Oman,,, abi you believe say the transaction fee go high like this for ever?
The way e dey go so,,, I dey sure say this no be the first time way transaction fees done high like this (even though say I be crypto newbie), I still believe say this 9ne no be the first time way transaction fees dey high like this, e fit be say this one own done high pass other ones but as e be say this 9ne no be the only time way transaction fee they high e go still cime down to normal.
Abeg make we no try or in anyway discourage those way done made up their mind to hold their coin till the bullrun and after the bullrun, make we try encourage them to continue and not to think of selling... Like I been talk am before say na to just think of how to protect our coins and not the other way.
Di transaction fee e no go high like di forever but as e be like dis e don pass everyone expectation. And yes di fee e don high before but dis one nai be di highest one. And di matter nu dey keep Bitcoin for wallet, my man you go chop, you go pay bills and other things wey u go like to do but because if di fee you no fit do anything so how you dey feel dis kind of matter? Nobody bed discourage anyone here. Investing in Bitcoin is a personal choice and determination.
Bull run bull run, yes bull run is coming what about di fee. Investing in cryptocurrency is just an understanding oh. If you no calculate well, even in di bull run sef I might not collect your money because of transaction fee. Nd you said say u be newbie for cryptocurrency, nd let me tell you. Many people big men wey I know for the cryptocurrency ecosystem space dey leave Bitcoin dey go other coins dey. In any investment na wisdom, and don't allow Bitcoin to intoxicate u.