Pages:
Author

Topic: Nigeria is known for scam by the people of the world,while we seeam as street. (Read 220 times)

legendary
Activity: 1554
Merit: 1139
Na oyinbo teach Naija ma scam na just say Naija pipo too loud,if not we no go dey bugga with scam. Naija dey learn for where those oyinbo dey all the best hackers no be that side e dey,moreover na them provide tools wey we dey use. All the btc hacks wey we don hear for forum,e no relate to Naija at all. My pple ma we no bother ourselves, we still dey learn for where oyibo dey. I guess because say Naija pple dey every country wey you go than any Africa country citizens na e make dem dey give us the charge.
No matter how e be, I no go ever see my people as bad people. We Nigerians na very good people, people way sabi care for one another especially when we meet for another man land, people way like jolli with ourselves and na so we sabi play kwa. E just dey unfortunate say, people way put magomago for ours system and way dey direct the evils way don turn our government to dey this corrupt no go ever commot for our body. Them don be sucking blood way don fatten up inside our skin so tay, them don big pass the hole way dem follow enter before

We no own scam, we reject am in everyday and that's why, we dey try everyday to teach our people say, e no good and our government no smile with am at all. We go dey clean our house and make them way dey tag us try clean therr house too. Na there dirty don fine us come so.
sr. member
Activity: 378
Merit: 258
Lohamor Family
Na oyinbo teach Naija ma scam na just say Naija pipo too loud,if not we no go dey bugga with scam. Naija dey learn for where those oyinbo dey all the best hackers no be that side e dey,moreover na them provide tools wey we dey use. All the btc hacks wey we don hear for forum,e no relate to Naija at all. My pple ma we no bother ourselves, we still dey learn for where oyibo dey. I guess because say Naija pple dey every country wey you go than any Africa country citizens na e make dem dey give us the charge.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Top Crypto Casino
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?
Nigeria is the most populous country in Africa, sixth in the world. Having the highest GDP in Africa. Which means, even as Nigeria has bad leadership and mismanagement, it is a country that is recognized in the world. But there is high rate of unemployment that makes educated individuals not to have job or either underemployed and not living up to expection, but suffering in poverty.

People wey dey see and tag people of Nigeria as the most scammer in the world get something for their mind, is either dem dey jealous us, or they just get natural hatred for Nigeria,  as far as I know, Nigerians no scam pass Philippines, Indians and some other Asian countries
It is like you are comparing white to white or yellow to yellow. Victims are unable to trace scam to the country that the scammers are because the scammers use VPN and lied to victim that they are from another country, it is only traced through research that the scammers are from a particular country.
-Charles-Tim baba stand well make I understand we're you dey for this matter.
There is no doubt the fact that there is a high rate of unemployment /underemployment in Nigeria and the rate of poverty is high in Nigeria as a result of corruption stealing of government money and poor anti citizens' government policy.
- But we should know that we still have some youths who are not legit within Nigeria and their are involved in crimes such as.
- Rituals,  armed robbery, kidnapping and internet frauds.
   this has been exposed many times just because their
   want to live above their means and the rest of the world has a bad experience about Nigerian scammers.
-We also have other Nigerian youths who are legitimately working hard just like me and you.
The big answer to this is that.
- Day in and day out, 9ja youth are also doing well in other positive things and contributing to global development, this can be seen in various sectors, such as ICT, Software entertainment industry.
The Topic of scams should not only be attributed to Nigerian alone but all the other parts of the world, how then do we protect ourselves from scammers and hackers is the big question that we need to provide answers to because, in one way or another, we have all be scammed at one point.
-  cryptocurrency is an independent financial tool, at the same time scammers can use it to be untraceable
sr. member
Activity: 714
Merit: 347
Op it seems funny but you bring serious Mata to discuss about no be I fit talk say no be Nigerian be the best scammers country even the scammers wey they country no they use naija location so people just they predict and some get hatred for country if not how person wey they another country go know wetin they sup for here but me I they sure say naija boys they run the Mata 😊fast fast they no they carry last for the thing but that one no means say na for naija best scammers they.

