Author

Topic: Nigeria (Naija) - page 149. (Read 554634 times)

hero member
Activity: 1120
Merit: 555
March 30, 2022, 03:17:29 PM
My people I greet una make una no vex for me say I no come dey too active for this side, actually my wife born baby last week Thursday so the family responsibility come take too much of my attention but am back, I go read through thread make I see were I fit contribute. My wife done born baby Satoshi is here.
I greet everybody
Good news na we wan dey hear, wiwo my brother na man you be...we rejoice with you. Congratulations bro. Fatherhood is a blessing only God can give. Where the party go dey na. Bitcointalk family suppose show face for there, na privacy matter go make some people no like those events. Congratulations wioe the latest father in town
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
March 30, 2022, 01:55:57 PM
Truth be told our couch dey try atleast him dey perform pas rohr.

How Eguavoen take deh better? How? Since weh him take over from Rohr what different thing weh Eguavoen don achieve? We complained say Rohr deh play boring football but he won us many qualifications. If to say na Rohr him for still qualify us somehow. Go and check his track record. Eguavoen no be am, him worse. He is just playing anywhere belle face football. Coaches of some countries weh no qualify like Egypt don use their hand resign o but Eguavoen deh wait make them force am to resign. Make him go.

make una no reason am o cos guyz dey vex well well even for stadium yesterday if u see hw den scarter ground ehnn

I see all the destruction weh happen for stadium last night. I no deh happen about that destruction. Fans over reacted by destroying things weh them use tax payers money buy. If to say them beat the players or the coach self e for better pass. No be say I deh encourage violence but those people deserve small beating.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
March 30, 2022, 12:26:23 PM
My people I greet una make una no vex for me say I no come dey too active for this side, actually my wife born baby last week Thursday so the family responsibility come take too much of my attention but am back, I go read through thread make I see were I fit contribute. My wife done born baby Satoshi is here.
I greet everybody
hero member
Activity: 812
Merit: 560
March 30, 2022, 08:15:04 AM
If to sae em d possible, I for like make Ghana win this match

And God answered your prayer there. Shey na because we list to almighty Ghana make this place be like grave yard since after the match? 9ja no go kill person weh want to live o. Egueavon no be coach at all. The man supposed go deh do other kind of businesses. Even if na to deh sell clothes or shoes or open restaurant business self. I know say people go deh talk say na Rohr head deh do us. Na now i agree say 9ja na big for nothing.

Truth be told our couch dey try atleast him dey perform pas rohr.

make una no reason am o cos guyz dey vex well well even for stadium yesterday if u see hw den scarter ground ehnn

just dat our super eager be like arsenal, if you put them in your game wey u stake jst knw say d ticket don spoil b dat, or no be so apen 4 yestaday?
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
March 30, 2022, 04:14:12 AM
If to sae em d possible, I for like make Ghana win this match

And God answered your prayer there. Shey na because we list to almighty Ghana make this place be like grave yard since after the match? 9ja no go kill person weh want to live o. Egueavon no be coach at all. The man supposed go deh do other kind of businesses. Even if na to deh sell clothes or shoes or open restaurant business self. I know say people go deh talk say na Rohr head deh do us. Na now i agree say 9ja na big for nothing.
hero member
Activity: 1050
Merit: 501
March 29, 2022, 02:12:07 PM
If to sae em d possible, I for like make Ghana win this match even though I no sae we go later win. We d pass so many problem for this our country. People d die unnecessarily without no just cause. The recent attack by bandits on Abuja Kaduna railway road yesterday, d make me shiver. You want make we win the match and jubilate while families are crying? No.
I highly condemned the attack on Abuja Kaduna railroad. Make everyone embrace this country’s wholesome pain.
sr. member
Activity: 1890
Merit: 328
March 29, 2022, 11:27:45 AM
If you as me ehh this declaration by Wike na just strategy as me I believe Wike weight never reach to contest for Presidency.

