Not totally true because all cryptocurency follows Bitcoin and when you dey diversify you no support diversify for a related market. Assuming altcoins get their own trend and Bitcoin get e own then investing in altcoins when you wan diversify for dey make sense but since na Bitcoin dey control the whole market, anything wey happen to Bitcoin go still happen to altcoins so e just better to stick to Bitcoin. If you wan Invest for altcoins make e be say you wan just gamble or play with your spare money dem make you no go put for mind say you wan diversify. To diversify well you fit invest for landed properties like land or buy houses and rent am out. You fit still invest for the Nigeria stock market as people dey make better block from their.
Any discussion wey you want for the board, you need to initiate am just as you dun do because na wetin people see wey dem go comment on. All discussion dey encourage here because we get something to learn from everything. I just hope e no go get buried like my own wey I been create Altcoins Speculation thread: What projects are you observing to invest & why. truth be say you fit make money from anything wey dey this industry but the risk for some no worth am like chasing after all those shitcoins dem wey na mostly decentralized exchange dem dey trade. Make we dey careful and a safe option na just to stick with Bitcoin but dat one no mean say you no fit profits from altcoins.