Yeah, I support your movement bro, some countries dey wey they wan paint our country bad, all this white people get technology materials pass Nigeria and they even Sabi like say them they use charm, bad Belle too much because of they see say Nigeria get experience pass them, but sha na our governments dey give them mouth to talk waiting them no see, if to say them they employ youth's for work boys no fit go street to hustle.
newbie
Activity: 28
Merit: 15
Nigeria don dey among countries wey dem see say na dem Sabi scam pass for the world,and the way me I see the thing,e be like say we take glory inside the talk.So tey we don kukuma dey Callam "street."
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?
I tell you my brother the thing no they sweet me at all, for all these embassy guys to grant Nigeria visa now na problem because of waiting they done tag us and if  na scam nigeria no scam reach all this oyinbo guys both their male and female esspecially for crypto, but any small thing now they go carry tittle give us. The  truth be say our people to get for body if an that one,I know say he no easy but even at that no be excuse to scam.
Normally you see all those oyinbo ba na racist dem be, dem just de find small excuse wey dem go use spoil our name i just believe say dem no like black people and if e possible dem go even want make separate their selves with black people. Check even the way dem de treat black people even for that their side even footballers de complain about the same thing. But all this things sha na we give dem mouth talk am because the way yahoo take cast even small children wan de do yahoo so if you check am na yohoo boys  con de flex pass even people wey get legit work and our president con get agenda against yahoo boys na wetin cast everything be dat na why dem get mind spoil our name be dat.
full member
Activity: 462
Merit: 117
Omo see make I Yan you the Koko, Naija dey learn work for scam things. According to oga brainboss, him say Naija no even reach the top ten scam countries in the world and wetin him Yan na true. Oyibo na Dem get the work. Na peanut the Bois Dem wey dey claim say Dem dey run the system dey collect. Anyhow de matter be me I believe say that one no pure at all. No be everybody for Naija wey be scammer but the matter be say man want to hustle to out food for table since them no get any option and Dem come call am street. Omo for the matter of streets as you call am, Naija dey learn work for that one but me I believe say soonest things gonoure for we country and Bois  go soon dey reason well.
sr. member
Activity: 728
Merit: 421
Nigeria don dey among countries wey dem see say na dem Sabi scam pass for the world,and the way me I see the thing,e be like say we take glory inside the talk.So tey we don kukuma dey Callam "street."
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?

I really do not think Nigerians and Nigeria is widely known for only bad things. There are good Nigerians out there making Waves and making good name for the country also, earning a good and legit business. In as much as there are Nigerians virtually in almost every part of the world, they are making the country proud. I believe it is the situation of the country that leads to all these bad name calling of Nigeria and Nigerians in diaspora. If the system of government here is favourable and economic growth is in a growing state, I do not see any reason why people would get themselves involved in illegal activities just to make a living but the situation of the country is not the type that one would seat and watch but think of alternative means of survival. That is the situation of things in Nigeria.  If the government can not deliver on the the dividends of democracy, the people lacks capital to start up their various businesses what do you expect and I ask who is to be blamed?
full member
Activity: 560
Merit: 100
Eloncoin.org - Mars, here we come!
Na only bad thing Dem dey know our naija for, and na so e dey always be, the only scam I know say naija dey do sef na only Yahoo Yahoo, and we get other countries wey do Yahoo Yahoo pass naija,
I don hear of so many stories where U S citizens break through their government account and thief better money, which person for niaja wey don do that kind thing, so make Dem leave naija alone, I no get plenty talk to talk for this matter abeg
member
Activity: 308
Merit: 32

Make I shock you, if you dey talk of real scammers like men wey dey work with laptop defraud companies, organization wey be say dem be big shot, Nigeria no even follow for top 5 or ten self but na just say our lavish lifestyle dey kill our name because dem know say normally we poor for this side so anybody wey come dey live over large as our people sabi do na scammers. Also our African brothers dey portray demselves as Nigerian away most times so when dey catch dem dey gi say na Nigerians.

Nigerians are hard workers like the real ones. Oyah see us for here na, e get any other people wey hustle pass us I mean posting hustle oh no be all those bounty hunting (even there we still get representation). People self come dey jealous as e come belike we dey get am easily when den no realize say the level of hustle wey we dey put inside this forum much pass wetin others dey put in and we suppose dun get more recognition then dis

Sha just no reason am too much, no be say we dey celebrate fraud but Nigerian just dey find anything wey go make dem happy. We sabi find humor in every situation that's why e dey like we dey celebrate the fraud but Jo be so, give any Nigeria work na and see how him go over deliver instead wanting to join the street. That way self no easy as ritual dun enter the whole thing and wetin many people dey do now na ritual come use street cover up.
No be lie Nigerians the hustle real hustle o, tho the bad hustlers still dey sha, even Nigerians when dey reach other countries dem dey carry the hustle for head. This scammers done spoil the country name for outside, becos the outside world now done dey see every Nigerian to be a scammer but dem no know say the good ones wey dey hustle right even plenty pass the scammers,
This forum I believe say na Nigerians full oo,  even to do the scamming hustle no easy too bcOs before u scam oyibo person you need some level of smartness,  and e no easy at all.

