so to go straight to the point my friend who is a bit new to crypto-currency was telling me about here experience sell her Bitcoin a popular exchange she has already understood some of the basic on how to sell but this Time while selling the buyer asked for here number which she gave and then chatted her demanding that they trade outside the exchange, and even offered a higher deal than the exchange. this is a big red flag because you a vulnerable to getting scammed if you are trading with someone you don't know off the exchange no matter how juicy the offer is.
I figure out say for this our industry, wetin dey mostly kill people and wetin dey mostly make people fall victim to all these cheap scams nah GREED. People just too get big eye and scammers don notice am so them go use am as advantage and if you no take time, you go fall for those their chap scams. Else I no see any reason person why person go carry exchange market comot for he exchange. Come dey chat you outside the exchange. Your first approach first nah to go report that trader for that exchange, block am for WhatsApp after you don seriously warn am make him no ever contact you again.
The only reason them dey ask for number during trading na just to take precautions, just Incase person delay during the trade, maybe them don pay you and you no come gree release crypto or maybe you don pay the person and the person dey delay to release crypto give you, e don finish, no be to carry exchange matter comot for exchange. Anybody wey do like that, e wan swindle you.
So whether newbie or not person no supposed tel you say this kind thing nah scam them wan scam you, anything crypto na money matter and people supposed dey handle am with discretion and carefulness. No dey carry greed dey follow matter like this, nobody be father Christmas, everybody dey fine money, and if you loose guard you go collect, that small one wey you get, them go collect am from you.