IMG source link:
https://t.me/bitcoin/11524Normally, when I see this picture Na laugh Naim I first laugh because Na exactly Wattin dey happen for this out current Bitcoin age so. Bitcoin investment fit look like say e easy, but those wey dey truly hold know Wattin I dey talk about, especially for this our economy wey you fit don budget your spending for the month finish Las las the money no come reach, you go come go back to your wallet to collect small again, because you no go fit dey allow hunger finish you while money dey one corner dey steam. Though guiding dey important but e no easy. Back to Wattin I been dey talk, some persons when dem see how successful you have become, dem go say Na luck em get, dem no dey know how difficult e dey and how tempting e dey to still dey hold your coin doing bull run, or when heavy problem burst your dormot, both with the evil wey some of our leaders dey with this p2p matter with exchange, all this Na discouragement wey fit make person sell en coin chop finish.
All those person wey start to hold since the start of Bitcoin creation till now, wey get enough Bitcoin, I applaud una because e no easy, with all the criticism from sec and talk wey people been dey talk that time say Bitcoin Na scam, Las las Bitcoin survive until now,
so many early Bitcoin critics are now huge Bitcoin enthusiasts today, even SEC wey been dey disturb, today now dem dey give bitcoin em maximum so my brother no let any Body deceive you say bitcoin go soon crash or anything bad go happen.
To round up everything wey I don talk, e no easy to hold Bitcoin especially for this our current condition wey we dey pass through, but make you try your best so that after a decade from now, we ourselves fit look back laugh for everything wey happen throughout our holding journey.