Nigerians no scam reach some kind countries just that na our own dey too pronounced, and that na becos we too like lavish lifestyle.
sr. member
Activity: 952
Merit: 391
Underestimate- nothing
Nigeria don dey among countries wey dem see say na dem Sabi scam pass for the world,and the way me I see the thing,e be like say we take glory inside the talk.So tey we don kukuma dey Callam "street."
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?
I tell you my brother the thing no they sweet me at all, for all these embassy guys to grant Nigeria visa now na problem because of waiting they done tag us and if  na scam nigeria no scam reach all this oyinbo guys both their male and female esspecially for crypto, but any small thing now they go carry tittle give us. The  truth be say our people to get for body if an that one,I know say he no easy but even at that no be excuse to scam.
sr. member
Activity: 756
Merit: 454
No place wey this scam of a thing no dy oh, e dy everywhere but our problem be say we too do , over Sabi dy worry us. If we get small cash we don start to show say we don arrive but the main piple wey dy do am dy collect better cash no dy cough self. So when other contri piple see us them no need my village native doctor to tell them say nah fraud give this person moni becos we don use our hand take exposed ourselves.

Some piple dy see we blacks as piple wey no fit live large without diving inside bad thing, well I no blame them Sha, na the slave trade we still dy smell for our body nai cos am. If our contri don advance like those piple wey open our eyes right from the beginning all these yama yama name for no stain us so.
hero member
Activity: 826
Merit: 641
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I've seen reasonable people, especially foreigners defending Nigerians times without a number. These are the people that have been here, so they know what's going on and concluded that Nigerian scams are overexaggerated. Desperation and poverty have pushed many Nigerians into scams, but still, the scams in the country are mainly romance scams. Many Nigerians might be engaging in this which pushes our scam rating high, but the true scammers are foreigners in advanced countries, not Nigerians.

We should try not to wash our dirty linen outside, and I know with an improved economy and welfare, all these would subside.

The oyinbo people Dey always tag every black man as criminals but na dem scam pass. Make I use Hushpuppi as case study shey him matter no be only am Dey involve even some white’s follow y dem Dey take only him name shine. We go always look like scammers for them eyes then after that we selves Dey play along. We Dey take the hardship of country as license to commit crime which to me na bad thing. We need to be patriotic citizens no matter our conditions
I tire o my broda, d high profile fraud cases for dis world na oyibo people get am, even d Hushpuppi fraud no happen inside Naija, na 4 abroad. So who teach am or provide d tools wey dem they use? No be oyinbo people? Naija don cast truly bcos of our economic status, but if u reason am well, over 95% of these people labelled scammers na dating scam dem dey do. All wey I don follow 4 news through probe and court cases na dating/romance dem dey always do. I pray make Naija image beta soon and make our youths find something beta doing with their lives.
legendary
Activity: 2450
Merit: 4295
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
Nigeria don dey among countries wey dem see say na dem Sabi scam pass for the world,and the way me I see the thing,e be like say we take glory inside the talk.So tey we don kukuma dey Callam "street."
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?

Make I shock you, if you dey talk of real scammers like men wey dey work with laptop defraud companies, organization wey be say dem be big shot, Nigeria no even follow for top 5 or ten self but na just say our lavish lifestyle dey kill our name because dem know say normally we poor for this side so anybody wey come dey live over large as our people sabi do na scammers. Also our African brothers dey portray demselves as Nigerian away most times so when dey catch dem dey gi say na Nigerians.

Nigerians are hard workers like the real ones. Oyah see us for here na, e get any other people wey hustle pass us I mean posting hustle oh no be all those bounty hunting (even there we still get representation). People self come dey jealous as e come belike we dey get am easily when den no realize say the level of hustle wey we dey put inside this forum much pass wetin others dey put in and we suppose dun get more recognition then dis

Sha just no reason am too much, no be say we dey celebrate fraud but Nigerian just dey find anything wey go make dem happy. We sabi find humor in every situation that's why e dey like we dey celebrate the fraud but Jo be so, give any Nigeria work na and see how him go over deliver instead wanting to join the street. That way self no easy as ritual dun enter the whole thing and wetin many people dey do now na ritual come use street cover up.
sr. member
Activity: 714
Merit: 347
This matter wey people dey tag nigeria bad no be small thing and na our leaders or government na them dey cause am, because how come person go take many years study and him no go get work last last na Street him go end and still family go dey give am problem dey frustrate him life, so how him go take live life? and this days now parents are also among that make some young men got into criminals activity, as the matter be so, no be only Nigeria people be scammers he get some countries wey them do am pass nigeria but you una know say as bad belle wey somes countries be dey want paint nigeria negatively because they get something wey be say we nigeria get pass them.
hero member
Activity: 868
Merit: 952
I've seen reasonable people, especially foreigners defending Nigerians times without a number. These are the people that have been here, so they know what's going on and concluded that Nigerian scams are overexaggerated. Desperation and poverty have pushed many Nigerians into scams, but still, the scams in the country are mainly romance scams. Many Nigerians might be engaging in this which pushes our scam rating high, but the true scammers are foreigners in advanced countries, not Nigerians.

We should try not to wash our dirty linen outside, and I know with an improved economy and welfare, all these would subside.

The oyinbo people Dey always tag every black man as criminals but na dem scam pass. Make I use Hushpuppi as case study shey him matter no be only am Dey involve even some white’s follow y dem Dey take only him name shine. We go always look like scammers for them eyes then after that we selves Dey play along. We Dey take the hardship of country as license to commit crime which to me na bad thing. We need to be patriotic citizens no matter our conditions
legendary
Activity: 1498
Merit: 1116
Top-tier crypto casino and sportsbook
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?
It is normal that people always remember the bad first before the good. But don't let it define you as person from Naija.

Take am personally as your responsibility just like the way some other Nigerians dun take am to change that Narrative as much as they can by being better Nigerians and creating a better image for the country. Better truthful and trustworthy persons still dey inside this our country, but the matter na say the number dey reduce. Make we try be better Nigerians so hope go still dey.
hero member
Activity: 826
Merit: 641
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
I've seen reasonable people, especially foreigners defending Nigerians times without a number. These are the people that have been here, so they know what's going on and concluded that Nigerian scams are overexaggerated. Desperation and poverty have pushed many Nigerians into scams, but still, the scams in the country are mainly romance scams. Many Nigerians might be engaging in this which pushes our scam rating high, but the true scammers are foreigners in advanced countries, not Nigerians.

We should try not to wash our dirty linen outside, and I know with an improved economy and welfare, all these would subside.
sr. member
Activity: 714
Merit: 353
Op it seems funny but you bring serious Mata to discuss about no be I fit talk say no be Nigerian be the best scammers country even the scammers wey they country no they use naija location so people just they predict and some get hatred for country if not how person wey they another country go know wetin they sup for here but me I they sure say naija boys they run the Mata 😊fast fast they no they carry last for the thing but that one no means say na for naija best scammers they.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?
Nigeria is the most populous country in Africa, sixth in the world. Having the highest GDP in Africa. Which means, even as Nigeria has bad leadership and mismanagement, it is a country that is recognized in the world. But there is high rate of unemployment that makes educated individuals not to have job or either underemployed and not living up to expection, but suffering in poverty.

People wey dey see and tag people of Nigeria as the most scammer in the world get something for their mind, is either dem dey jealous us, or they just get natural hatred for Nigeria,  as far as I know, Nigerians no scam pass Philippines, Indians and some other Asian countries
It is like you are comparing white to white or yellow to yellow. Victims are unable to trace scam to the country that the scammers are because the scammers use VPN and lied to victim that they are from another country, it is only traced through research that the scammers are from a particular country.
legendary
Activity: 2422
Merit: 1083
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
Nigeria don dey among countries wey dem see say na dem Sabi scam pass for the world,and the way me I see the thing,e be like say we take glory inside the talk.So tey we don kukuma dey Callam "street."
Why e be say na dis one wey be like e bad nai people of the world go carry Sabi our name?
People wey dey see and tag people of Nigeria as the most scammer in the world get something for their mind, is either dem dey jealous us, or they just get natural hatred for Nigeria,  as far as I know, Nigerians no scam pass Philippines, Indians and some other Asian countries, and i tell you something, the thing don bad reach the level now wey be say, somebody from Philippine fit scam somebody from USA, and when they ask the USA person where the person wey scam him or her come from, he or she go talk say the person na from Nigeria, na like this the whole thing take spread and now, most people around the world dey see Nigerians as the most scammers, which sincerely, no be true.
Pages:
Jump to: