I see am say this matter na ogbonge one wey we need to talk am make we know how future go be, as the Bitcoin fee dey go up so, wetin una think say e dey cause am, I be hear some people say na the NFT wey dey for the network dey cause am , others say na another thing else , abeg make we chuck mouth share experience and wetin fit happen with tranxaction fee matter in future. This thing done happen before , tell us wetin dey cause am
Usually the main thing wey dey cause this high tx fees na when plenty people don dey use the Bitcoin network dey send Bitcoin from place to another at the same time, e dey cause wetin oyibo call congestion, meaning say everywhere don tight. Take for instance say you go stadium go watch ball, when you been dey enter inside the stadium, people don already enter finis so the road just free, you no go drag road with anybody at all, then just imagine wetin go happen when e be say the stadium come catch fire or something come happen wey go force everybody to evacuate the stadium with immediate effect, imagin how everywhere go tight, you go hardly get chance to pass self as everywhere go just tight. Shey you dey catch my point.
Now the main things wey dey cause the congestion gon gon na this new coin them dey call ORDINAL, and some other small small tokens wey dey use the Bitcoin Blockchain network for their transactions, but make we discuss about ORDINAL first because na that one gon gon na e be the ogbonge reason why Bitcoin network don dey worry like this. People everywhere now dey trade the token like say tomorrow no dey and because of that, the Bitcoin network don busy like mad, so na e be the main reason why TX fees don shoot go up like mad wetin no nice