I no go reason am like that say Wike only want to make noise and then go sit down. The man want to follow run the whole thing. Wike eyes deh that seat for Aso Rock. Abi you want to tell me say once he gets the ticket for primaries he will withdraw?  Nobody weh them put sugar for him mouth make him vomit am. I like Wike somehow because him no deh afraid of other politicians, including the president. Him deh tell dem as e bi. Na him fit APC like this.
staff
Activity: 1316
Merit: 1610
The Naija & BSFL Sherrif 📛
March 29, 2022, 11:23:32 AM
So basically Port Harcourt point 1 his excellency Gov. Wike just declare e intentions to contest for Presidency and one of this point na the zoning of PDP presidential ticket to South South. As usual Wike take opportunity jab other aspirant from Northerner region. If you as me ehh this declaration by Wike na just strategy as me I believe Wike weight never reach to contest for Presidency. I just believe e wan put pressure so dem go take southerners aspirant seriously because this Wike declaration dun shake everywhere. Go twitter, TV stations etc na wike dey trend. Wetin you think about this Wike declaration?.

He was a laughingstock and showed the entire country what kind of man he is; he does not have the capacity to manage Nigeria; there is nothing he can boast of in his nearly 8 years as a Governor; he went to declare for a presidential run in another state; who does that? he can't even speak English. We all know he won't make the primaries because the PDP won't want him to be a flag bearer, and he's already disgraced Rivers state. The northerners have re-endorsed Atiku as the PDP's presidential candidate.

The other day him smoke go Channel Tv go sleep while Interview dey on dey talk rubbish. Lol
hero member
Activity: 812
Merit: 573
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
March 29, 2022, 09:53:23 AM
Honestly speaking have got no issues with Wuke coming out as president but make him try win Kano state.
If he does this then fine,  him go successfully win, but since them they bring Ameachi on a low, I don't know.
The northern sides can be smart,them they give power to who them go fit take am from, na why I feel like say Baba Tinubu no go win seff.
Make we dey see but in all, them political representatives done fall out hand's majorly, I do hope for the best but expecting the worst at the same time.
After this time now na so so money go dey flow, after election everyone go enter house.
My advice to youngins and entrepreneurs na to look at the problems in the society and start solving them, with that 9ja can become a better place else, were damned and Fvcked.
hero member
Activity: 1022
Merit: 667
Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform
March 29, 2022, 07:54:28 AM

NEW Topic:
Quote from: Wike attacks Atiku, Tambuwal, Ortom, others as he declares for president
Governor Nyesom Wike of Rivers State, while declaring on Sunday his ambition to run for president in 2023, launched an attack against top leaders of his party, the Peoples Democratic Party (PDP), who at some point defected from the PDP before eventually returning to the party.

Although Mr Wike did not mention any name in his remarks, he was apparently referring to the likes of former Vice President Atiku Abubakar, the former Senate President, Bukola Saraki, and the Sokoto State Governor, Aminu Tambuwal, who have all indicated their intention to contest next year’s presidential election.

“Let these people who are interested in presidency in the PDP tell us their contributions. You claimed to be one of the founding fathers of the party, but you left and came back; you have become an ordinary person in the new PDP.
 
Source: https://www.premiumtimesng.com/news/headlines/520245-wike-attacks-atiku-tambuwal-ortom-others-as-he-declares-for-president.html

So normally we know say this election they around the corner and as a conscious comrade myself make una dey expect more of this kind of post from me. I for like they hear views of members for here. I no get any other place to dey discuss am except here. The last election, I been dey reason politics board but contributor no dey give me joy (talk wetin I wan dey hear) but as we we be citizens we go discuss well.

So basically Port Harcourt point 1 his excellency Gov. Wike just declare e intentions to contest for Presidency and one of this point na the zoning of PDP presidential ticket to South South. As usual Wike take opportunity jab other aspirant from Northerner region. If you as me ehh this declaration by Wike na just strategy as me I believe Wike weight never reach to contest for Presidency. I just believe e wan put pressure so dem go take southerners aspirant seriously because this Wike declaration dun shake everywhere. Go twitter, TV stations etc na wike dey trend. Wetin you think about this Wike declaration?.
See this na just party politics and if PDP failed to project a marketable candidate in the 2023 general election there is every likelihood that the ruling party will cliff longer than we thought. If the party failed to solve its internal issues facing the people democratic party.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
March 29, 2022, 07:27:41 AM
NEW Topic:
Quote from: Wike attacks Atiku, Tambuwal, Ortom, others as he declares for president
Governor Nyesom Wike of Rivers State, while declaring on Sunday his ambition to run for president in 2023, launched an attack against top leaders of his party, the Peoples Democratic Party (PDP), who at some point defected from the PDP before eventually returning to the party.

