Pages:
Author

Topic: Mohbad death! (Read 338 times)

sr. member
Activity: 476
Merit: 307
October 05, 2023, 07:34:23 AM
#31
E get any need for all these talk about this man wey die so? I no even know which one wey good pass self if nah the movie industry or nah the music industry becos as e be so them must get involved in something shitty before them blow.
Now this paddy man Mohbad don die and how justice wan take com into play? Nah to arrest this em oga nai go bring am back or kill the pain wey the family of this guy dy go through now, especially the wife?
I just tire becos as we dy find to grow and become famous make we mind the place we put hand becos no amount of story them wan tell me concerning this man death wey I go believe becos las las e get wetin them go hide for this mata. Tomorrow the Naira Marley guy them go release am carry talk full our ear, the next thing mata don die.
If Naira M. no dey guilty, why him dey run him and Sam. The guy get something wey him no want Nigerians to know and him get to explain am
Why this so called former Label boss no dey present yesterday for Monbad candle night if throughly him no dey guilty, even Davido wey been dey outside the country return back to Nigeria just to honor this guy. See Nigerians don wake for this case and Naira M. Is going down, talking about his music carrier
A lot of people they linked to this matter, him friends (especially that guy wey dey with Mohbad for that hospital and nah still him make video say Mohbad don die) that guy need explain with evidence both Mohbad papa and him wife, they suppose explain if they want justice
Naira Maley and Balogun have been reminded in police detention. This one na to show say them get plenty questions to answer. The next person I expect make them check na Mohbad babe... she get plenty questions to answer. From recent news self, the pikin wey she claim say na Mohbad own na scam because DNA show say no be Mohbad get the pikin.

I dey feel say Mohbad don find out say him babe dey get affair with Naira M or somebody wey get weight, na wetin make them colabo kill am before him go cast them.
jr. member
Activity: 56
Merit: 12
September 22, 2023, 02:51:43 AM
#30
E get any need for all these talk about this man wey die so? I no even know which one wey good pass self if nah the movie industry or nah the music industry becos as e be so them must get involved in something shitty before them blow.
Now this paddy man Mohbad don die and how justice wan take com into play? Nah to arrest this em oga nai go bring am back or kill the pain wey the family of this guy dy go through now, especially the wife?
I just tire becos as we dy find to grow and become famous make we mind the place we put hand becos no amount of story them wan tell me concerning this man death wey I go believe becos las las e get wetin them go hide for this mata. Tomorrow the Naira Marley guy them go release am carry talk full our ear, the next thing mata don die.
If Naira M. no dey guilty, why him dey run him and Sam. The guy get something wey him no want Nigerians to know and him get to explain am
Why this so called former Label boss no dey present yesterday for Monbad candle night if throughly him no dey guilty, even Davido wey been dey outside the country return back to Nigeria just to honor this guy. See Nigerians don wake for this case and Naira M. Is going down, talking about his music carrier
A lot of people they linked to this matter, him friends (especially that guy wey dey with Mohbad for that hospital and nah still him make video say Mohbad don die) that guy need explain with evidence both Mohbad papa and him wife, they suppose explain if they want justice
legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
September 21, 2023, 06:54:15 PM
#29
The matter never clear shah with all the videos going round to be referenced as clips from a later time. The only person way for tell the full story down enter grave but, the guy try shah. At least, e speak out several times on record of the possibility of en demise but, attention wasn’t given to it until now way e kick bucket.
The matter is heated up and people Dey take up the case because, person no be fowl. Anyhow the matter wan turn later, one thing always leads to another and the constant oppression way this label do to this guy na em go don lead to this en permanent demise.

