Bitcoin na decentralized digital cash wey don build solid reputation as a valuable asset wey get di potentials to de reach ATH for every circle. Na based on di past performances wey after halving bull run go follow and ATH go happen, people take trust am. Bitcoin don become one of di most trusted long term investments because people don see am as a genuine store of value. People de take dem hard earned money to de do DCA method because dem get di believe say Bitcoin price go always de hit ATH.
True, Bitcoin reputation over the years dey enough for person to believe say na solid project way em go fit invest em fund into. Em decentralized feature too make people like am since na you dey in charge of your funds as against fiat wey the government dey control and the regulate anyhow them want. People need freedom and na why Bitcoin dey gain top spot for people investment plan because em give them the that freedom and em make them dey in charge of them money.
I reason say e take a lot of faith in something for people to continuously put dem money inside for many years and believe say dem go de get plenty profits on the long term. If no be strong faith, how come people de put dem money inside something wey no get any physical structure? Infact as far as I know na only Bitcoin be di investment wey de completely decentralized and im no get any centralized office wey people de put dem money inside.
The centralized offices way people dey put their money e.g banks don do people shege, sometimes you go need your money, you no go fit get am, example recently GTB customers dey cry say them no fit access them money for sometime now and most people wey dey do business don loose wetin no good this period, so people don loose faith in banks.
Bitcoin na your personal bank where only you be the manager and only you dey determine wetin you go do with your money, even as em no get office, em no dey disappoint and people like such consistency.
Fear no de weda bankruptcy or scams go happen and people get complete trust for am, dat na why I de bow for Bitcoin. Me sef I follow get dat faith say our decentralized Bitcoin no go fall our Hands.
Nobody suppose get complete trust for Bitcoin because there's no 100% assurance on it. There's slim chances say e fit cast, although the chances are slim, but it's still a possibility, so no too trust Bitcoin and make sure you invest with amounts you're prepared to loose. No carry your emergency funds invest, instead invest with your discretionary income.