Pages:
Author

Topic: naija board : newbie, a must read (Read 238 times)

sr. member
Activity: 504
Merit: 302
December 06, 2023, 09:26:13 AM
#25
If I no correct , senior men go correct me. I know the joy wey dey to dey post for where you belong as e dey make you feel comfortable but e good make we make something's clear for newbie for the forum. This matter na something wey Dem don discus before but base on say the mistake they come up again, I believe say make we still touch the matter.

Naija board na one better board and the activities for the board this days dey make belle sweet person. 

Senior men Dem don try their best to keep the board clean from every form of spam but the joy and happiness of newbie always dey blindfold Dem make them forget the rule.

If u post topic and you come post another topic/thread wey dey related, that one na spam, Dem fit they desame place .

If your reply dey too short, Dem no dey neccessary, this place no he social media for all those kind chat, that one self is considered spam.

If you dey quote unnecessarily or your quote too dey long. When your quote they carry multiple quote , that one self dey more like sparm cause e dey always de hard to read am by others.

If you dey respond to topic wey you know understand con dey talk out of point , even that one na spam.

If others dey wey I no mention, Dem senior men go yarn them with us.

If Dem correct you, abeg no see am as attack, na the right board you dey sooo. I no say everyboard like grow ihn account but make respect the rules. For this local board, I fit boastfully tell una say, people for here get love inside them, and for here, your account fit get the merit wey you wan hustle for but apply sense make we dey enjoy the board as usual

Your Matta carry points for head bro, this forum na places where everyone get mind to talk and even discuss anything wey him like, some people dey sha wey be say them like to dey quote unnecessary quote but for long quote wey you talk I don't think anything wrong with person wey do long quote, some people Don master with am and some na so them sabi am very well, for the sparm that one na very important thing wey we go avoid sha because that one too dey among the rules of the forum.

Na normal thing to dey post for local board because local board na the best board in forum because no matter how dull you be if you enter your local board you must understand something very well and being in the local board go give you more confident to talk and even understand something wey be say you never understand, I see this your idea like something wey make sense.
member
Activity: 153
Merit: 14
★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest
December 05, 2023, 10:47:35 AM
#24
Newbies abeg make una try read the forum rules and some guide wey dey for the Beginners and Help board e go help una for the race for this forum, because e never tay when the op create this thread so as to draw the newbies attention for the board make dem for make quality post and avoid spamming. Now for our board I dey see up to 4 thread wey dey talk about Mohbad, e nor good for the health of our local board, to me e just be like say all these things dey make wen the admin dey delay our request for extra merit source, e nor good make we stop am. And the worse part na be say all the 4 threads dey for this first page.
Newbies abeg make we nor do make the efforts of our legends dem go to waste.
You made a point because as a newbie the first thing way you supposed to do na to read the forum rules and regulations before any other thing, because going true the rules and regulations will help you to know what is right and what is not right,so newbies make will dey try our best to do the right thing.
sr. member
Activity: 504
Merit: 323
October 07, 2023, 04:00:01 PM
#23
Thank you for making it clear, no be say na merit person dey Hussle for , most time, I dey go offline for weeks . But as you talk am now, I get the point wey u dey make, na wetin make local board dey unique be that.
One love
People believe that threads talking about rules & regulations  are used to farming merits that's y its being pinned at the top of some boards.
Yeah , normally you might not have d intention but d tin be sey some nah their way for getting merits  be dat and dem dey look for people wey go make mistakes  , but if you know you have a genuine  reason you fit stand your ground , so if it get you merits  it's normal

U don talk am finish mate, some people they post for merits fishing not because of the sake of our local board especially here on this our board, the numbers of thread that are not useful is more that they helpful and useful thread and if you check Naso e be man. But sometimes e get some posts wey be say if we do we no they even think of getting merits from such posts and go con see say another person go merit’s because e worth am, so what I’m trying to say be say make we they reason how we go they drop things for here.

Just like this thread now, the OP know say wetin him they try talk most of the newbies know am here and there is any rule that is attached to local board wey no they other English boards as the forum concern, so this thread now e they among thread wey no they useful for the LB because wetin him they try talk everybody know am, and we they always think of how to generate quality posts that will grow our LB to higher level.
member
Activity: 334
Merit: 27
October 07, 2023, 02:45:57 PM
#22
This thread has brought hope for every newbie , newbie fill  free to ask all your questions here to find useful answer to grow on this forum.
hero member
Activity: 700
Merit: 577
Eloncoin.org - Mars, here we come!
October 07, 2023, 11:02:39 AM
#21
Insightful thought, but very sorry if i say that this is not needed, i mean this thread, there are no specified rules for the local board that is not already specified in the general forum rules and regulation, so any user breaking the rules in the local board is as well breaking the rules of the forum in general, spam is spam, no matter where it is posted, be it in the local board or global board.
Well where there is no sense, but when critically look at it, there is sense there from what the Op has said there is sense in it. If you remember, after the creation of the board, the newbies now full members and Sr. Members here in the local board were posting shit and spamming the board like another thing, even after the Local Board Rules were created until recently that the related creation of threads e don reduced. And concerning the spamming matter here. Dat one, threads we don tok e don too plenty.

This I disagree with, you don't have to type the page page of a book before you be considers as a quality poster, for all care, there are some one line replies that are so accurate and at the same time, so straight to the point.
And do i need to tell you that many who type long walls of texts are mostly doing so to make sure their post or comment meet the requirement of what ever company they are promoting through signature ad campaign.
Experience na di good teacher na so dem tok am. I don see plenty people threads, comments wey dem don delete because of short short comments wey dem do and me sef dem don delete my own so weti di op dey to e no far from di truth. Yes and I also agree with you say one line sentence wey tok di main thing sef dey get reward but but weti op dey try to tok be say make dey increase our writing. Dat one line wey u say e dey quality na from Sr. Member and not for newbies.
full member
Activity: 280
Merit: 205
The great city of God 🔥
October 07, 2023, 10:36:03 AM
#20
If your reply dey too short, Dem no dey neccessary, this place no he social media for all those kind chat, that one self is considered spam.

No, no talk am like dat because some questions need short and direct reply, wetin you go talk na say make we no get a habit of only writing one line spams as when your posts get reported it'll be deleted and if many posts get deleted it can lead to your account getting banned.

if Dem correct you, abeg no see am as attack, na the right board you dey sooo. I no say everyboard like grow ihn account but make respect the rules. For this local board, I fit boastfully tell una say, people for here get love inside them, and for here, your account fit get the merit wey you wan hustle for but apply sense make we dey enjoy the board as usual

Here na our own so na for us to protect am, but dat one no mean say we go dey abuse the forum rules and expect us to overlook am. Person go only correct you when you dey do something wrong so wetin come dey make you vex, him dey actually look after you because if him no wan make you progress him for just leave you and you go continue in your wrong way come put your account for trouble. And for those correcting try use small love, na hustle we all dey so no go spoil another man own.
I sincerely appreciate the way you are handling the situation here. This thread ona bring here na very useful thread and many of us go lean from am. In as much as we wan grow, many hoddles dey to cross but for us to cross it we need guidance. This thing you just analys like this na one of my quest, but no body explain am like d way you did. If to say I get merit I for give you. But morover I appreciate your efforts on making our 9ja local board solid🙏
jr. member
Activity: 100
Merit: 4
October 07, 2023, 10:10:55 AM
#19
Na true talk you yarn so o, because I still dey observe watin dey happen for this forum and I dey very careful before I make any post or comment, just to avoid the case of say I don spam or do something wey no follow.

This post dey important for any newbie to read so as them go understand watin Dem need to do so as not to disgrace or fall out hand for any board here. I thank God say I read am and understand am and I go try to adhere as much as possible to the rules wey this forum get.
member
Activity: 334
Merit: 27
October 06, 2023, 05:12:48 PM
#18
Quote
No, no talk am like dat because some questions need short and direct reply, wetin you go talk na say make we no get a habit of only writing one line spams as when your posts get reported it'll be deleted and if many posts get deleted it can lead to your account getting banned.
no be lie boss, u too much, na the truth you make clear so. Thanks for sharing this knowledge
full member
Activity: 266
Merit: 140
October 06, 2023, 01:42:43 PM
#17
Here na our own so na for us to protect am, but dat one no mean say we go dey abuse the forum rules and expect us to overlook am. Person go only correct you when you dey do something wrong so wetin come dey make you vex, him dey actually look after you because of him no wan make you progress him for just leave you and you go continue in your wrong way come put your account for trouble. And for those correcting try use small love, na hustle we all dey so no go spoil another man own.

Thanks @Brainboss this is well Stated I like the wey you clearly it for everybody seriously most of us here don't won't to see some people progress at least if they see sey we newbie we want to get wrong instant of them to correct us their will not after that, their only look for a wey to criticize us which is no good we all gather here to help each other but some still no understand.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
October 06, 2023, 10:37:17 AM
#16
If your reply dey too short, Dem no dey neccessary, this place no he social media for all those kind chat, that one self is considered spam.

No, no talk am like dat because some questions need short and direct reply, wetin you go talk na say make we no get a habit of only writing one line spams as when your posts get reported it'll be deleted and if many posts get deleted it can lead to your account getting banned.

if Dem correct you, abeg no see am as attack, na the right board you dey sooo. I no say everyboard like grow ihn account but make respect the rules. For this local board, I fit boastfully tell una say, people for here get love inside them, and for here, your account fit get the merit wey you wan hustle for but apply sense make we dey enjoy the board as usual

Here na our own so na for us to protect am, but dat one no mean say we go dey abuse the forum rules and expect us to overlook am. Person go only correct you when you dey do something wrong so wetin come dey make you vex, him dey actually look after you because if him no wan make you progress him for just leave you and you go continue in your wrong way come put your account for trouble. And for those correcting try use small love, na hustle we all dey so no go spoil another man own.
hero member
Activity: 742
Merit: 529
October 06, 2023, 08:42:45 AM
#15
Thank you for making it clear, no be say na merit person dey Hussle for , most time, I dey go offline for weeks . But as you talk am now, I get the point wey u dey make, na wetin make local board dey unique be that.
One love
People believe that threads talking about rules & regulations  are used to farming merits that's y its being pinned at the top of some boards.
Yeah , normally you might not have d intention but d tin be sey some nah their way for getting merits  be dat and dem dey look for people wey go make mistakes  , but if you know you have a genuine  reason you fit stand your ground , so if it get you merits  it's normal
Na this same tin about people tinkin say certain posts wey person go mk say na to farm merit dey make me de avoid makin sum kind post dem wey I see say e go dey necessary to post am mk e serve as reminder for sum fvck up we don de wan turn normal. But as @promise tok am no be evry bodi get dat energy to spend time d explain explain in the name of standing ground so nah to just let the supos post just slide maybe sum bih name inside the LB fit observ am com raise alarm, dat one nobodi go reason am as merit farming shaaa.

Or anoda alternative be say u fit PM any big name for the LB tell am wetin u de observe make him raise alarm about am , dat too goes well lik dat.
sr. member
Activity: 560
Merit: 418
October 06, 2023, 06:41:49 AM
#14

We should also get it clear, that even if correction have been made, there is no crime a creating a thread that can help keep the board clean or help others.

 This  could be considered  spamming  or trying to farm merits  in some  boards ,which could also give you some bad reputations if it actually being termed to farming merits

Thank you for making it clear, no be say na merit person dey Hussle for , most time, I dey go offline for weeks . But as you talk am now, I get the point wey u dey make, na wetin make local board dey unique be that.
One love

OP and promise444c5 I like the way una understand una selves, one person (Forever101) make mistake and the next person (promise444c5) correct am without making a big deal about the whole thing.
This correction of a thing I believe say no be everybody sabi call out person attention then correct the mistake person make so as all of us dey here nah learn we dy learn no matter your rank, rank no dy indicate say you sabi all.. So I go still talk am again OP weldone for this thread you open.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
October 06, 2023, 05:51:35 AM
#13
Naija board na one better board and the activities for the board this days dey make belle sweet person. 

It is good that our local board is fast gaining attention coupled with the activities these days and that has made the local boards to start looking into our activities here. Of lately reputable members have started paying attention to our plight as a result of our presence and contributions in making the platform lively. This is a really a good thing to behold.

Senior men Dem don try their best to keep the board clean from every form of spam.
This one na true talk. Our senior men dem dey really try their best to keep this board clean.Dem dey do well to dey call attention of members wey dey go off keys sometimes to correct them so that dem no go use am go outside go paint the house another colour. The activities wey dem initiate too na another one wey make our people come sit up to their doings here. For sure them don create enabling environment for us to freely yan mata as e be here.

If u post topic and you come post another topic/thread wey dey related, that one na spam, Dem fit they desame place.

This one na true you talk here. Sometimes related topic no make any sense but most at times too e no dey intentional say person go see topic wey person don create him go create that same topic too no. Maybe the person no see say that similar topic dey exist for am to just put mouth make him own contribution or maybe the topic don shift enter another page wey make him no see am come make create that same topic. I dey yan like this because e happen to me recently. I create topic wey i no know say person don already create similar thing of that nature as one of our senior man call my attention immediately i lock the topic. That na the step wey person suppose to take anytime dem call their attention to things of that nature.

If your reply dey too short, Dem no dey neccessary, this place no he social media for all those kind chat, that one self is considered spam.
This one na wetin i think say no go well. Your perspective about this one no tally. I don come across post wey dey short and very insightful with lots of message to pass  to some reading. It is called short and simple. No much talk here.

The issue of plagiarism too na another trap wey dey always hold newbies dem down. As newbie dem no sabi say this platform na advanced one so dem go just copy from any where come post here forget to also put link to reference where dem copy from and that one na crime here wey don lead to many newbie being tagged. As a newbie, if you copy from anywhere make you do well put the link to where you copy from so that e go dey clear say you get reference to back up your post.

If Dem correct you, abeg no see am as attack, na the right board you dey sooo. I no say everyboard like grow ihn account but make respect the rules. For this local board, I fit boastfully tell una say, people for here get love inside them, and for here, your account fit get the merit wey you wan hustle for but apply sense make we dey enjoy the board as usual
Person wey see correction as attack never ready to learn and grow na because anybody wey wan learn go open ear listen to advise and take correction so that him go do well and too dem go continue dey guide am any time him make mistake. I know say we love ourselves here hence the rate at which we help each other grow is very much encouraging and welcoming. Let the love we share here continue to lead us through.
full member
Activity: 266
Merit: 187
Bitcoin!!
October 06, 2023, 04:10:22 AM
#12
Newbies abeg make una try read the forum rules and some guide wey dey for the Beginners and Help board e go help una for the race for this forum, because e never tay when the op create this thread so as to draw the newbies attention for the board make dem for make quality post and avoid spamming. Now for our board I dey see up to 4 thread wey dey talk about Mohbad, e nor good for the health of our local board, to me e just be like say all these things dey make wen the admin dey delay our request for extra merit source, e nor good make we stop am. And the worse part na be say all the 4 threads dey for this first page.
Newbies abeg make we nor do make the efforts of our legends dem go to waste.
member
Activity: 334
Merit: 27
October 05, 2023, 01:43:42 PM
#11
If your comment is the fact of the discussion, and it is  short, that is not called spamming @Loyce Mobile replie is an example. What if you talk so many story and na off topic, so it is not by the length of your reply that confirms that you are a shit poster.

Well, I go agree with you base on your view and observation.

Quote
This also depends on the board of discussion, for example the gambling board that majority of forum members visit and contribute there base on their signature campaign demand and for the love of sport. Although, I understand what you mean OP.

No be lie for that one but e better if newbie they cautious as Dem dey try grow on the forum
sr. member
Activity: 406
Merit: 360
October 05, 2023, 12:30:34 PM
#10
If your reply dey too short, Dem no dey neccessary, this place no he social media for all those kind chat, that one self is considered spam.
If your comment is the fact of the discussion, and it is  short, that is not called spamming @Loyce Mobile replie is an example. What if you talk so many story and na off topic, so it is not by the length of your reply that confirms that you are a shit poster.

When your quote they carry multiple quote , that one self dey more like sparm cause e dey always de hard to read am by others.
This also depends on the board of discussion, for example the gambling board that majority of forum members visit and contribute there base on their signature campaign demand and for the love of sport. Although, I understand what you mean OP.
full member
Activity: 266
Merit: 119
Keep Promises !
October 05, 2023, 11:55:20 AM
#9
Thank you for making it clear, no be say na merit person dey Hussle for , most time, I dey go offline for weeks . But as you talk am now, I get the point wey u dey make, na wetin make local board dey unique be that.
One love
People believe that threads talking about rules & regulations  are used to farming merits that's y its being pinned at the top of some boards.
Yeah , normally you might not have d intention but d tin be sey some nah their way for getting merits  be dat and dem dey look for people wey go make mistakes  , but if you know you have a genuine  reason you fit stand your ground , so if it get you merits  it's normal
full member
Activity: 238
Merit: 151
October 05, 2023, 11:03:18 AM
#8
~
I agree with you,but not all your points listed are considered spamming. I want to add some more advice
1. Newbies should always try to check if a similar topic already exists before creating a new one. Sometimes, you'll notice repeated topics on the board which to me is spamming and it's better to avoid that.

Yes you are right on going through topics before posting to avoid repeating same topic but you know sometimes there are so many topics on this forum and in the aspect of checking topics one might topic unknowingly and then still bring up same topic, so for me if it is being analyze on a different view different from the way the first person viewed it though it's still a spam but it should be considered since it is said differently.
member
Activity: 334
Merit: 27
October 05, 2023, 10:31:51 AM
#7

We should also get it clear, that even if correction have been made, there is no crime a creating a thread that can help keep the board clean or help others.

 This  could be considered  spamming  or trying to farm merits  in some  boards ,which could also give you some bad reputations if it actually being termed to farming merits

Thank you for making it clear, no be say na merit person dey Hussle for , most time, I dey go offline for weeks . But as you talk am now, I get the point wey u dey make, na wetin make local board dey unique be that.
One love
full member
Activity: 266
Merit: 119
Keep Promises !
October 05, 2023, 10:26:59 AM
#6

Jump to: