This one just like na warning sef, no invest in bitcoin when you no dey do anything to support am because e go affect your investment. If you want to invest in bitcoin at least make you dey do small thing dey get money so that you will not touch the bitcoin wey you don invest. Na this topic dey make me dey create this thread
Economy affects Bitcoin investors.. Because of the way bitcoin dey appreciate, everybodi want to invest and thinking that bitcoin go give them big profit for within few months of 3-5 months and dis people e no do anything and just want to depends on the bitcoin investment and thinking to have great harvest in this few months, and within this period, when thing are not going well with them in the side hustle then dem go remember say dey drop money for one wallet and dem no go kill or starve demselves when dey have money somewhere. And when you look at it na true, dem no go starve when there have money in the wallet. So dey will visit their wallets and sell dem to feed themselves. But to say dem dey do something outside di bitcoin investment then im or her go dey buy bitcoin small small every week or month with di money wey im or she dey get from side hustle.
A relative met me today and told me dat she want to invest in bitcoin and I asked her weti she dey do, so that when she starts di investment she no go touch di investment money until years to come and she told.me that na akara nai she dey fry. And she dey save #500 every day and she don save 100k from di capital and she want to invest in bitcoin with di profit and I was impressed. And I asked her how did she know about bitcoin and she said, she saw it in one my comment in a family WhatsApp group and she make enquiry and dem told her dat bitcoin na correct investment so she want me to teach her so she can invest. And I told her that all she needs na Android phone since we no get hardware wallet in di locality. And she told me dat when she buy di phone she go come back to me she she can invest and I told her dat dis is the best time to invest as bitcoin e still dey low.
To Newbies Dat want to Create Threads Always
It has been long I create thread in the local board but I dey make comments steady and this thread was created through the reading and making comments basically from dis thread
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5472766.new#new so weti I dey tok be say make you no dey in hurry to create threads, read more and in the process you go produce better thread. Good luck to all newbies.