It's ironic that people doing airdrops in those WhatsApp group don't really get what this actually means they think, it's a way FOR memefi to catch those users having multiple accounts which is far from that.
Nor let them whine you they want your personal information to run ads and make more money out of you.
If other people dey get things wring we suppose dey different bcos knowledge wey we dey get from BTT nor be small, try dey read something for yourself before you go jump into conclusions or accept TOS wey fit do you harm.
Remember I talk before about doing airdrops dey buy more bitcoin and also remind whona say risks dey the airdrops and this na among thr risk, if e nor good for you nor accept am.
Also no matter how much you don make or person wey you know don male for airdrop nor dey blinded say Airdrop go give you money pasd learning skill o, airdrops na just to get money wey you fit spend with little Considerations and e nor go affect your actual earnings.
Though on my own part, I no dy too do airdrop because the stress too much, and most times, them no go still pay you after everything, so because of that, if I dy do any airdrop now, I dy always dy sure first say Dem go pay, before I even engage, and if I dy connect any wallet, na wallet wey nothing dy inside I dy connect am with, because I no wan hear stories that touch for my money.