Preparedness na the most important thing to do if you wan make or get good things for dis life, some people na mouth dem take dey read ,like Bitcoin we no suppose to dey talk too much before we invest because we know say at all at all we go make am no matter from an amount wey we start to dey invest ,imagine people wey still sit down dey look sey the price of Bitcoin go come down before dem go buy, I no see dat person say him get money to really buy and invest because person wey get money and know wetin investment for Bitcoin dey about, no dey waste time at all. Unlike person wey only dey talk, him wan dey predict weytin go happen next make I be like sey him follow for the matter.
Weti dey worry people from. Buying bitcoin is procrastination, that is wetin for the price of bitcoin to come down for them to buy which sometimes it doesn't even come down just as people expect. Most people waiting for the price to come down are not even ready to invest in bitcoin they use this as an excuse and later they start regretting for not buying bitcoin as the price is low. Nobody enters the market and do well unprepared .
Procrastination na very big problem wey de make many people to de speculate wen Bitcoin, price go dip well well before dem go buy, but dem forget say nobody know tomorrow, something else fit to carry di money go before price go dip. So di matter no be just to prepare but to get accurate knowledge of wetin you de prepare for and do am at di right time, so I believe say di best preparation for Bitcoin, na to do DCA method. With DCA you no need too much speculations or predictions, na to accumulate and hodle till di peak of bull run, then you go decide weda to sale or continue to hodl.
Na the Koko be that, you don talk about almost all the things I wan talk, but I just say make I add more to wetin you don talk already.
Most of us for this crypto space just like to do work with our mouth without showing working, you go see person wey get all the required tool and material to get the job done, instead of him or her to act on it, him go dy procrastinate just as @kelward don talk already.
And at this particular moment so, if I ask say, how many of us get a very good stash of Bitcoin in our possession, wey if the bull run come today today, how many people fit boastfully say him or her go really gain from am, the people wey go benefit from am no plenty at all, because in our society today, we no dy take preparation serious, na dieing minutes we go start to dy run elter skelter, to do wetin we surpose don do since tey tey, which is a very bad attitude, we forget the saying wey we dy hear almost everyday in our society, wey be, he who fail to plan, plan to fail, we really need to change that behavior if we must succeed in this crypto space, because lack of planning, is planning to fail.