Drug or not, craziness or sane, he cried out and pointed fingers with clips to show say eh, these guys no mean well for ram and na so e be. Questions should be asked and answers will be given. It’s just u fortunate that, en gats kick bucket first.
sr. member
Activity: 770
Merit: 445
September 21, 2023, 05:59:28 PM
#28
na true you talk snr man, the fact say them even rush burry am like a commoner na wetin even tire me like this oh! Like, why the rush, and I guess most persons were not even informed about the burial. I totally agree that this has a lot to do with drug-related case and they might all be trying to do away with him to cover up their shit. The guy is just so unfortunate.
Dis guy matter no dey clear at all, from that burial wey dem do so early, me I see d guy father as a suspect also, I even see one video wey one man talk say na for night dey wan burry d guy but na him no allow, how your pikin go take die, u go come talk say make dem burry am for night, d man get Wetin him dey hide, dey get Wetin him no want make e expose na why him talk say make dem burry am immediately be that. The father should be arrested for proper interrogation.

The world is saying that it is naira Marley that killed mohbad, it might not be him, what if is drug or someone else that don't like the way he's doing well in his musical carrier but I'm suspecting naira Marley, they could have take the body of mohbad and do up topsy so they can know what killed him that is what I have to say R.I.P to mohbad
Wetin people dey talk be say time wey him still dey alive, naira Marley and Sam Larry dey bully d guy, people dey talk say depression dey among Wetin kill d guy, and from the videos which we have seen on the social media, then we all can see that the guy was bullied when he was alive. From d music which d guy was singing, it shows that he was going through a lot, but make we even talk say we no believe all those things wey him dey talk for music, but we have seen videos which shows that d guy was bullied. E fit be say drugs dey among Wetin kill d guy, but me I know say depression too dey among. Dey don exhumed d body for Autopsy, let’s hope police properly do their job, so that we will know the real cause of mohbad death.
member
Activity: 121
Merit: 39
September 21, 2023, 04:03:31 PM
#27
What do you think about the whole story behind the death of our popular singer, mohbad? I feel with the numerous videos coming up lately, dude really went through a whole lot of physical and emotional trauma before his demise.

In a country were proper investigation Is taken seriously, the root course of his death should have started coming out by now, but you know this is Nigeria, everything just comes and goes away with time. It's a shame.
The guy death they very painful. We should leave Naira Marley, Zino and Sam Larry aside the first people wey kill Mohbad na Nigeria police. Mohbad report to the police for several times sey dem marlian group dem dey after em life but dey no gree do anything that time, na after mohbad don die na em them come they do there yeye investigation. who they wan do the justice for now? Naija police matter no de ever pure even if dem give dem two years make them solve this matter I no sure if they go fit catch the people whey get hand for em death highest the matter go just die down without them solving anything.
hero member
Activity: 966
Merit: 620
September 21, 2023, 02:18:47 AM
#26

Mohbad's death has much controversy surrounding it because the artist while he was alive has been raising alarm about threats to his life from his former record label boss, on different occasions he informed the public but the authority never swinged into action in taking serious the case not until now he's dead so mysteriously, and we just hope let this matter not flame up now and die off in the next few weeks without the authority getting to the root of the cause of mohbad's death to serve as a deterrent to a future occurrence if actually anyone has a hand in his death as alleged.
See, I feel we are attaching too much importance to this guy's death. No offense and I'm also not in support of the questionable way he died but ask yourself this; nah him be the first guy wey don kpai mysteriously? What about the innocent youths wey police dey waste on a daily? The most popular one nah the #endsars saga wey shele for 2020. Wetin the Govt do? Dem sweep am under carpet, even claim say no body die. If them fit do such to mata wey affect the country, nah one guy own dem no fit ignore or cover even as e take affect NDLEA?
 See, corruption tie wrapper for er nation and we need honest pipo wey go dey feel the plights of youth to enter seat no be this greedy selfish people.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
September 20, 2023, 06:16:34 PM
#25
Imole spirit strong,  baba died a painful dead,  but his body have been resuscitated today for autopsy,  the guy have being through a lot,  and his whole life is a big lesson to all of us,  all the steps and everyone involved and the role they played in Imole life is a big lesson to all of us.

But the most important lesson for all of us is that:

1: No matter how highly placed and powerful you are,  don't you ever make yourself a public
    enemy to anyone.

