Shey una dey see the country we dey inside, no be everything wey dey blame government.
From top to bottom
my own view to repair this country na from top and that top na from number 1 citizen of Nigeria, that person wey be the commander in chief of the armed forces because Nigerian system works without institution but the bidden of the president.
Shall how una see the development, e good as EFCC dey go after this POS businesses or you dey feel say na another misplaced priority?
Yes oo I dey feel say na very big misplaced priority. Na the inefficiency of government dey make Nigerians dey take advantage of demselves. Okay make we even ask ourselves say where dem carry naira go keep wey start the scarcity? Dem dey do naira redesign so hasty because of political reasons without proper planning against the effects, hence somebody just wake think say the dream wey him see for night go perfect for real life. I no blame pos people, make government go arrest source where dem dey get the cash from, wetin concern pos people? Na Nigerians dem be so make government first arrest bank CEOs and executives if them actually make the money available.
I dey look through those name and I no sew Opay yet I dey see their Pos everywhere abi make person look through so we know where we stand.
That news say dem ban Opay, Kuda, and Palmpay operations in Nigeria be like say na rumour. I don read somewhere wey CBN debunk am as fake news but make we still put ears for ground.
Meanwhile make dem leave pos people to dey operate oo, dey can only bring money out and even thing go level up back. Government dey preach about entrepreneurship and micro businesses but na dem still dey frustrate am.