Although Mr Wike did not mention any name in his remarks, he was apparently referring to the likes of former Vice President Atiku Abubakar, the former Senate President, Bukola Saraki, and the Sokoto State Governor, Aminu Tambuwal, who have all indicated their intention to contest next year’s presidential election.

“Let these people who are interested in presidency in the PDP tell us their contributions. You claimed to be one of the founding fathers of the party, but you left and came back; you have become an ordinary person in the new PDP.
 
Source: https://www.premiumtimesng.com/news/headlines/520245-wike-attacks-atiku-tambuwal-ortom-others-as-he-declares-for-president.html

So normally we know say this election they around the corner and as a conscious comrade myself make una dey expect more of this kind of post from me. I for like they hear views of members for here. I no get any other place to dey discuss am except here. The last election, I been dey reason politics board but contributor no dey give me joy (talk wetin I wan dey hear) but as we we be citizens we go discuss well.

So basically Port Harcourt point 1 his excellency Gov. Wike just declare e intentions to contest for Presidency and one of this point na the zoning of PDP presidential ticket to South South. As usual Wike take opportunity jab other aspirant from Northerner region. If you as me ehh this declaration by Wike na just strategy as me I believe Wike weight never reach to contest for Presidency. I just believe e wan put pressure so dem go take southerners aspirant seriously because this Wike declaration dun shake everywhere. Go twitter, TV stations etc na wike dey trend. Wetin you think about this Wike declaration?.
I dom talk before say you get better oil for head na em make you dey always drop better matter wey concern our country naija for here, you do well and I dey pray make more wisdom dey enter your head well.

You see this man wey em name na Wike eeh that man get sense well well oo, you dom forget last year wey em name been dey trend because em donate more than 200million naira to the people of sokoto and kaduna where we been hear say fire been destroy houses for there? E no reach 2months we come hear say em name dey for poster for northern state(Sokoto, kano and kaduna )for person wey wam contest for President in 2023. My people with the way Wike dom waka waka with some northern governors last year and this one wey em dom come out for day light come talk say em go contest, I no think say em na play play talk ooo that guy go shake everybody for the party to make sure say em get that ticket.
legendary
Activity: 2240
Merit: 4133
eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.
March 29, 2022, 02:53:48 AM
NEW Topic:
Quote from: Wike attacks Atiku, Tambuwal, Ortom, others as he declares for president
Governor Nyesom Wike of Rivers State, while declaring on Sunday his ambition to run for president in 2023, launched an attack against top leaders of his party, the Peoples Democratic Party (PDP), who at some point defected from the PDP before eventually returning to the party.

Although Mr Wike did not mention any name in his remarks, he was apparently referring to the likes of former Vice President Atiku Abubakar, the former Senate President, Bukola Saraki, and the Sokoto State Governor, Aminu Tambuwal, who have all indicated their intention to contest next year’s presidential election.

“Let these people who are interested in presidency in the PDP tell us their contributions. You claimed to be one of the founding fathers of the party, but you left and came back; you have become an ordinary person in the new PDP.
 
Source: https://www.premiumtimesng.com/news/headlines/520245-wike-attacks-atiku-tambuwal-ortom-others-as-he-declares-for-president.html

So normally we know say this election they around the corner and as a conscious comrade myself make una dey expect more of this kind of post from me. I for like they hear views of members for here. I no get any other place to dey discuss am except here. The last election, I been dey reason politics board but contributor no dey give me joy (talk wetin I wan dey hear) but as we we be citizens we go discuss well.

So basically Port Harcourt point 1 his excellency Gov. Wike just declare e intentions to contest for Presidency and one of this point na the zoning of PDP presidential ticket to South South. As usual Wike take opportunity jab other aspirant from Northerner region. If you as me ehh this declaration by Wike na just strategy as me I believe Wike weight never reach to contest for Presidency. I just believe e wan put pressure so dem go take southerners aspirant seriously because this Wike declaration dun shake everywhere. Go twitter, TV stations etc na wike dey trend. Wetin you think about this Wike declaration?.
hero member
Activity: 686
Merit: 527
Leo is resting.
March 28, 2022, 06:54:32 PM
My whole advice to every Nigeria for this coming election wey wan happen for 2023 be say.
2023: Don’t die for dia wars oooh. All politicians be friends. Buhari, Atiku, Tinubu & co are all friends. If you no see that at his son’s wedding, you dey on a long thing.
Be wise and vote rightly in 2023. No go kill and dull yourself for dia matter
Very good advice. But me sure say nothing dey sup, youths no go kill themselves for election. The ones wey go do am na mumu youths. End sars protest don really open youths them eyes for this country.
Secondly, plenty youths both the ones wey wise and the ones wey no wise don join street, and dem dey collect, many of them no go because of peanut money carry gun for those wicked politicians again.
As you talk this thing now, make we try promote the campaign. Dem no create youths create thuggery and then create old men create leadership.
I wish say all the youth go get this kind sense wey you take to drop this message walahi e for sweet me well well because if all the youth pipe low dey maintain for the hustle wey dey give them joy where our politicians wam see them talkless of to give them peanut money and guns to take cause wahala? Na some youth wey dom use ice and other hard drugs kill them self finish go mumu go work for people wey go later come kill them finish. I just pray say make them use things dem wey happen before get sense.
legendary
Activity: 1512
Merit: 4795
March 28, 2022, 04:02:03 PM
Yes electricity cheap but what about cost of maintenance, and cost of getting this mining equipment first. When person consider all the funds you gaz get to start up mining compared to wetin fit burst out for you, if normally you just buy Bitcoin with that money, them go obviously choose trading over mining.
Labour in Nigeria is cheaper than that of United States. The purchasing power parity (PPP) in United States is higher than that of Nigeria. Because of these, bitcoin mining in Nigeria should be more profitable. But what I think the issue is, is the poor electricity which can discourage Nigerians to start mining. But if some people have started mining in the CPU days, there would be a way to it because there are areas in Nigeria with constant electricity as bad as electricity supply still is in Nigerians, these kind of early adopters would make more research and continue mining bitcoin. Although, how Nigeria government would react to this if Nigerians are mining bitcoin is excluded, because they may or may not come with a law that will make mining favours bitcoin miners in our country if public electricity is used.

But in the case of Nigeria, electricity can be said to be cheap because of poor power supply, and if by chance you want to get a steady supply for mining purposes for example, i am pretty sure you will pay extremely high fees.
The electricity usage is in U.S. dollars per kilowatt hour. Also likely prepaid plan would be used for the calculation.

The last point is what every investor compulsorily checks before establishing a firm. Nigerian government can make some non business friendly laws. But when it is crypto, any country can do it. We expected that China will be safe and there was some level of concentration in China, what finally happened is a story. Any government can do anything against crypto at anytime.
I do not think it is the issue by our government, even before the CBN crypto ban, it has been happening like that. Only few countries are miners congested. Like I have mentioned before that mining is not Nigerian thing. We were not early adopters and when miners are using sophisticated miners, issue of poor electricity may be the cause of the reason. In a country there is poor electricity, miners are discouraged to establish in such country, just like ours.
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
March 28, 2022, 03:53:18 PM
I wasn't even aware there are Nigerians who run/own mining rigs in other parts of the world, well as a business man/woman all you have to do is what is good for business, Bitcoin mining is suitable in many countries of which Nigeria is none for now, so prolly somewhere down the line when conditions might be better here in our shores, then we could see the rise of Nigerian miners.
I doubt Nigerians will own mining rigs in other parts of the world (I am not saying that it is impossible). But an average Nigerian will invest in what he understands.
I posted that on the back of the post by BIT-BENDER, and i also made it known that i was unaware of such developments, and absolutely your arguments as regards the info are pretty much valid, maybe BIT-BENDER can be so kind to share with us the link to the news he read, so we can as well make out our own assessment of it Grin.
Coyster, I purposely removed BIT-BENDER's comment so that I will put everything on your head to defend  Grin.  I don't know how you understood the game .
As for that Pi mining that one no follow at all. I no go encourage person to run am because na big time rubbish
That pi matta na sensitive mata o, we gas treat am with care. See wetin sup:
1. Pi don already get large community wey dem dey use run adverts and other things dey get money.
2. Crypto thing na game of numbers, and pi network don already get numbers, so no underrate dem o. Anything can happen shaa.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
March 28, 2022, 03:34:21 PM
I wasn't even aware there are Nigerians who run/own mining rigs in other parts of the world, well as a business man/woman all you have to do is what is good for business, Bitcoin mining is suitable in many countries of which Nigeria is none for now, so prolly somewhere down the line when conditions might be better here in our shores, then we could see the rise of Nigerian miners.
I doubt Nigerians will own mining rigs in other parts of the world (I am not saying that it is impossible). But an average Nigerian will invest in what he understands.
I posted that on the back of the post by BIT-BENDER, and i also made it known that i was unaware of such developments, and absolutely your arguments as regards the info are pretty much valid, maybe BIT-BENDER can be so kind to share with us the link to the news he read, so we can as well make out our own assessment of it Grin.
hero member
Activity: 1050
Merit: 501
March 28, 2022, 03:16:53 PM
How them dey take calculate these values as per price of electricity cef because, on a normal, electricity for naija no dey steady for most places and na so our people too no sabi pay electricity bill compare to the oyibo country them way don advance so. There ways different from our own and I doubt you fit dey owe electricity bill for there cef. Even if you try owe, e no go be for long so, how them dey take calculate this thing...

On the mining matter, we country no dey even reason mining at all. People way try like bitcoin or get small money cef, na straight up trading dey there body and non of them dey reason mining. Why, e don too hard to get the sophisticated devices way dey needed for mining way no go be only one cef. All follow say, we no been early know as Brainboss don talk and na why, yiu go see many Nigerians today dey try run small mining of altcoins them like PI with there phones, make the opportunity way been come with bitcoin no fly pass them in PI.
As for calculating of Nepa bill, you go know sae your country d very funny when em comes to giving you estimated bills of your household electricity. For them to give you wetin you go d pay be sae, dem go come your apartment come crosscheck your building, from the worth of your building, dem go give you wetin you go d pay per months. Although the monthly payment fluctuates. The same logic goes with companies and hotels

Nigerians have the Mining of bitcoin at heart but wetin d discourage us be sae we no d get steady power supply of light. As for that Pi mining that one no follow at all. I no go encourage person to run am because na big time rubbish
hero member
Activity: 896
Merit: 584
BTC, a coin of today and tomorrow.
March 28, 2022, 03:12:02 PM
I wasn't even aware there are Nigerians who run/own mining rigs in other parts of the world, well as a business man/woman all you have to do is what is good for business, Bitcoin mining is suitable in many countries of which Nigeria is none for now, so prolly somewhere down the line when conditions might be better here in our shores, then we could see the rise of Nigerian miners.
I doubt Nigerians will own mining rigs in other parts of the world (I am not saying that it is impossible). But an average Nigerian will invest in what he understands. Nigerians no doubt may join mining pools in other countries though.
If we can witness the rise of miners in Nigeria, it should be in altcoins because as we speak, bitcoin mining is less lucrative and besides there might not be bitcoin mining by the time Nigerian economy will fit mining and miners will be feeding with transaction fees.
legendary
Activity: 1946
Merit: 1224
'Life's but a walking shadow'!
March 28, 2022, 01:02:18 PM
The last point is what every investor compulsorily checks before establishing a firm. Nigerian government can make some non business friendly laws. But when it is crypto, any country can do it. We expected that China will be safe and there was some level of concentration in China, what finally happened is a story. Any government can do anything against crypto at anytime.
Thanks for your input uchegod-21, and you are correct, the last point is not peculiar to just Nigeria, even if overall it is a reason why many individuals would think twice before setting up a mining plant anywhere in the world. If you ask me i am pretty sure most governments just attack Bitcoin in diverse ways, even when they do not have a genuine reason to do so, they just make up one story or the other such as 'it is harmful to the enviroment' and other similar bullshit, but the fact remains that they do not like it cause it is decentralized and they can in no way have absolute control over the network.
I was reading an article of Nigerian miners do what they know how to do best which is mining Bitcoin. But this guys don't mine Bitcoin in there father's land but they do in other countries if the world.
I wasn't even aware there are Nigerians who run/own mining rigs in other parts of the world, well as a business man/woman all you have to do is what is good for business, Bitcoin mining is suitable in many countries of which Nigeria is none for now, so prolly somewhere down the line when conditions might be better here in our shores, then we could see the rise of Nigerian miners.
hero member
Activity: 1498
Merit: 702
March 27, 2022, 06:51:28 PM
I was reading an article of Nigerian miners do what they know how to do best which is mining Bitcoin. But this guys don't mine Bitcoin in there father's land but they do in other countries if the world.
Nigerians are ready to mine Bitcoin, the zeal is there but the issue right is the difficulty a miner would encounter mining Bitcoin in Nigeria, especially power issue, governmental issues. I believe once all these issues are tackled we would be having more miners on Nigeria.
Jump to: