Pages:
Author

Topic: Latest Statement from the Nigerian president. (Read 197 times)

full member
Activity: 580
Merit: 108
Make we dey hope for good sha but dis our 9ja need serious pray, the reason for all dis na becus dey dey say no moni to run tins, sha e dey early 2 dey c the outcomes but sha I believe say for every hardship there is easy, make we dey patients. But wetin dey pain me be say 9ja just dey rough becus our lidas only no themselves, and na for 9ja I no say dey no dey catch big thief na y dey dey steal everyday. My tore no dey clear abi wetin I mean be say if dey arrest them dey no dey punish dem na why I talk am say dey no dey catch big thief. I pray make dis new government make a different.
The previous government really spoil things for the country, no employment and besides we no even get weytin we go stand on as our rights because them de violated. Instead of EFCC to target our greedy politicians, instead them de go for our young youths wey de hustle to see food chop, if u see the way dem de pursue youths like say dem thief, the whole matter just tire me. President of Naija, Bola Ahmed Tinubu go do well for this country, moreover e tenure still de early, and we don de experience hardship for the country. We go make am, make we just believe say Tinubu regime go do us well. This country go better, but na time e go take.
hero member
Activity: 1064
Merit: 501
We get no other option than to take am the way we see em government. We Nigerians are survival of whatever bad government that throws at us as citizens. If we can survive Buhari's 8 years of bad government, surely we go survive Tinubu's own no matter how bad it is.

The things we sweet me for this talk na be say the president say make we promote unity and stability and eh no matter if you vote for I'm or not say em go work on behalf of everybody for a turn around of prosperity for we country, although me I no dey believe all this politicians cause to believe them just be like say you wan carry mouth go check if current dey for naked wire wey dey connected to pole, but my own na be say as eh dey claim to bring prosperity for we country make eh remove the ban on Cryptocurrency and make our economy stable as well.
It is Tinubu's one month in office and we have seen him make some changes in his government since em enter office. It is possible sae we go later the see prosperity for em government if to sae em creates a lively and secure environment wey go attracts investors, more especially if em go fit fix insecurity problem and power supply. If he can get that done, investors go find their way here. Although em no go d easy to fix this country within a short time because of the damage wey d previous government don cause for the country. So much is to be done for the country and believe some day things get fixed one after the one.
hero member
Activity: 756
Merit: 508
The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID

My only prayer be say make this government improve the country rather than take it to a new low compared to Buhari. For now, those policies never yield any outcome but e still dey early.

Which policy we dey expect to yield out come? We no even no wetin dey happen. This government dey make things dey difficult. How you go comot subsidy and also increase electricity tariff to even 40% . I never see the rational behind these two policies upon say no palliative was provided oo. Nigerian masses strong no be small because as government dey make life difficult no be here. Them go promise you heaven and earth but after the promise nothing go follow.
Make we dey hope for good sha but dis our 9ja need serious pray, the reason for all dis na becus dey dey say no moni to run tins, sha e dey early 2 dey c the outcomes but sha I believe say for every hardship there is easy, make we dey patients. But wetin dey pain me be say 9ja just dey rough becus our lidas only no themselves, and na for 9ja I no say dey no dey catch big thief na y dey dey steal everyday. My tore no dey clear abi wetin I mean be say if dey arrest them dey no dey punish dem na why I talk am say dey no dey catch big thief. I pray make dis new government make a different.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino

My only prayer be say make this government improve the country rather than take it to a new low compared to Buhari. For now, those policies never yield any outcome but e still dey early.

Which policy we dey expect to yield out come? We no even no wetin dey happen. This government dey make things dey difficult. How you go comot subsidy and also increase electricity tariff to even 40% . I never see the rational behind these two policies upon say no palliative was provided oo. Nigerian masses strong no be small because as government dey make life difficult no be here. Them go promise you heaven and earth but after the promise nothing go follow.
hero member
Activity: 2212
Merit: 805
Top Crypto Casino
Have been trying to compare the administration of Buhari and that of Tinubu, I still have better faith in Tinubu's administration than that of Buhari that claims transparency but coming to power lacks the qualities and competency to rule, I noticed something that will happen in this administration is that most of the decisions that the president will make will not be in favor of the citizens but will be better for the country, no pain no gain and with time people will adjust, I remember some weeks ago he made a statement about whatever decision he makes he will not change it, and the most interesting part is the foreign investors it will improve the economy and also create job opportunities for youths, let wait and see what happens next. we all hope for a better Nigeria.

E dey simple to talk especially since na the same tape wey Buhari been play for us before and during him government. Most of him own policies have been no dey welcomed by we country people yet e been still no dey favourable for us - the cost of living tripled, unemployment rate always dey high and minimum wage stable. For all these new policies and removed subsidies, Any idea where Tinubu government go funnel all the money meant for these things?

My only prayer be say make this government improve the country rather than take it to a new low compared to Buhari. For now, those policies never yield any outcome but e still dey early.
sr. member
Activity: 1218
Merit: 279
Anytime I see comments, e clear for my eye say dem people no sabi wetin dey happen for Nigerian politics. Tinubu dey get power, e fit control anybody with money and fear, e no send anybody wey no gree do as e talk. I believe say na only the generals and people from the North fit stop am, but unfortunately, dem dey fight among themselves pass before. Tinubu dey do anything e like, even when e dey against the law, nobody fit touch am, even if police dey.

Plenty corrupted leaders full for country, but one day, things go better for the country, na our hope be that. President Asiwaju Bola Ahmed Tinubu not get shaking as e tell nigerians say e remained the commando for Naija, and nobody fit do anything about am. We just de observed how e government de rule, e b like say things go better for the country. Afterall make we never jump into conclusions yet, e tenure never reach anywhere, make we continue to de observe. Wahala full for the country currently, like the massive increase for fuel as the presido remove fuel subsidy, nigerians de complain bitterly, especially the common man, to see food chop na problem no to talk of to buy fuel.
sr. member
Activity: 2240
Merit: 270
SOL.BIOKRIPT.COM

To some point, i come dey feel like say you be APC member 😁 but the truth remains that JAGABAN na our president  wedding we like am or not and him decisions go always be finally for we country so rather than wanting to fight, make  work with to unify the country and see if e fit better through that means.

See this talk wey u talk so near the truth but the truth be say, we fit challenge the government if the laws no go favour the citizen. Shae be the law na for the betterment of the country, why we go bear wetin pass us. I believe say we get senate house, so them go dey check every of ihn request before them go approve am. Thank God say power no dey monopoly for any leader hand , if not e no go dey easy.

And opposing party wey Inec make loose suppose walk with the government wey later win after their court case. Their working should be to support their good decision and to question their bad desicion in the form of check and balances

Anytime I see comments, e clear for my eye say dem people no sabi wetin dey happen for Nigerian politics. Tinubu dey get power, e fit control anybody with money and fear, e no send anybody wey no gree do as e talk. I believe say na only the generals and people from the North fit stop am, but unfortunately, dem dey fight among themselves pass before. Tinubu dey do anything e like, even when e dey against the law, nobody fit touch am, even if police dey.

member
Activity: 388
Merit: 30
Reward: 10M Sheen (Approx. 5000 BNB) Bounty

To some point, i come dey feel like say you be APC member 😁 but the truth remains that JAGABAN na our president  wedding we like am or not and him decisions go always be finally for we country so rather than wanting to fight, make  work with to unify the country and see if e fit better through that means.

See this talk wey u talk so near the truth but the truth be say, we fit challenge the government if the laws no go favour the citizen. Shae be the law na for the betterment of the country, why we go bear wetin pass us. I believe say we get senate house, so them go dey check every of ihn request before them go approve am. Thank God say power no dey monopoly for any leader hand , if not e no go dey easy.

And opposing party wey Inec make loose suppose walk with the government wey later win after their court case. Their working should be to support their good decision and to question their bad desicion in the form of check and balances
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Snip.

Menh that is the problems with these old men most times they speaks out of mind and senses, sometimes is what their daughter tells them or son gives them they implement because they felt their children is the best and may want to use that format to implement on their government. Sincerely speaking, any country ruled by old men is known to be "gerontocracy" and we are no longer in those days were we would be subjugated by some certain group of men trying to induced young adults to obey their old way of ruling and leadership. I believe in Nigeria my country were we need a vibrant young man who would know the heart of every young teenage to expedite the growth of the country.
.
Nevertheless this old men dey act from instructions their children give them and I couldn't agree any less with you for this matter and one thing I know be say we been don loss one chance for the young to stay in power and that was after Jonathan left office and na only prayers we don fall back to now and we dey believe  say God go liberate us soon.

 My brother, make I tell you something, I know say them they preach to us for our various churches say prayer is the key but wetiln Nigeria dey go through don pass prayers because we citizens don dey pray right from burahi tenor, abi God no for done answers our prayers since then? wetin i dey try talk be say the change of Nigeria according to the ruling party begins with everyone and we as citizens need to do the right thing and remove all the bad politicians wey ďey cause problems for our country from power, God no go come down from heaven come remove them, atleast if our security personnels stop to collect bride from politicians and fight against those hoodlums wey snatch ballot box for elections Nigeria go better, if all inec recs go be like that woman for Abia state, (Nnenna oti) wey no gree collect bride even after they offer her all sorts of money Nigeria go better, if some greedy citizens stop to sell their votes for peanut money and vote for the right candidate with their clear conscience Nigeria go better.
 To be honest we need young and vibrant men wey dey ready to work and wey carry the opinion of the citizens at heart, all this old men done too promise and fail the youths of this country. A nation they grow well when the youths  dey function well for each sector of the country, but for our own case we get one of, if not the highest population of youths for Africa but our labour market they suffer because no jobs, high unemployment rate and cost of living don lead our youths to cyber crime, kidnapping and prostitution just to survive, nowadays hookup done turn to normal thng for average Nigerian girls due to unemployment, so my brother it's high time we stop this hypocrisy life of praying and going back to our bad ways of selling our rights in elections, time done reach wey we go do the right thing. However let's still keep our fingers crossed and hope this tinibu regime go better.

This is called "Medicine after death"
I wouldn't want to dive deeper into this as this isn't a reflection to what op is say but we must know one thing for sure that changing of rulership and leadership are in our hands. I believe we aren't in an autocratic (autocracy) leadership.

Prayers has gone a long way but the ability for us
to activate our prayers lays in our hands also, let say "God bless me, God bless me" how do you want God to blessed you without you having a Job at hand to work. Note that God blesses man through the works of thy hands, so it's to us that has been praying for our country to change.

God already answered our prayers by providing PVC for us but the ability for us to make a better use of our PVC is when our prayers would be activated.
full member
Activity: 322
Merit: 211
Snip.

Menh that is the problems with these old men most times they speaks out of mind and senses, sometimes is what their daughter tells them or son gives them they implement because they felt their children is the best and may want to use that format to implement on their government. Sincerely speaking, any country ruled by old men is known to be "gerontocracy" and we are no longer in those days were we would be subjugated by some certain group of men trying to induced young adults to obey their old way of ruling and leadership. I believe in Nigeria my country were we need a vibrant young man who would know the heart of every young teenage to expedite the growth of the country.
.
Nevertheless this old men dey act from instructions their children give them and I couldn't agree any less with you for this matter and one thing I know be say we been don loss one chance for the young to stay in power and that was after Jonathan left office and na only prayers we don fall back to now and we dey believe  say God go liberate us soon.

 My brother, make I tell you something, I know say them they preach to us for our various churches say prayer is the key but wetiln Nigeria dey go through don pass prayers because we citizens don dey pray right from buhari tenor, abi God no for done answers our prayers since then? wetin i dey try talk be say the change of Nigeria according to the ruling party begins with everyone and we as citizens need to do the right thing and remove all the bad politicians wey ďey cause problems for our country from power, God no go come down from heaven come remove them, atleast if our security personnels stop to collect bride from politicians and fight against those hoodlums wey snatch ballot box for elections Nigeria go better, if all inec recs go be like that woman for Abia state, (Nnenna oti) wey no gree collect bride even after they offer her all sorts of money Nigeria go better, if some greedy citizens stop to sell their votes for peanut money and vote for the right candidate with their clear conscience Nigeria go better.

 To be honest we need young and vibrant men wey dey ready to work and wey carry the opinion of the citizens at heart, all this old men done too promise and fail the youths of this country. A nation they grow well when the youths  dey function well for each sector of the country, but for our own case we get one of, if not the highest population of youths for Africa but our labour market they suffer because no jobs, high unemployment rate and cost of living don lead our youths to cyber crime, kidnapping and prostitution just to survive, nowadays hookup done turn to normal thng for average Nigerian girls due to unemployment, so my brother it's high time we stop this hypocrisy life of praying and going back to our bad ways of selling our rights in elections, time done reach wey we go do the right thing. However let's still keep our fingers crossed and hope this tinibu regime go better.
legendary
Activity: 2478
Merit: 4341
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
This na tori wey dem talk on Saturday  from the spokesman of the president Dele Alake, wey talk say the president talk I'm during em talk talk Section with members of the Nigerian community wey dey leave for France. The things wey sweet me for this talk na be say the president say make we promote unity and stability and eh no matter if you vote for I'm or not say em go work on behalf of everybody for a turn around of prosperity for we country, although me I no dey believe all this politicians cause to believe them just be like say you wan carry mouth go check if current dey for naked wire wey dey connected to pole, but my own na be say as eh dey claim to bring prosperity for we country make eh remove the ban on Cryptocurrency and make our economy stable as well.

Stories for the gods, who remember when Buhari talk say him dey for everyone and for nobody. All this one na just political talk nothing dey the talk. Weather na true or not wey the president they talk nothing we go fit do but to accept am as our leader unless Peter Obi do magic for that count house because if we dey tell ourselves the truth we no get judiciary for Nigeria as dem just dey like police officers. Na so so bribery just full there. Wetin you been dey expect obviously, him go wan promote peace because na the only way wey him go fit enjoy him government. For me tinubu reign dey alright sha so far just dat subsidy wey still dey worry but I believe e go dey resolved soonest.

Make tinubu forget all this waka waka make him no turn to Buhari. Wetin concern is with people wey dun japa, na we here know as the thing dey do us so if him wan address make him call a town hall (different, sorry I just gas talk am) but joke apart make him call use for town hall address us no be people wey dey France. Tinubu just dey sign sign bills (e no bad) but make him begin address Nigerians on wetin him go do to help this subsidy matter because na that one people dey see the impact not the other bills dem wey him dey sign. Dat fuel price increase so dun shake ground wella and things price dun dey go where I no know.
hero member
Activity: 2660
Merit: 630
Vave.com - Crypto Casino
All those talk na bobo talk. An innocent person fears no accusation. Him sabi say him no win the election by no means, na him and INEC follow run wetin him do on to say some people feel say dem go do as them like. Because no be him win be the reason wey make all him line for speech dey enter on the votes,on who vote for him or not. Make him make speech wey make sense, abi we hear anything wey him to for france for the summit, if no be so so greet him dey greet people. E easy to run the government but the thing be say dem dey carry d thing do business. Na ball dem dey play that's why they are not sincere. When they enter the place na the money dem spend for election dem dey arrange to collect by every corrupt way and before you say jack another election time don appear.
sr. member
Activity: 2240
Merit: 270
SOL.BIOKRIPT.COM
Tinubu sef, e dey do plenty politicking pass administration and me I dey reason say na because of dat tin, e don already make decision wey dey somehow. Dem policies fit better the country for long run, but plenty decisions dey like say dem dey put horse for front of cat. E wan chop all the glory for some decisions before e even inaugurate e advisors and ministers. Subsidy fit wait till July when Dangote refinery go start, e fit sef make currency dey float when dollar don dey circulate well-well. E never easy to live for Nigeria now with all these sharp increases for everything.
hero member
Activity: 602
Merit: 442
A Proud Father of Twin Girls 👧 👧
Snip.

Menh that is the problems with these old men most times they speaks out of mind and senses, sometimes is what their daughter tells them or son gives them they implement because they felt their children is the best and may want to use that format to implement on their government. Sincerely speaking, any country ruled by old men is known to be "gerontocracy" and we are no longer in those days were we would be subjugated by some certain group of men trying to induced young adults to obey their old way of ruling and leadership. I believe in Nigeria my country were we need a vibrant young man who would know the heart of every young teenage to expedite the growth of the country.
Gerontocracy?
This na one big word  i never hear before to be frank and I had to use google search am and aswear you sabi book😁
Congratulations  on your dedication and I believe say you go be one of the parents wey no go want make their children go through  any of this shits the country dey make us face.
Nevertheless this old men dey act from instructions their children give them and I couldn't agree any less with you for this matter and one thing I know be say we been don loss one chance for the young to stay in power and that was after Jonathan left office and na only prayers we don fall back to now and we dey believe  say God go liberate us soon.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
@Adbitco my brother this matter tire me and to an extent any news wey dey fly like  this be it verified or not, dey mostly dey true and this tinubu sometimes dey hard to predict because una fit get close door meeting and agree on something, baba go just comot talk the one wey dey him mind.
I've heard several news of his aim and I've seen some.good and bold steps he has taken but make him no use one bad spoil the things he don dey do since he enter.

Menh that is the problems with these old men most times they speaks out of mind and senses, sometimes is what their daughter tells them or son gives them they implement because they felt their children is the best and may want to use that format to implement on their government. Sincerely speaking, any country ruled by old men is known to be "gerontocracy" and we are no longer in those days were we would be subjugated by some certain group of men trying to induced young adults to obey their old way of ruling and leadership. I believe in Nigeria my country were we need a vibrant young man who would know the heart of every young teenage to expedite the growth of the country.
hero member
Activity: 602
Merit: 442
A Proud Father of Twin Girls 👧 👧
Ah make we take things very easy abeg and from my understanding  of wetin op dey try write, he dey talk say since him don dive into crypto, and the government don already promise a whole lot of things, say in everything  tye government go do, make them try comot the ban on crypto  and also try improve the national economy.
but my own na be say as eh dey claim to bring prosperity for we country make eh remove the ban on Cryptocurrency and make our economy stable as well.
@mate2237 make we dey try take things easier with all this newbies because you too don pass through this process and you know as e dey be but whatever the case might be, if you read the quote above you go understand  day the word "AND" dey inside op talk which means say removing ban on crypto  and entirely different wish and improving or making the economy stable na another entirely different wish.

@Adbitco my brother this matter tire me and to an extent any news wey dey fly like  this be it verified or not, dey mostly dey true and this tinubu sometimes dey hard to predict because una fit get close door meeting and agree on something, baba go just comot talk the one wey dey him mind.
I've heard several news of his aim and I've seen some.good and bold steps he has taken but make him no use one bad spoil the things he don dey do since he enter.

The president said what he is expected to say because irrespective of the party we all voted for, he emerges the winner and has already been announced, therefore we need to cope with all he will be doing because he is our leader.

Uniting Nigeria is what all the aspirants wants because this our country needs unity in order to succeed.
Although the president get plans for us but if we they divided him and the other leaders no fit do am alone that means they need our support.

To some point, i come dey feel like say you be APC member 😁 but the truth remains that JAGABAN na our president  wedding we like am or not and him decisions go always be finally for we country so rather than wanting to fight, make  work with to unify the country and see if e fit better through that means.

Op aswear this picture enter my eyes and na this picture attract to make comment for your thread and you don earn one merit for this picture as at least I don get picture I fit present show person say na my president because the official portrait dey too obvious say na editting.
hero member
Activity: 1428
Merit: 653
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
How did he wants our country to prosper while i was hearing he is intending to increased the politician salaries from it was to another bigger amount while we have something to fixed with money, there is serious hunger in the country and yet i don't see anything to be working out properly or do i say since he barely spent time on the sit or what?
As a visionaries, his first target is cut down the expense rate of politician bicus believe they are the number one people bring down our nation, menh the money those guys spend in monthly are do enough to build a factory every months with this youth would get empowered there will be less hunger in the country kidnapping, killing and retualist might reduce as well due to everyone is occupied working and earning a living but yet what they are planning currently is to increase the politicians salaries...
please had anyone heard about this same news if you do kindly update us properly because we need to follow what is happening in this country.
full member
Activity: 322
Merit: 211
Op nawa for u oo. Weti concern Bitcoin ban with stable economy in the country. Op this your thread nothing come out, so now u dey tell us sae everything do president tok for this country u g o dey come here and tok and create thread on top. Nawaoo!!!. Abeg Bitcoin has nothing to do with Nigeria economy. If di president unbanned or lift the ban of Bitcoin from banks the economy will still be the same. All what we need is to bring back the economy of Goodluck period. If the president unbanned and adopt Bitcoin, the stability of the country economy is still far from the reality. And what the president has to do first is to stabilize the economy before any other things. If not he will be fighting for vain.
I no think say you understand wetin I talk for my post maybe in a haste you rush glance through then reply, but if you observe closely you go see say once person don put (and) for em statement eh mean say na two things eh dey talk about, one for our presido to lift the crypto currency ban and two to and make our economy stable.

 However in as much as you no understand, the lift on Cryptocurrency ban get a big role to play in helping our Nigerian economy.
1 eh go create employment
2 since our money no dey affect the price of bitcoin eh go fit help to reduce the rapid growth of inflation if we adopt am.
3 eh go serve as another means of saving and investment for citizens.
4 eh go create jobs for some citizens whereas reducing theft.
5 eh go serve as a faster means of transaction for the  business sector
6 eh dey safe and trustworthy so schools, banks, hospitals, church and other sectors go adopt I'm as another means payment.
These na all the ways and many more wey the lift on cryptoban fit help our economy grow.
 
 Yes our presido fit get other agenda wey em wan look into but that na my own suggestion and I for like make eh look into that on the long run as well. All of us know say eh no fit tackle everything at once so we go keep our fingers crossed and hope say eh go do the right thing to make our country better.
abi you no go happy if eh remove the cryptocurrency ban?
hero member
Activity: 1022
Merit: 744
The things wey sweet me for this talk na be say the president say make we promote unity and stability and eh no matter if you vote for I'm or not say em go work on behalf of everybody for a turn around of prosperity for we country, although me I no dey believe all this politicians cause to believe them just be like say you wan carry mouth go check if current dey for naked wire wey dey connected to pole, but my own na be say as eh dey claim to bring prosperity for we country make eh remove the ban on Cryptocurrency and make our economy stable as well.
The president said what he is expected to say because irrespective of the party we all voted for, he emerges the winner and has already been announced, therefore we need to cope with all he will be doing because he is our leader.

Uniting Nigeria is what all the aspirants wants because this our country needs unity in order to succeed.
Although the president get plans for us but if we they divided him and the other leaders no fit do am alone that means they need our support.

Them no ban Cryptocurrency, them just want make we they safe so that country men no come de complain say dem scam them na why the country de try put some regulations on top cryptocurrency before dem go fit legalize am.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com

Jump to: