Pages:
Author

Topic: Life is precious - page 2. (Read 346 times)

jr. member
Activity: 70
Merit: 4
January 14, 2024, 10:19:15 AM
#17
My brother na truth you dy tlk so, life dy very important, na only person wey don die wey no get Hope again, and secondly that lady wey go commit suicide I just feel say she no dy really tell us wetin she kill herself for, because as a naija blood wey I be,  I no say we no sabi surrender, expecially to difficult living conditions, so for her to surrender and kill herself like that, e get wetin she no tell us, because hard times In naija now na normal thing.

E fit no dey natural sef... i no wan go far but suicide itself no be something wey dey natural. I still go with wetin you talk something no clear at all.
hero member
Activity: 616
Merit: 713
Don't joke with my Daughter
January 14, 2024, 09:33:31 AM
#16
People wey dey take their lives na people wey wan just used one day explode their life without even sowing for one day I believe say life hard but e get plenty opportunity wey dey online and offline the main thing be say make we just discovered where our talent be the explore more better than taking our previous lives. If we plan well we go end well because people no go seat down one place dey want make manner from above come land their head to become person wey dem no even plan for, na wetin make we dey see plenty evils and bad people everywhere dem plan to get money by then engaging themselves in evil activity, and how on earth would someone took his life because say tins never pure now you want just take ur life even say some people dey meet up some dey do all forms of business to carry meet up life yet them no kill themselves
full member
Activity: 232
Merit: 194
January 14, 2024, 09:08:05 AM
#15
Good morning and happy New year my people...We are still in the spirit of new year though hustle don start ✌️✌️
The matter wey I bring come goes like this...I dey see...dey hear how people dey take their own lives after the much hustle just because their hustle never pay.. but una go agree with me say life na precious thing... cause na who dey alive go fit eat the fruit of his/her labour (investment)
Most of us go don see the post about that lady for Lagos wey dey work for bank wey take her own life .. according to her say economy don too bad ...she no see any bright future but people in this same economy dey build houses.. buying cars... businesses are doing well.So even as the year don begin and as we Don start our investment make we no still rush to get profit now now so that we no go use pressure go kpai ourselves...life sweet🙌🙌 and na only one dey,,,make we think am

This matter of people taking lives is so serious nowadays. People are just taking their lives for one or two seasons. But all I have to say is that all those reasons given aren't worth taking their lives.
 
Let us know that if we are hustling and hustling, never pay us. No mean, say the hustle; no go pay us one day. The truth be there is that not all of us go make it at once; everyone has it own time that he or she will make it. Let us believe that our destiny is different, so let us believe Mr. A destiny may be picked today and Mr. B destiny is going to be next tomorrow. That is why we need to be patient enough in whatever hustle we take on, because tomorrow may be our turn for bliss.
 
The woman who take her life now says that she does not see any future at her side, but how did she know that? It is because she has been working for a long time and has never achieved anything. I believe that because she is comparing herself to people who have much more than her, that is the reason why she was going through all the depression and reaching a level where she could take her life. I believe there are some people who are looking for an opportunity like her just to be working the bank but they don't get  what is even less than that. Now that she have taken her life What is going to be her gain now? In both Muslim and Christian terms, if someone takes his or her life, it is a sin in whatever depression much is passing through.
full member
Activity: 588
Merit: 119
Epsiloan Protocol
January 14, 2024, 07:59:21 AM
#14
Yeah, seriously most people just want quick money, like now-now money, the truth is that you go still work before the money go come, and even if the hustle never pay now no mean say pay-day no dey.

This is why we see a lot of internet fraudster today in the country. Most youths are not ready to work but want to live a good life. Most times when this internet fraudsters spend money, you get so concern and think you that base on earn on your labour aren't doing the right thing. Just like you have said, one hustle may not pay today but will definitely do one day.

My own advice nah to stick to the the plan and keep the hustle on cause for sure one day the pay go come despite the hardship for we country, peace ✌️.

This comes with endurance and patience. And this is what most youth of nowadays lack. But for those that can stick to this, I believe they will still make it big one day.
jr. member
Activity: 33
Merit: 1
January 14, 2024, 05:29:49 AM
#13
Yeah, seriously most people just want quick money, like now-now money, the truth is that you go still work before the money go come, and even if the hustle never pay now no mean say pay-day no dey.

