Firstly wetin Nigeria SEC dey do no bad, they're protecting the citizens of the country and no matta weda we like am or not they're right with what they just came out to say. Understand say them no dey attack Binance generally but Binance Nigeria just as United States they attack Binance US so. Na follow follow make us do our own now and you no go blame them because na the perfect timing be this for their choppings to come out. Nigeria SEC just want Binance Nigeria to register under them as na so e dey be for this kind business them. Also wetin SEC dun come out talk so, na just warning to Nigerians make e no be like say dem no warn us Incase anything bad was to happen (and I dey suspect say dem believe say US fit run Binance down and e go affect us Nigerian).
All dem dey talk na say anything wey you dey do with Binance Nigeria na at ur own risk, just as them warn us for those ponzi schemes wey we been dey chase around dey through millions so inside. Nigeria SEC wan get their own cut (we know as e dey be) because immediately dem register officially nothing concern Binance Nigeria with SEC again unless dem break rules of the commission then dem go carry EFCC and DSS come pick up who dey head the exchange for Nigeria. All this one fit just be talk talk matter too and nothing go still happen.
This is official response from Binance telegram link
I don't think there is any cause for alarm because of SEC warning against cryptos and tagging Binance as illegal from my own point of view SEC is just trying to copycat US SEC as you rightly said even Binance chart had recently included BTC/NGN on there trading platform that means we can easily buy Bitcoin with naira and from all indication SEC dey try to lure Binance for a possible collaboration wey go give room for imposing tax on crypto related transactions, it's been a long time wey people dey trade cryptos so many of them knew say crypto no bi ponzi scheme and now one yeye SEC think say them fit discourage people from it