As I see di topic I come know shey na translation thread bi day because B.C. Game e no get anything to do for we Nigerian Local Board except translation..
According to people, an arm robber na always na arm robber even though him don repent him mind still dey like dat. And dis my first statement e don talk everything. Dem been dey scammed people well well though according to dem dem don repent and dem give back di money we dem collect from people before and according to dem dem dey do well now. But me I never try am and I no go try am sef because dem way e no dey pure.
I no side this talk because many armed runners wey you know know, today them self fit done repent and some of them nah one of the strongest men of God today.
Again, B.C game get a lot to do for we country because nah gambling site wey pipo around the globe dey go gamble many times, person for this we country fit also come here share em experience about B.C games just luke the wey wen OP do
Although this OP nah transaction but as a matter of fact e done also share more knowledge to those people wey no sabi about b.c game.
No talk say you no go try am because say their ways no pure, if person done do wrong before and em know say nah wrong wey em do, e fit decide to change for good and the best way nah to give am a second chance.
Even God wey dey heaven sef talk am say forgive your neighbors as you dey forgive your self.
Although, I no dey advertise them for here but just try to let you know say sometimes pipo dey do wrong and them still dey change for good, our own be say make we just dey give them second chance.
Today, we dey always dey see many adverts for social medias about this b.c games, this one suppose to show us say them naw done change and them dey come with full gear without any brake.