2: never trust fake people surround yourself with few real people,  if you don't have them then
    walk alone.
newbie
Activity: 60
Merit: 0
September 20, 2023, 05:59:50 PM
#24
Been thinking of something lately about this mohbad's death


What if that boy isn't his son??
Like you can't see any resemblance 🤔
What if the accused isn't directly responsible to his demise??

Just thinking out loud and looking at a different angles
sr. member
Activity: 602
Merit: 442
I buy all valid country Gift cards swiftly.
September 20, 2023, 12:54:54 PM
#23

In a country were proper investigation Is taken seriously, the root course of his death should have started coming out by now, but you know this is Nigeria, everything just comes and goes away with time. It's a shame.

This is Nigeria, where everything truly comes and goes and this whole drama with the recent death case of mohbad also reminded me of the end sars protest where everything  came and went and same leaders and people are already running the country into mess a d we sre also cheering them.
Well no one is ready to die not even myself and the so called military  that would have taken over this country is already doing the worst and it seems they already pledged their allegiance to their leaders and not the country.

If for say make the youths wake up bro for how long we fit take wake up na?
The youths  no dey sleep but just that we no get any power to do anything and any youth weh wan over do, then go shot him mouth with money and power
hero member
Activity: 938
Merit: 605
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
September 19, 2023, 03:34:39 PM
#22
na true you talk snr man, the fact say them even rush burry am like a commoner na wetin even tire me like this oh! Like, why the rush, and I guess most persons were not even informed about the burial. I totally agree that this has a lot to do with drug-related case and they might all be trying to do away with him to cover up their shit. The guy is just so unfortunate.
From what I learnt mohbad is a Muslim and by the Muslim customs the dead is not expected to be left unburied for more than 24hrs or so from the time the death occured. So that's why the rush to bury him .

Mohbad's death has much controversy surrounding it because the artist while he was alive has been raising alarm about threats to his life from his former record label boss, on different occasions he informed the public but the authority never swinged into action in taking serious the case not until now he's dead so mysteriously, and we just hope let this matter not flame up now and die off in the next few weeks without the authority getting to the root of the cause of mohbad's death to serve as a deterrent to a future occurrence if actually anyone has a hand in his death as alleged.
hero member
Activity: 588
Merit: 466
Hire Bitcointalk Camp. Manager @ r7promotions.com
September 19, 2023, 03:33:23 PM
#21
So many things are not adding up concerning his death because portable release a video telling people how corrupt music industry is and even Nollywood he also explained how they tried to lure him to do something bad and he refuses on that video he said mogbad death was not an ordinary one, there are so many evil rival on musical industry that are willing to go extreme just to get what they want, mogbad death has been one of the trending news this days which draws the attention of the authorities, and they have decided the assume the grave in other to perform an autopsy to ctually no the cause of the death.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
September 19, 2023, 02:53:54 PM
#20
E get any need for all these talk about this man wey die so? I no even know which one wey good pass self if nah the movie industry or nah the music industry becos as e be so them must get involved in something shitty before them blow.
Now this paddy man Mohbad don die and how justice wan take com into play? Nah to arrest this em oga nai go bring am back or kill the pain wey the family of this guy dy go through now, especially the wife?
I just tire becos as we dy find to grow and become famous make we mind the place we put hand becos no amount of story them wan tell me concerning this man death wey I go believe becos las las e get wetin them go hide for this mata. Tomorrow the Naira Marley guy them go release am carry talk full our ear, the next thing mata don die.
full member
Activity: 462
Merit: 117
September 19, 2023, 02:09:17 PM
#19
This situation just looks like a conspiracy. How come he died immediately after the injection was given to him and why was he buried immediately even if he is a young man of that age.  It is very suspicious and pointing to few sets of people. The marlian records as he has said and his family. How can they be aware of his predicament and refused to do anything about it when they know he has challenges with his record label. It is unfortunate that our celebrities are just there doing a social media "justice for mohbad" without any actions just driving traffic for themselves.
The Nigeria police too can not be trusted to do a proper investigation. If only they would not compromise, I believe justice would take it course and every one who is involved in his death would be brought to book.
hero member
Activity: 966
Merit: 620
September 19, 2023, 02:35:32 AM
#18
The world is saying that it is naira Marley that killed mohbad, it might not be him, what if is drug or someone else that don't like the way he's doing well in his musical carrier but I'm suspecting naira Marley, they could have take the body of mohbad and do up topsy so they can know what killed him that is what I have to say R.I.P to mohbad
You raise valid point for there. Another thing wey fit put that thought for ya head nah say before him death he was invited by NDLEA. According to one video wey come out, him (Mohbad) dey talk say them give am substance to drink and like him tok, say him take am to save person but e no bin know say the person go betray am.
Naira Marley nah prime suspect unto say oga don dey bully am and one video wey come out show wen e look like say e collect beating wen e go tell the Marlian boss say e no dey do again.
The way I regard the music industry nah like jungle. You either eat or get eaten and too bad say nah Mohbad dem use as meat. Funny part for life be say you fit trust anyone. All the guys wey dey come out dey feel sorry no go fit tell me say dem no know say this dude bin dey get challenges wen e dey alive. Even Bella wey dey form sad, no time wey we hear how him close to Mohbad. The thing there be say the guy death no clear and we no fit trust our police to not allow bribe and corruption to make them treat the mata lightly else dis nah somtin dem sopoz investigate Wella as e also concern NDLEA.
sr. member
Activity: 714
Merit: 353
September 18, 2023, 03:33:09 PM
#17
What do you think about the whole story behind the death of our popular singer, mohbad?

Everything comes back to the Nigerian music industry, wetin dey happen there no be here because anybody wey love music like myself know say no be today wey dis boy dun dey cry out say him label boss dey abuse am and they threaten him life but nobi only the lebel boss wey him dun accused if this thing but the lebel boss own na wetin we know pass. E get when him accuse him wife too say if him died make we hold her as she dey after him life. He also accuse him label mates dem (zino and the rest) say dem set am up and want make him die. The guys life has had one controversy after another and if you ask me I go say the guy was going through serious depression becus e no just make sense say na only you everybody dey against when be say no be you be the best self for the label wey you dey.

You don talk anything finish boss, Mohbad passed through a lot and all this things Mohbad been they talk am say make people help am but nobody show face to help Mohbad na only dey for Mohbad and Bella shmurda and Zlantan ibile them don too try for mohbad especially Bella that guy na true friend of Mohbad sure, because if no because of Bella shmurda they for don kpai Mohbad tey tey. And again Mohbad been they depressed with all things wey naira Marley course am to experience and if you they look at how thing they commot now, no be maira Marley they against Mohbad other guys they wey no like dis dude but he has been doing his low key life all this while.

Even all this Zion and other guys like that them they pass through things I they sure say they no enjoy naira marley but they no one experience wetin Mohbad don pass through and that is why they no fit talk anything and if you look at it wella look how  Zion they know naira Marley don spoil that guy life finish the boy just they as if him no geh money.
sr. member
Activity: 952
Merit: 391
Underestimate- nothing
September 18, 2023, 01:26:25 PM
#16
What do you think about the whole story behind the death of our popular singer, mohbad? I feel with the numerous videos coming up lately, dude really went through a whole lot of physical and emotional trauma before his demise.

In a country were proper investigation Is taken seriously, the root course of his death should have started coming out by now, but you know this is Nigeria, everything just comes and goes away with time. It's a shame.

I was humbled for the first time in my life since my spirit had never been touched in the way that Mohbad's death had. I began by considering how meaningless existence is. Observing the entire process following his death. And most of the videos that came up showed how the boy was threatened and bullied, and I appreciate how people are fighting for him, but I don't like how his father is treating property. And, thank God, the police have made it public for the investigation, and those responsible for his bullying should face no more punishment. Something need to be corrected in the music industry. Some exposures are already happening music no be cult na.
sr. member
Activity: 602
Merit: 306
September 18, 2023, 01:10:42 PM
#15
What do you think about the whole story behind the death of our popular singer, mohbad? I feel with the numerous videos coming up lately, dude really went through a whole lot of physical and emotional trauma before his demise.

In a country were proper investigation Is taken seriously, the root course of his death should have started coming out by now, but you know this is Nigeria, everything just comes and goes away with time. It's a shame.

His death really touched every youth of Nigeria it was so sad for seeing such a young musician dead at that age, we know the kind of country wey we dey dem fit be dey do investigation now and later not do anything again, his death sha many people have been guilty for his death we actually hasn't knw who to point at that this exactly who kill him thou everything was just complicated some were saying naira Marley and Sammy Larry were over his death because sammy Larry was threaten despite all the shout nobody seems to care then so when his gone now more love started coming am very sure his father knows something about his death they have been threaten his father thou.
Some videos were reveal before his death that he was given a bottle water to drink and he was the only one who drank the water so we think zinoleesky sold him out.

We hope they reveal everything soon and all the people in his should be arrest
His death deserve justice.
newbie
Activity: 28
Merit: 6
September 18, 2023, 12:22:21 PM
#14
For me ohh the popular singer mohbad died because nobody get he time, everybody neglect am even he own fellow artist no just care and nobody know wetin really kill am, nobody wan investigate the matter nawa na naija for us oh and some people dey talk say he too take drugs and make nobody take he words serious, this mohbad death pain me because he get wife and pikin who go take care of the boy now very painful, make Nigeria take this matter serious oh if not another artist fit die because of live threat
jr. member
Activity: 78
Merit: 6
September 18, 2023, 01:56:06 AM
#13
mohbad death come as a shock to Nigerians, it is a very bad one to a promise young boy to go just like that. I really balme him some how, for not specking out early to his family members even his wife. even if there was an oaths taking. secondly I blame his father also because as a father when you notice some changes from your children, in this can of situation, you make some move to know what is really the problem. after his death, they went and bury him. without looking for the cause of his death, and it just look as if it was a plan something.
in this country the rich people control it. what ever that is happening now is medicine after death .
hero member
Activity: 546
Merit: 516
September 17, 2023, 03:25:38 PM
#12
The death of that young man pain me wella... I no find am funny seeing such a young promising talent just gone like that. Well, Naija music industry deep and one person been don talk am somewhere say na cult be that and from wetin I dey see, e be like say na true. E dey hard to see those celebrity live long and in good health, I don't know why e dey like that.


Him death dey very suspicious because nobody know why him go meet the nurse wey inject am as the news report say na after the injection wey him die and I hear say na the nurse wey call am make him come take the injection. Ear infection no dey just kill person like dat na (d whole story no just clear). Why dem just rush do burial, his father needs to be questioned because wu knows if dem dun pay am to close mouth to do the burial as dem need his permission. Police need to invite everybody wey dey involved for the mata from Naira marley to the father so dem go investigate the matter well even if na to dig am up do autopsy.
I be wan make we reason the guy death from another angel. First una sure say the boy hand clean? Una sure say him dey completely innocent for the whole thing? I know say for Naija, the person wey dey no dey dey guilty but we gat think wide sometimes. Our people say if pikin dey cry dey point one place, if them check am them go see say either him mama dey there or person wey him know. Why be say everybody dey attack the boy? From Naira Maley to some randomguys on the street, the guy just dey collect from everybody. I hear say him be don talk say if him die, make them hold him wife. Una sure the matter dey straight?

On the other hand, it is possible that there is a huge conspiracy involving his wife and some powerful gang, to get him out of the way. Check out the following incidence: He was attacked by group of boys in 2021; He was attacked at his estate; His wife bought pickup for her father after his death. All these are pointing to one thing.
Pages:
Jump to: