My concern is just that a lot of Nigerians may get scammed and defrauded because moving to other exchanges that are not reputable can lead to loss of funds and assets and there is no one to hold accountable, this is really a bad news for me because ever since they banned binance from performing the Naira p2p transactions i moved to kucoin and now that kucoin have been affected as well were do i move to again?
Provided say na centralized exchange wey we dey use, we no get choice as the governments go dey attack dem as dem get to know about them. Governments dem get spy among us wey dey update them on the next exchange wey people dey use dey sell their Bitcoin or usdt to Naira. Scammers go chop Nigerians plenty this periods because alot of newbie wey no understand how some platform dey work go fall victim to scams. E go just better to use local P2P merchants if you get a trusted one than to dey move from one centralized exchange to another because this exchanges fit crash too and them go close with our money
Na how to get trusted local P2P merchant for naija but how person wan take confirm their authenticity, we know of plenty P2P platforms wey been don really make waves for naija as one of the best platforms but today, them no dey again.
Like you talk, even some people wey get these platforms go fit see this as opportunity to take scam some naive people them, since them now know say them no get option and when them see some kyn money wey go enter their system, them go just shut am down or release important information to person wey go enable am to hack the system make e no be say the fault from them so that nobody go accuse them. Na these kyn things we dey see everyday and because of that, even when we see legit ones, we go dey fear to work with them.
The best thing na just fyn better DEX wey dey reputable and dey support P2P, at least person go know say government no fit get access to them or influence them easily like that.
Or better still, find trusted person wey dey outside Naija, even if na the least African country, wey go dey help you dey trade ya coins dey send the money for you via bank transfers. At least that one go dey even better and safer than to dey use these CEXs or P2P platforms. Until this whole government palaba subside, cos I know say very soon, this whole gra gra go end.