My own advice nah to stick to the the plan and keep the hustle on cause for sure one day the pay go come despite the hardship for we country, peace ✌️.
full member
Activity: 560
Merit: 161
January 14, 2024, 05:02:01 AM
#12
People must understand this in life that everybody get their time. The people wey you see wey dey build houses and buy cars so you know what they have gone through in life? Do you know their stories? The heavy challenge and temptation?  Ask yourself if you go fit bear wetin them see before now wey dem never get wealth. Make we no just conclude say na your own worst pass when you see people wey don make ahm for life. Everybody get their time , so just know say your own time dey come too.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
January 13, 2024, 05:40:56 PM
#11
Good morning and happy New year my people...We are still in the spirit of new year though hustle don start ✌️✌️
The matter wey I bring come goes like this...I dey see...dey hear how people dey take their own lives after the much hustle just because their hustle never pay.. but una go agree with me say life na precious thing... cause na who dey alive go fit eat the fruit of his/her labour (investment)
Most of us go don see the post about that lady for Lagos wey dey work for bank wey take her own life .. according to her say economy don too bad ...she no see any bright future but people in this same economy dey build houses.. buying cars... businesses are doing well.So even as the year don begin and as we Don start our investment make we no still rush to get profit now now so that we no go use pressure go kpai ourselves...life sweet🙌🙌 and na only one dey,,,make we think am
Me self i dey reason that matter, because how on earth person go end in life because of hardship? Hardship na something wey be say na normal thing for the country. people don dey use to am, and we no sopos to dey take am to another level. No matter wetting happen, we all go still die according to comment wey I see for the comment section of that young lady wey take her life. Even as people dey complain say money no dey for the country, opportunity still dey wey people dey carry chop but na lack of opportunity Naim dey make people make unnecessary decision. Because if she dey aware of another alternative to make am, she for no try am. So make we no take our life because of unnecessary things.
sr. member
Activity: 504
Merit: 421
Top Crypto Casino
January 13, 2024, 04:46:51 PM
#10
I read the suicide note, I just feel bad because di job wey she occupy na anoda man prayer point. Many people dey pray make God bless dem with di same job so dat dem go fit try put food for their table, she go kill herself say di country hard. As a teller or customer care, she fit dey earn N80k - N150k depending on di bank. She fit take di salary hold body small small, dey look for anoda job or start a business. People dey wey be breadwinners of their families and dem dey earn N20k - N30k, dem never kill themselves. So no matter how bad di economy be, suicide no be di answer.

full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
January 13, 2024, 02:20:03 PM
#9
Good morning and happy New year my people...We are still in the spirit of new year though hustle don start ✌️✌️
The matter wey I bring come goes like this...I dey see...dey hear how people dey take their own lives after the much hustle just because their hustle never pay.. but una go agree with me say life na precious thing... cause na who dey alive go fit eat the fruit of his/her labour (investment)
Most of us go don see the post about that lady for Lagos wey dey work for bank wey take her own life .. according to her say economy don too bad ...she no see any bright future but people in this same economy dey build houses.. buying cars... businesses are doing well.So even as the year don begin and as we Don start our investment make we no still rush to get profit now now so that we no go use pressure go kpai ourselves...life sweet🙌🙌 and na only one dey,,,make we think am
Normally,, no be she be the only person way life done show shege, I believe say one day table go turn for everyone way dey do legit hustle, so for a person to take his or her life is something that's not good in the eyes of many and in the ears of anybody way go hear ram.
As long as say person dey work and and em no dey dey hungry, em suppose to thank baba God because many other people for some locality dey find any job way to fit dey give them even if say nah 10k per month them no dey see and even good them no dey see but them still dey alive till today hoping say one day things go change for good.
As I read the news I just tyre because no be better thing way the woman do to her self because as she done pkie go now even the money she no get, so nothing still change.

Na now I just dey see the post of the lady wey go kill herself, to me the excuse wey she give no dey worth killing herself. Just because she no dey do well. But the most important thing na be say she been still dey for the bank dey work as marketing staff, Dem never even sack her naim she dey go kill herself. Now she go just leave her papa, mama and siblings with tears for their eye. Infact nothing for this life worth killing yourself for, because where you think say your own bad, you go definitely see person own wey bad pass.
sr. member
Activity: 266
Merit: 217
January 13, 2024, 02:12:53 PM
#8
Good morning and happy New year my people...We are still in the spirit of new year though hustle don start ✌️✌️
The matter wey I bring come goes like this...I dey see...dey hear how people dey take their own lives after the much hustle just because their hustle never pay.. but una go agree with me say life na precious thing... cause na who dey alive go fit eat the fruit of his/her labour (investment)
Most of us go don see the post about that lady for Lagos wey dey work for bank wey take her own life .. according to her say economy don too bad ...she no see any bright future but people in this same economy dey build houses.. buying cars... businesses are doing well.So even as the year don begin and as we Don start our investment make we no still rush to get profit now now so that we no go use pressure go kpai ourselves...life sweet🙌🙌 and na only one dey,,,make we think am
Normally,, no be she be the only person way life done show shege, I believe say one day table go turn for everyone way dey do legit hustle, so for a person to take his or her life is something that's not good in the eyes of many and in the ears of anybody way go hear ram.
As long as say person dey work and and em no dey dey hungry, em suppose to thank baba God because many other people for some locality dey find any job way to fit dey give them even if say nah 10k per month them no dey see and even good them no dey see but them still dey alive till today hoping say one day things go change for good.
As I read the news I just tyre because no be better thing way the woman do to her self because as she done pkie go now even the money she no get, so nothing still change.
newbie
Activity: 28
Merit: 1
January 13, 2024, 01:09:40 PM
#7
People think say nah the way life keep them nah the way them go live am, brothers no be so e be now, nah the way you keep life nah the way you go live am... maybe people don make wrong movement because they feel say life no fit walk for them again, same goes to suicide,so many people don kill theirselfs Because of things way no work out for them. so abeg make we try to dea feel lively because life no dea two, make we just know say we dea try at all cost
Think positive at times because nah who help himself god dea put him hand to help also, so abeg make we dea try for ourselves.
member
Activity: 154
Merit: 33
Eloncoin.org - Mars, here we come!
January 13, 2024, 11:34:19 AM
#6
The frustrations the economy has for the vulnerable is just being managed by grace. It is not easy for responsible persons with responsibilities to tolerate and just smile over the harden situations.
Although life itself is a treasure while the rest of it are pleasures so, let's have hope that there is possibilities of better changes in a nearest because the bases of the economy would definitely not remain the same.
First we must be grateful for the life we have today's atleast with the insightments that there are people who are financially better than us and yet they died while we still lives.
If only we would live to appreciate the live we have today, there is a hope of glory in breaking through other substances of sustainabilities.
full member
Activity: 1190
Merit: 126
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!
January 13, 2024, 11:07:56 AM
#5
Quote from: Peter Faith
but una go agree with me say life na precious thing... cause na who dey alive go fit eat the fruit of his/her labour (investment)
Most of us go don see the post about that lady for Lagos wey dey work for bank wey take her own life
Who no go agree wit u for dis one bro, life too sweet dat is why u dey see women and men dey use all their strength dey hustle to ensure their life dey save for dem to eat d fruits of their labour. Assume person go fit live reach 200 years on earth and healthy to enjoy dis hustle wey we dey hustle in dis Bitcointalk.org forum to grow your account to reach legendary, so dat u go no say u plant something wey u go dey harvest money weekly to refresh yourself to continue looking younger in d society.

Quote
So even as the year don begin and as we Don start our investment make we no still rush to get profit now now so that we no go use pressure go kpai ourselves...life sweet🙌🙌 and na only one dey,,,make we think am
See newbies, members, full member, hero and legendary in dis local board dey give me joy and I no see anything wey go make me take my precious life wey God give me for free, All those ones wey den dey take their life anyhow in d country, I think say na lack of orientation dey make dem do dat thing to themselves.
full member
Activity: 266
Merit: 113
January 13, 2024, 02:32:09 AM
#4
.I dey see...dey hear how people dey take their own lives after the much hustle just because their hustle never pay.. but una go agree with me say life na precious thing... cause na who dey alive go fit eat the fruit of his/her labour (investment)
wetin go make we kpai myself because say hustle never pay? For the few years I don stay for this life, I don observe say if God wan come through for you eh, within one day e fit change you from no shishi to owning millions. Even if e choke, as long as you are working and doing your best, it will only take time and everything go set. I know see hustling not payingas something reasonable to make someone take his life.

Most of us go don see the post about that lady for Lagos wey dey work for bank wey take her own life .. according to her say economy don too bad ...she no see any bright future but people in this same economy dey build houses.. buying cars... businesses are doing well.
when I read that suicide note, e just de like say make o tear that girl slap. What's strange about the economy being bad? As she kill herself now e change anything about the economy?

Except their is another thing she is going through that she did not include in her note if not I think those reasons for taking her life is too shallow. You are even opportune to be working in the bank, what happens to the ones that have never entered the bank before? Some people have stayed their whole life in the village I hunger and frustration

full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
January 13, 2024, 02:07:43 AM
#3
Person wey go kill emself because of this economy naim do emself oo, them say " as long as there is life hope dey". So why kill your self, though I never see that kind post but, banker work na one of the work wey plenty unemployed people dey find wey to get, see finish naim make her kill herself no be life. Nothing for this life they precious reach the life wey God give you, because if you lost am, e don go be that, nothing fit bring am back. Beside if people fit survive wey their own worse pass, how come you no go fit survive too?
full member
Activity: 196
Merit: 123
January 13, 2024, 01:53:21 AM
#2
My brother na truth you dy tlk so, life dy very important, na only person wey don die wey no get Hope again, and secondly that lady wey go commit suicide I just feel say she no dy really tell us wetin she kill herself for, because as a naija blood wey I be,  I no say we no sabi surrender, expecially to difficult living conditions, so for her to surrender and kill herself like that, e get wetin she no tell us, because hard times In naija now na normal thing.
newbie
Activity: 29
Merit: 2
January 12, 2024, 07:44:43 PM
#1

Jump to: