhari call us lazy, Dem no wan just do anything useful with their life, them no wan just make clean money, how many yahoo person you know wey things ends well with after everything, devil go tell Dem to go for road and chop shit, and Dem go do am shamefully.

Bro we get people for we country wey dy do well, from our music, football, tech industry and even to the crypto industry, I never even talk of most of our Igbo brothers wey dy run their personal business across the country, wey dy do well, see eh, the life no too hard if as an individual you invest in yourself, by learning new skill and things wey go improve ur life financially, so to me, those people wey dy go do yahoo, laziness and evil just dy their eye, nothing more.
full member
Activity: 350
Merit: 128
You might not mean it this manner but the subject and contexts of this thread sounds like it's courageous to embrace the frauding system. Atleast out small sand inside am say na illegal and nonsense activity way fit person for problem even if him finally succeed to defraud em victim. Make e no be like say this Yahoo stuff na advisable opportunity for a common man just as you describe am
This really had to go by the streets and that's why I also came in with the street tunes too. Lol!
To me I don't think it's a fact of having no other option to make life easy that's spreading or attracted about this fraudulents activities in our society but the fact of being lazy to hustle and earn pays while some are acts of greeds because some dumps their job and embraces that shit believing the amount of their payments doesn't meet up with their lifestyles.
jr. member
Activity: 63
Merit: 1
The way e dey for we country now,e be like most persons wey no get hope again for life don turn attention to fraud,known as street,and because the thing dey pay,majority of persons wey no been pick interest from the beginning don dey pick interest now.Oibo people don know us say anytin we wan do,we dey doam well.But the most amazing thing about the stuff be say most of those people wey been don almost dey give up on life,and dem later go embrace yahoo as the huzzle,God no shame dem,e come dey like say na dem dey live well pass.
Abeg make una help me put mouth for this matter.
Na d last hope of a common man be that?or e get any other thing wey dem fit do,we go make dem dey alright like the way Yahoo dey do?

Make I no talk Sha buh I ghet to talk wetin I understand, politics affect everything about one’s life it’s affect the food you eat, the cloth you wear, you tuition fee so when you have the bad ones handling it gues how life will become, so it’s not a blame game but our priorities should be to hold them accountable so that they can act right So just because the government is corrupt according to you justify the youths for cyber fraud? Two wrongs cannot make a right.
member
Activity: 84
Merit: 11
The way e dey for we country now,e be like most persons wey no get hope again for life don turn attention to fraud,known as street,and because the thing dey pay,majority of persons wey no been pick interest from the beginning don dey pick interest now.Oibo people don know us say anytin we wan do,we dey doam well.But the most amazing thing about the stuff be say most of those people wey been don almost dey give up on life,and dem later go embrace yahoo as the huzzle,God no shame dem,e come dey like say na dem dey live well pass.
Abeg make una help me put mouth for this matter.
Na d last hope of a common man be that?or e get any other thing wey dem fit do,we go make dem dey alright like the way Yahoo dey do?
This is a important something to talk about,fraud can never be a last hope of a common man in Nigeria because a man with skills and hand work,that’s focus on into competition with Peer groups will be able to cope a little to achieve his dream.but peer group pressure has now become dy order of the day.
sr. member
Activity: 966
Merit: 391
Underestimate- nothing
God forbid say na yahoo be the last hope of our youth, I no fit even imagine say naim go come be the only thing wey boys go out their head to make living and to feed their family. Tahhh, i reject that kind thing to happen, as e stands now, the wey things dey go, e come dey be like say the street life don dey hard because now, I don dey see some boys wey dey do street don start to resume their normal work, some of them don dey even go far as doing oguaja(helper for house building) or building casting. When I see the thing e shock me, na there I take no say truly street don really hard and before you go know their update go just finish.
I took a seat and considered how far life would push me to commit fraud. After all, we all know how hard it is for people to make ends meet while also trying to feed and take care of themselves, and there is always someone out there who is willing to take advantage of those who are in need of money but don't want to work by robbing them. Is that really fair?  And that is were some people wanting to be making a living from. And what they don't understand is that will they continue to scam people for ever for how long will that be does not make sense at all, to me it better to get involve with genuine way of making money it has benefits of your mind been at rest and even free from police but doing fraud you will always be on a run lets try as much as possible to tell people to say no to fraud
member
Activity: 364
Merit: 44
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
Una go jst dey paint unacef black.
Hw una our image wan carri beta if na onli watin bad we dey always dey yarn at our naija anytym way we open mouth talk! Omo, e no gud o, no b we bad pass bt na d idea way many pple 4 d forum get abt we way b naija nd e dey very bad. Some kind talk eh, mak we dey leave am 4 house.
If na work b ur wahala, fine work or do business, no solution wan com out dis talk except 2 rubbish us d more 4 d eye dem way dey see us 4 here.

U dey mind dem, dem think say if we come out dey paint paint ourselves bad say we for reach were we dey today for the forum. Wait you think say Nigerians self dey hack or scam? We no even sabi work reach man wey dey run package for away but we just dey carry carry head up like say na we we when nothing we sabi. Abeg make una dey create reasonable threads for discussion that doesn't have to be about fraudulent activities and all that, create threads on Bitcoin, how's it affecting the average Nigerian life and how to improve it's awareness, policies by the government etc.

Normally wetin we supposed dey discuss here na wetin go add meaning to our life either e help use financially, educationally or general knowledge and not careless talk wey no go add anything positive to our life. Leave yahoo talk for yahoo boys. You you dey Bitcointallk, talk about Bitcoin na here your own hustle dey. Talk about your own hustle. The more we talk about Bitcoin na the more your knowledge go dey improve because if you no sabi wetin dey sub here you go just hang and when you interact with the general forum, e go just belike you no follow.

Senior your very correct I don't actually know why many deviate from what is required in his field and begin to think of other field issue is very pathetic the nation is our if we say it's good it will be but if we call it evil it will be also I don't practice such but the rate at which will condemn many things regarding our nation here is very bad some nation are worst than naija here, but can't air it I don't support evil but as you have nailed it let focus on our work and leave others even the Bible said life and death choose yea  let us allow them once their spirit condemn them they will turn a new leaf.this is Bitcointalk not yahoo, discussion of yahoo here have no value or any knowledge to be obtained in other to help our mission here.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
God forbid say na yahoo be the last hope of our youth, I no fit even imagine say naim go come be the only thing wey boys go out their head to make living and to feed their family. Tahhh, i reject that kind thing to happen, as e stands now, the wey things dey go, e come dey be like say the street life don dey hard because now, I don dey see some boys wey dey do street don start to resume their normal work, some of them don dey even go far as doing oguaja(helper for house building) or building casting. When I see the thing e shock me, na there I take no say truly street don really hard and before you go know their update go just finish.
member
Activity: 64
Merit: 63
Being law-abiding in a lawless country is considered illegal and this is the current reality of Nigeria. But then, scam (yahoo) cannot be the last hope for the common man. There are a lot of legal enterprises a person can engage in and make ends meet. The reason why most persons have resorted into yahoo is due to the get-rich-quick mentality of most Nigerians. But then, that cannot make us lose sight of the fact that Yahoo is illegal in our country hence it should be abhorred. I will advise anyone with the intention of going into yahoo to channel such thoughts and energy into learning a skill because it pays to have a skill.
Pages:
Jump to: