Without any bias make una talk truth, you think say this message from OBJ na him genuine mind abi another political decision so him enemy Atiku no go get supports to fit win the election or to make sure the likes of Tinubu no enta that seat as him fit do things wey go make OBJ not relevant again for Nigeria. Also you feel say this decision from OBJ na another from to make himself relevant so Incase OBI win him fit carry shoulder up say na him put am there and try get benefits with godfather parole.
Wen e com to political mata/office, leadership nd govmnt somtin, OBJ nd Atiku too sabi demselves via say, dem 2 bin don work hand in hand b4 nd na frm watin Atiku do way shock OBJ na em turn dem enemies way till 2day, e mam OBJ fear to see am in full control of d nation.
OBJ 2 endorse d pple's choice Obi today no dey far frm 2 discredit Atiku by also, to clear way 4 en side if Obi finally enter dat seat. OBJ already knw say, himself nd Atiku no ft work nd so, nothing com out en side if na Atiku enter dat seat. 4 Tinubu side, Tinubu na APC man nd on top of dat wth all en display, I no sure say, pple deh really see am to enter dat seat. Mak e try en luck wth Obi bt, Obi go stil serve d pple well, I hope.