I just de hear about dis story for dis your thread now and I don do small research but I no see anywhere wey confirm di authenticity. I hope say more of our forum members wey de use OKX exchange go help us to confirm weda na true say dem de leave Nigerian market. I know say na some people work to de spread fake news to de put panic for people body, dat na why no be everything wen I hear for social media I de rush to believe, unless I hear am from di authentic source or from a reputable site. Aldo I no go de too surprised if any top exchange leave our Nigerian market, despite how lucrative wey dem business de do for di country, because of our government issues with Binance wey come de affect oda exchanges. Make we wait and see weda OKX go officially make any announcement say dem wan to leave Nigeria.
I been dey hear about the matter since yesterday but since i no dey use the exchange, I no bother to check waiting dey sup whether the news na fake. There's no any announcement on their official pages but i believe say the rumors na true, no be something wey dey just create fake news to dey spread about. I just enter Twitter and saw a tweet from one man wey dey follow about anything wey related to cryptocurrency, that Okx will shutdown services for Nigerians from August 16, that means say d people wey get any coin for their wallet make them withdraw am before the deadline date.
Which kind of country is this for God sake, I no even understand waiting be the problem of our government again, just like play wey Binance no gree pay the money wey dey ask them our government started to dey drag this exchanges one by one. But some people dey claim say VPN dey, does that mean those that have account with them will still get access it to using the VPN?