Pages:
Author

Topic: New year resolution - page 2. (Read 287 times)

sr. member
Activity: 504
Merit: 389
The great city of God 🔥
December 16, 2023, 07:47:50 PM
#3
My country people good evening inside this evening, hope everyone is fine, today I want talk about new year resolution.

The year don almost end, as a naija blood we be, most of us dy normally say our new year resolution towards the end of the year, but I wan ask, how many of us dy fit keep to it?
Brothers and sisters i know say e no easy because las las we be still human being, we get addiction wey we vow to let go , but one way or the other, we still dy do am, I no know if anyone get similar experience?
Yes na true but most at times the things wey dey make people no achieved na:
1) lack of capital for starting up a business.
2) easy to say Dan done, when people develop the habit of always saying and not working towards it.
3) planing a resolution with a false hope. When you put your hope on something you are not really sure will generate money. Maybe hoping a meare promise which might never come true. Expecially when your uncle promise you money for business, you k
now make a new year resolution plan when you haven't even seen the money to start up, probably if he disapoint you, your plan also fails. That's why it is advisable to have your own fund before making a resolution plan so that when people you put hope on disappoints you you won't be left out.
sr. member
Activity: 504
Merit: 268
DGbet.fun - Crypto Sportsbook
December 16, 2023, 06:37:46 PM
#2
Normally many of us no just get resolutions wey we don set but we still get goals wey we don set to achieve for this coming new year, and as e be so, no be every thing wey we talk say we go stop naim we dey fit stop immediately I fit take small time but by God's grace we dey achieve am, though for the past years I don set some kind goal and resolution wey I no fit achieve or fit stop, but with wattin I don see , if you get any new year resolution for mind to stop, just start to dey avoid those things now or start to dey do am now if na goàl wey you set, because zeal na from small small e take dey start, and you you go drive yourself towards that goal wey you set, though sometimes r fit dey very difficult to start or stop but if you continue before you go know r don dey used to you.
sr. member
Activity: 266
Merit: 205
December 10, 2023, 02:17:55 PM
#1

Jump to: